News-auth

322 Results / Page 14 of 36

Background

Lagos

15-Year-Old Boy Do Give Away For Mothers Inside Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Area gather on Sunday for Lagos Island say one 15-year-old, Onate Oton-Efebo, do beta give away for mothers inside Maternity Hospital. Di Secondary student touchlight tori pipo frequency say, na heart of love for community and for mothers, ni make am run di show. According to Onate, di waka sef dey possible because of beta support wey im get from im mama and papa. Say, dis na […]

todayJanuary 5, 2026 5

Lagos

Sanwo-Olu Leak Sand For Beta Joinbodi Development For Lagos

By: Esther Ayoola Baba govo, Babajide Sanwo-Olu, don clear clear mata wey concern Lagos for 2026 say make Lagos residents nor worry demselves too much dat, 2026 go sengemege, say goment dey plan big projects for transport, agriculture, health, energy, environment and infrastructure. E tuk dis one on Sunday for di 26th Lagos State Annual Thanksgiving Service wey shelle for Tafawa Balewa Square, Lagos Island. Baba Sanwo Olu, say im […]

todayJanuary 5, 2026 5 2

National

Kebbi Goment Open Town Schools Again After Bandit Wahala

By: Esther Ayoola Kebbi State goment don approve make some primary and secondary schools for big towns and cities resume immediately afta wetin jaguda boys use dia eyes see last year. U sabi say, dem bin close schools before, afta bandits attack Gorment Girls’ Comprehensive Secondary School for Maga town for November, wia dem kidnap 25 schoolgirls and kill one school guard. Commissioner for Basic and Secondary Education, Dr. Halimatu […]

todayJanuary 5, 2026 4 4

National

Kwankwaso Set Compass On How Im Wan Waka For 2027 Presidential Election

By: Esther Ayoola Oga national leader of New Nigeria People’s Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, say im nor be mumu oh, dat im go only waka go another party, if dem agree to give am presidential or vice-presidential ticket for 2027 election. U sabi say, Peter Obi join African Democratic Congress (ADC) last year and e go dey contest presidential ticket with Atiku Abubakar and Rotimi Amaechi, wey fit cause […]

todayJanuary 5, 2026 4

obodo oyinbo

US Wan Enter Colombia, Trump Say Colombia Presido Get Bad Character

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump like dis don turn attention to Colombia, say im no like Colombia Presido, Gustavo Petro. Dis one dey come afta world leaders send complain give am on why, U.S kramp Venezuela President Nicolas Maduro. For inside post for X, Trump tuk say goment for Colombia and Venezuela dey “sick,” and Petro dey do like person wey dey sell cocaine. Im still add am […]

todayJanuary 5, 2026 3 6

Sports

Coach Chelle Explain Why Im Luck Super Eagles Training

By: Esther Ayoola Super Eagles coachie, Eric Chelle, don come clear im decision to close team training for three days before Nigeria play Mozambique for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16. Some Aproko pipo for Morocco bin dey vex say dem nor get access to di super eagles. In fact, Photojournalist Olawale Quadri bin tuk say, rain and catarrh wan bin finish journalists, sake of say dem wan […]

todayJanuary 5, 2026 4

National

How House Of Rep Wan Protect Pikins From Jaguda Mama

By: Esther Ayoola House of Representatives don propose constitutional amendment to protect unborn pikin if im mama dey pregnant and dem sentence her to death, di move come after House Committee on Constitution Review, wey Deputy Speaker Benjamin Kalu dey lead, adopt di bill on Monday in Abuja. Di proposed change go add new subsection (1A) to Section 33(1) of 1999 Constitution, wey tuk say pregnant woman wey dey convicted […]

todayDecember 31, 2025 7

Sports

Michelle Alozie Hail FIFPro World XI Nomination As Big Honour

By: Esther Ayoola Super Falcons defender, Michelle Alozie, don troway salutation to her Nigerian teammates say her nomination for FIFPro World XI na big recognition of her hard work with Nigeria national team. According to sport aproko pipo, dem include Alozie among di 26 players wey make di 2025 FIFPro World XI nomination list for October. FIFPro World XI na di only global football award wey professional footballers themselves dey […]

todayDecember 31, 2025 4 2

obodo oyinbo

Mali, Burkina Faso Block Americans From Dia Country

By: Esther Ayoola Mali and Burkina Faso don place travel restriction on American citizens after di US put dem for no-entry list. Both countries’ foreign ministries tuk say di action na “equivalent measures,” as response to President Donald Trump decision to expand US travel ban reach almost 40 countries dis month. Di US list include Syria, Palestinian Authority passport holders, and some African countries like Niger, Sierra Leone and South […]

todayDecember 31, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app