News-auth

697 Results / Page 13 of 78

Background

National

Rivers Governor Fubara Reset Im Cabinet

By: Esther Ayoola Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don dissolve him whole cabinet for Port Harcourt. Dis mata dey sup, days afta im meet President Bola Tinubu and FCT Minister, Nyesom Wike, for Abuja to yarn about Rivers political settlement. Simi tell all Commissioners and Special Advisers make dem hand over dia work to senior civil servants for dia ministries. Governor Fubara sha thank all di officials wey dey go […]

todayFebruary 13, 2026 5

National

INEC Present Budget Say Na N873.78 Billion Dem Wan Take Run 2027 Election

By: Esther Ayoola Di Independence National Electorial Commission, INEC, say na N873.78 billion dem wan spend for di 2027 general election, anything less, fit make di election shake oh. Di chairmo, Joash Amupitan, tuk dis one on Thursday wen e present di 2026 budget proposal to National Assembly Joint Committee on Electoral Matas. Di breakdown show say Election Operational Costs (dat is only tools) go reach N375.75 billion, while Election […]

todayFebruary 13, 2026 2

National

Former Presido, Jonathan Tuk Why Young Pipo Need Enter Politics

By: Esther Ayoola Naija political senior mehn don drop bumbshell, say na because say Naija youths dey comot bodi from politics na make di kontri dey shake, calling old politicians to give young pipo chance, particularly as dia brain sti sharp Dem tuk dis one for memorial lecture and leadership conference wey Murtala Muhammed Foundation organise to mark 50 years since dem kpai di former Head of State Murtala Muhammed. […]

todayFebruary 13, 2026 1

National

Remi Tinubu Beg Nigerians To Joinbodi Build United Naija

By: Esther Ayoola Naija First Lady, Senator Oluremi Tinubu, Once again dey beg Nigerians to join bodi together build di country call Naija, say na only unity go hellep move di country forward. Mama Tinubu yarn dis one on Thursday for Leadership Annual Conference and Award 2025 wey happen for Abuja. Senator Oluremi say, e dey importakpa for pipo to forget religion and region scata scata, and dat na only […]

todayFebruary 13, 2026 3

National

Osun Police Command Gbag Travel Agent Say E Scam N3.6M

By: Esther Ayoola Police for Osun State don arrest one travel agent wey dem dey accuse say im scam two pipo of N3.6 million. Say di money na for visa and flight tickets to Luxembourg. Tuk, tuk of di osun police command, DSP Abiodun Ojelabi, explain, say di victims meet di suspect through one friend for January 2025. Dem give am di money make e arrange di visas, but instead, […]

todayFebruary 13, 2026 1

Lagos

Lagos Gorment Ginger Area To Keep Lagos Clean

By: Esther Ayoola Lagos State Permanent Secretary and Solicitor General, Hameed Oyenuga, dey cry wetin nor good say Lagos dey smell eh, say Lagos dey smell, all because of pipo just dey troway dirty yangayanga everywhere. E yan dis one for ogbonge two-day retreat wey Lagos State Special Offences Mobile Court hold for Amber Residence, Ikeja. Dem title di retreat “Di Mandate of di Lagos State Special Offences Mobile Court, […]

todayFebruary 13, 2026 3

Lagos

Lagos Tighten Campus Security With Ogbonge Tolls

By: Esther Ayoola Oga Executive Secretary and CEO of Lagos State Security Trust Fund (LSSTF), Dr Ayodele Ogunsan, don wire SMS give gornment, say make dem try to treat campus security for Naija very serious. E yan dis one for Lagos Campus Security and Safety Summit wey hapun for Lagos State University College of Medicine, wia im go give safety boots and motors. Say di summit bring gornment pipo, security […]

todayFebruary 13, 2026 1

Sports

Spurs Sack Thomas Frank Based On Bad Home Form

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don sack dia manager Thomas Frank afta dem lose 2-1 for house to Newcastle on Tuesday night. Dis one dey inside Sky Sports news, di Danish coach wey join Spurs last summer from Brentford leave di club as dem dey struggle for 16th position for Premier League table, just five points above relegation zone. Spurs never win any league match for 2026 and dia home […]

todayFebruary 11, 2026 8

National

Reps Committee Hail Women Affairs Ministry Inclusive 2026 Budget

By: Esther Ayoola House of Representatives Committee on Women Affairs don praise Ministry of Women Affairs and Social Development for di strong work wey dem dey do to solve problems for women across di country dey face. Committee Chairperson, Hon. Kafilat Ogbara, tuk dis one on Tuesday during 2026 budget defence with di Minister, Hajiya Imaan Sulaiman-Ibrahim, for National Assembly, as she hail di ministry for efforts on gender-based violence, […]

todayFebruary 11, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app