Politics

APC Chieftain Back Tinubu On Ondo Crash Investigation

todayOctober 6, 2026 8

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

APC National Working Committee member, Tolu Bankole, don commend Presido Bola Tinubu for immediate investigation into di cause of di Nigerian Air Force aircraft crash for Ondo State.

Bankole say di investigation dey timely and necessary to prevent another tragedy, after di NAF ATR-42 aircraft crash near Igbokoda for Ilaje Local Gornment Area.

He describe di death of 32 pipu, including 25 passengers and seven crew members, as heartbreaking loss to di Naija Air Force and Armed Forces.

Di APC chieftain also commend first responders and Ondo State Gornment for dia quick response, while sending condolences to di families of di fallen personnel and im dey beg naija pipu to support di Armed Forces during di mourning period.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds