Sport Yarns

Iran players to Miss World Cup Match cause of Expired Visa to America

todayJune 16, 2026 8

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Iran national football team don dey complain say one of dia star players, Mehdi Torabi, visa don expire after dia match for Los Angeles.

According to di aproko, Torabi only get single-entry visa, unlike im oda teammates wey get multiple-entry, so now e nor fit enter di US again to continue di tournament.

Iran Football Federation don already start work to see how dem go quickly get new visa for di next games.

Everybody dey wait to see weda di US go grant the request, as di whole situation dey hang for balance because of di bad blood between both countries.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds