By : Jolayemi Olajide
Manchester United don announce on Tuesday say dem go finish dia tight pre-season preparation against AC Milan for Wroclaw inside Poland.
Di big match go hold on August 15 as coach Michael Carrick dey plan to build on top di beta third position wey di club carry last season before di new Premier League start.
United go start di matches against Wrexham for Helsinki on July 18, before dem move go Norway go face Rosenborg di next Friday.
Di English giants arrange dis friendlies including matches against Atletico Madrid and PSG to make sure di players body setting align well for di heavy tasks ahead.