By : Jolayemi Olajide
Lagos APC governorship aspirant, Samuel Ajose, don confirm say e don pull out from di 2027 governorship race to back Deputy Governor, Obafemi Hamzat.
E talk dis one for TV siddon talk on Wednesday, say e step down sake of say, APC leaders don already show di direction wey dem wan follow for di Lagos governorship marras ahead of primaries.
E sti add say na respect for party constitution, leadership and how dem dey run things inside APC, make am japa comot from di race.