News-auth

1164 Results / Page 2 of 130

Background

Sports

Arsenal Late Penalty Drama Scatter Match as Atletico Force 1-1 Draw for UCL Semi-Final

By: Esther Ayoola Arsenal and Atletico Madrid don go play draw 1-1 for dia Champions League semi-final first leg. Referee first award late penalty for Arsenal afta Eberechi Eze fall, but VAR check cancel am say no serious contact. Before dat, Viktor Gyokeres  score penalty for Arsenal, while Atletico reply through Julian Alvarez penalty afta handball decision. Super Eagles player Ademola Lookman sef play full 90 minutes for Atletico and […]

todayApril 30, 2026 12

Lagos

Lagos Police Gbab 118 Suspects, Bust Kidnappers, Cultists and Vandals for April Crackdown

By: Esther Ayoola Commissioner of police for lagos state don share im report card say police record major breakthrough for April 2026 through intelligence-led operations and coordinated raids across di state. Oga Fatai, yan dis one for state Police Command Headquarters, Ikeja, briefing tori pipo on Wednesday. Di commissioner say, di operatives arrest 118 suspects linked to armed robbery, kidnapping, cultism and vandalism, while dem also recover guns, drugs, telecom […]

todayApril 29, 2026 24

National

Former Foreign Minister, Tuggar Buy N50m APC Governorship Form for Bauchi

By: Esther Ayoola Former Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Maitama Tuggar, don go buy APC N50 million governorship nomination form say im wan contest 2027 election for Bauchi State. According to update by Imran Mohammed, aide to APC National Chairman Nentawe Yilwatda, Tuggar don sign documents as party officials present am di form for party secretariat. Tuggar tuk say im ambition no be to cause division but to strengthen […]

todayApril 29, 2026 15

National

Obi Raise Alarm how 60% of Naija Student take Join Yahoo

By: Esther Ayoola Di 2023 presidential candidate of labour, Peter Obi, don raise alarm say Naija dey face serious moral and systemic crisis following claim by EFCC Chairman, Olanipekun Olukoyede, say six out of every ten university students dey involved in internet fraud. Obi post for X, say if di claim na true, e show say problem dey for Damascus, dat, dis one nor be only crime but failure of […]

todayApril 29, 2026 14

National

Court Stop INEC From Following ADC Caretaker Congress

By: Esther Ayoola Federal High Court for Abuja don order Independent National Electoral Commission not to recognise or join any congress wey caretaker leaders of African Democratic Congress dey plan. Judge Joyce Abdulmalik still talk say David Mark and some other big men for the party never still get right run package as party leaders. Dis judgment sef don form part of di wahala inside oposition ADC. Di case na […]

todayApril 29, 2026 18

National

Lawyers Demand Open Trial For Delta Police Officer Wey Go Allegedly Kpai

By: Esther Ayoola Human rights group Avocats, Sans Frontières France (AKA Lawyers Without Borders) Don wire call to wi Federal Gornment and Naija Police Force to ensure transparency and public prosecution over alleged kpai, a 28-year-old criminal suspect, one Mene Ogidi. Di group Country Director, Angela Uwandu-Uzoma-Iwuchukwu, explain, say di incident happen on April 26, 2026 for Effurun, Delta State, where ASP Nuhu Usman allegedly shoot di suspect wey dey […]

todayApril 29, 2026 18

Sports

FIFA Show Off New Volunteer Uniform For 2026 World Cup

By: Esther Ayoola FIFA don show di official volunteer uniform wey dia workers go wear for 2026 World Cup wey go happen for USA, Canada and Mexico. Di kit get bold and modern design wey dem create to make am easy to see, comfortable, and practical for volunteers. FIFA put am for dia X handle on Tuesday, say Volunteers go wear different layers wey go match hot or cold weather […]

todayApril 29, 2026 22

Sports

PSG And Bayern Play Goal Fest For Paris With 9 Goals For dia First Leg UCL Semis

By: Esther Ayoola Na serious Champions League semi-final first leg wey PSG and Bayern Munich play for Parc des Princes, PSG sha win 5-4 for di mad, high-scoring encounter. Kvaratskhelia and Ousmane Dembele score two goals each, while Harry Kane penalty naim give Bayern early lead. Di match just full everywia as Joao Neves, Michael Olise, Dayot Upamecano and Luis Diaz too enter di scoresheet. Now PSG get small advantage […]

todayApril 29, 2026 12

obodo oyinbo

Israel And Lebanon Clash Worsen As Air Strike Kpai, Kpai Rescue Workers

By: Esther Ayoola Israel military don carry out some wicked air strikes for southern Lebanon, even reach areas wey dem call “Yellow Line”. According to report, One of di strikes kpai five pipo, including three civil defence workers wey dey try rescue pipo from earlier attack, and two Lebanese soldiers sti get wunjury. Lebanon Prime Minister Nawaf Salam don condemn di attack, call am war crime, and say dem go […]

todayApril 29, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds