News-auth

1027 Results / Page 111 of 115

Background

south west

Adeleke Dey Block PDP Governorship Pick — Sani

By: Alice Iduh DI Peoples’ Democratic Party chieftain Umar Sani don accuse Osun State Govo, Ademola Adeleke, say na him dey block PDP from choosing who go run for govo as election dey near. Sani talk on Friday say Adeleke dey chase im own political interest and no send PDP matter, even talk say di govo dey use PDP inside wahala take hold ground because of signature wey Independent National […]

todayDecember 5, 2025 14

south east

Ebonyi Police Catch Man Wey Try Burn PoS Lady to Steal Money

By: Alice Iduh Ebonyi state police command don gbab one jaguda boi after e attack one female PoS operator for Abakaliki, the state capital, say im pour fuel con try burn am to carry her money bag. Ebonyi Police tuk tuk, SP Joshua Ukandu naim de  confimate say dem catch di suspect on Friday before e fit dash away with di bag. Police quickly rescue di woman and collect back […]

todayDecember 5, 2025 14

Niger Delta

Delta Police Yan No Fire Fireworks This Yuletide, Zero Tolerance

By: Alice Iduh Delta State Police don yan say di long-time ban wey dey stop fireworks still dey gidigba as Christmas and New Year dey near, and dem no go tolerate anybody wey try break am. CP Olufemi Abaniwonda, through PPRO SP Bright Edafe, talk say di clampdown go cover di use, sell, storage, and public show of all pyrotechnics, including knock-outs and bangers. Di police talk say dem dey […]

todayDecember 5, 2025 10

Niger Delta

Amaewhule Join 15 Lawmakers Waka Comot From PDP

By: Alice Iduh Speaker of the rivers state house of assembly, Amaewhule Martins don waka comot from PDP join 15 oda members of di House of Assembly on Friday, as di session dey go on. Dem talk say di wahala inside PDP na why dem gatz japa comot from di party. Among di big names wey join di waka na Deputy Speaker Dumle Maol, Major Jack, Linda Stewart, Franklin Nwabochi, […]

todayDecember 5, 2025 6

south west

Supreme Court Don Shut Osun Ag Mouth Over Local Govt Money Wahala

By: Alice Iduh Supreme Court don cancel Osun State Attorney General, Oluwole Jimi-Bada, case, wey him file against  AGF, Lateef Fagbemi, over di local government funds wey dem dey hold. court talk say na only di people wey win election and don take office fit sue or get sued. Justice Mohammed Idris talk say di Federal Government dey wrong to hold di local government money, say e dey breach 1999 […]

todayDecember 5, 2025 25

south west

Oyo Man Fall Inside Well, Fire Service Drag Body Out

By: Alice Iduh Oyo State Fire Service don recover body of one 65-year-old man wey fall inside deep well for Oke-Oga Atipe, Idi-Aga, Ibadan. Di wahala happen Thursday, December 4, 2025, wen one Mr Damola call di fire service at exactly 9:42 a.m. report say man don waka enter di well. Fire officers, wey Assistant Chief Fire Superintendent Bamidele Samsudeen lead, rush go di scene, but sadly, dem only fit […]

todayDecember 5, 2025 7

Business

FG Go Pay Road Contractors Owed Money Before December 20

By: Esther Ayoola Tori don land, Federal Government don rush cool road contractors wey don dey protest over unpaid money, promise say all outstanding payments go land before December 20, 2025. Minister of Works, David Umahi, yarn dis one during reopening of Keffi Flyover for Nasarawa State, add say President Bola Tinubu don sabi di debt wahala and don approve special committee to check and clear all owed funds. Contractors […]

todayDecember 5, 2025 7

Entertainment

Imisi BBNaija Don Land: Ebute Metta Stand Still for Homecoming Showdown

By: Esther Ayoola Today, Imisi Ayanwale  di winner of tv reality show,   dey return to her Ebute Metta hometown for big  welcome party as fans gather make dem hail her home. She  win full N150 million grand prize back on October 5, 2025, and since then everybody don dey follow her matter with bumper to bumper.! As part of di plan, she don invite big names for entertainment from Bolaji […]

todayDecember 5, 2025 19

Lagos

Lagos Go Buy 100 New Trucks to Keep City Clean

By: Esther Ayoola Lagos State Gorment don yarn say dem go buy 100 new CNG compactor trucks next year as part of 10-year plan to make city clean. LAWMA Managing Director, Muyiwa Gbadegesin, talk say dem go dey add 200–250 new trucks every year until dem reach 2,000 1,000 for daily work, 1,000 for backup. E add say dis long-term plan go join state-wide household billing system, wey go help […]

todayDecember 5, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app