News-auth

1027 Results / Page 112 of 115

Background

Niger Delta

Edo Governor Don Appoint Dr Ebojele As Chief Press Secretary

By: Alice Iduh Edo State Govo don appoint Dr Patrick Ebojele as new Chief Press Secretary to Govo Monday Okpebholo. Before dis new job, Ebojele dey teach as lecturer for Federal Polytechnic, Auchi. Di appointment, wey Secretary to di State Government, Umar Ikhilor, sign confirm on Thursday, go make Ebojele take over from Fred Itua.

todayDecember 5, 2025 14

Lagos

Lagos Don Start Second Polio Vaccination Round to Protect Children

By: Esther Ayoola Lagos State  gorment  don drop ogbonge update dat, second round of polio vaccination for childrenses go start from Saturday, December 6 to Tuesday, December 9, 2025. Di campaign say na   Lagos State Primary Health Care Board with National Primary Health Care Development Agency, WHO, UNICEF and other partners dey run am to stop polio. Gorment talk say na follow-up after November 8, 2025 first phase, wey dem […]

todayDecember 5, 2025 6

Lagos

Lead Poison Wahala: Senate Raise Red Alert for Ogijo

By: Esther Ayoola The Senate raise big alarm as lead poison don dey spread fast-fast for Ogijo, one heavily packed community wey sit for border between Ikorodu (Lagos) and Ogun East. Lawmakers on thursday no hide mouth, say na  full-blown environmental and public-health disaster wey fit put thousands of residents for serious danger. Leading the yanings for the houz,  Senators Mukhail Adetokunbo (Lagos East) and Gbenga Daniel (Ogun East)  clear […]

todayDecember 5, 2025 6

Niger Delta

Police Burst Fake Kidnap Story, Arrest Five For Oron

By: Alice Iduh Akwa Ibom Police don grab five suspects wey dem say cook up and spread fake tori of kidnapping for Oron area, causing serious tension for di state. Commissioner of Police Baba Azare reveal di matter on Thursday for security meeting with youth leaders from all 31 LGAs, as him blast di suspects for di reckless stunt. According to am, na dem fabricate di fake gist say students […]

todayDecember 5, 2025 13

Niger Delta

Edo Assembly Fit Arrest Obaseki As Him Sidon Out MOWAA, Radisson Probe

by: Alice Iduh Edo State House of Assembly don fire warning as di ad hoc committee wey dey investigate MOWAA and Radisson Hotel talk say dem get power to issue arrest warrant for former Govo Godwin Obaseki wey refuse show face. Di committee wey Governor Monday Okpebholo order make dem probe how government take pump N3.8bn into MOWAA and N28bn into Radisson Hotel, say di matter don serious pass play. […]

todayDecember 5, 2025 6

Business

CPPE Urge FG to Tackle Cost of Living Through Agric, Manufacturing Boost

By: Esther Ayoola The Centre for the Promotion of Private Enterprise (CPPE) don sama message give wi Federal Government say make dem try put body for agriculture and manufacturing business say failure to do so go cos Niger economy betalicious problem. CPPE Director, Muda Yusuf talk say if goment no take strong action to fix wahala inside agriculture, manufacturing and trade, the country fit still struggle to turn economic growth […]

todayDecember 3, 2025 11

Lagos

Fire Burst Near RRS Base, Third Mainland Bridge Motorists Diverted

By: Esther Ayoola Nor be small mata oh for third mainland bridge, lagos, say fire  scatter bodey near rapid response squad (rrs) base for Adekunle, wey dey go Iyana oworo According to the Lagos State Traffic Management Authority as dem take sukili for social media X. say the fire le gidigan and that e cause better go slow for the area. Eyewitnesses talk say the smoke choke the area as the […]

todayDecember 3, 2025 7

Lagos

Lagos Tricycle Driver Jailed 10 Years for Killing Colleague with Stone

By: Esther Ayoola Lagos High Court wey wey put body for Tafawa Balewa Square don sentence one 42-year-old keke driver, Godswill Akpan, to 10 years jail after him kpai kpai im colleague, Baba Ali Bukar, say im give am beta 500 hundred for chest with stone. Justice Yetunde Adesanya find say the prosecution don prove without doubt say Akpan na him action cause Bukar death. Akpan first show for court […]

todayDecember 3, 2025 6

Lagos

Lagos Tell Lekki–Epe Road Workers Make Dem Quit Site Dec 4, Return January

By: Esther Ayoola The Lagos State Government don order contractors handling Eti-Osa/Lekki/Epe Expressway say make dem comot from site on Thursday, 4th December 2025, and return in January 2026. The announcement come from State Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, as e ma carry torch light go point area unto how the road mata go be for Epe. Government talk say the move na to make traffic waka freely during the […]

todayDecember 3, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app