OBODO NAIJA

Abeg Make I handle Kwara and Imo state : Wike Tell Oga Presido

todayNovember 26, 2026 8

Background
share close

Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don beg Presido Bola Tinubu make e add Imo and Kwara join di states wey e go coordinate for di 2027 election.

Di before before Govo of Rivers State make dis call to Presido Bola Tinubu and di Director General of di All Progressives Congress presidential campaign council, Abdul’aziz Yari, on Wednesday.

E tok dis one for one town hall meeting wit pipo and members of di Rainbow Coalition for Gokana Local Government Area of Rivers State on November 25th 2026.

Wike tok say e don already lock down every corner for Rivers State and di Federal Capital Territory, and e wan go settle di wahala and division wey dey inside di party for Imo and Kwara State.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds