News-auth

697 Results / Page 14 of 78

Background

obodo oyinbo

US Deploys 200 Soldiers to Hellep Train Naija Army

By: Esther Ayoola Say United States don send about 200 soldiers to come Nigeria to train Naija army how to fight Islamist militants. According to report from di Wall Street Journal on Tuesday, One American military oga tell di newspaper say the deployment hapun few weeks afta President Donald Trump accuse Naija gornment say dem no dey protect Christians well from terrorist attacks. Di report tuk say di US soldiers […]

todayFebruary 11, 2026 6

Lagos

Lagos Assembly, Waterside Communities Back Gorment Water City Plan

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly and representatives of di waterside communities don reach agreement to  support di state gornment plan to build water city for di areas wey dem demolish. Dem reach dis agreement on Tuesday evening during stakeholders meeting wey hapun for di Assembly complex for Alausa, Ikeja. According to Chairmo of di Ad hoc Committee on Rules and Business, Noheem Adams, di project go benefit […]

todayFebruary 11, 2026 4

Lagos

Lagos Gorment Close Lagos–Abeokuta Expressway Say Dem Wan Package Di Road

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say, dem go partially close Lagos–Abeokuta Expressway for four weeks. According to di Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, di closure go start from today Wednesday, February 11, make Federal Ministry of Works fit repair some bad portions of di road. Di repair work go cover di stretch from U-Turn Bus Stop reach Sango Tollgate. Both pipo wey dey go Lagos side and those wey […]

todayFebruary 11, 2026 12

Lagos

Lagos Begin Eye Test for Drivers to Manage Road Askident

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment like dis don begin eye testing and other health check for commercial drivers under one programme dem call Drivers’ Care Initiative, to stop askident. According to Senior Special Assistant to Govo Sanwo-Olu on Transport and Logistics, Hassan Adekoya,  say, di move na based on say gornment dey worry about di increase of road crashes for Lagos. Di exercise hapun for Lekki on Tuesday, where […]

todayFebruary 11, 2026 3

National

Amotekun Officer Testify Say E Knack Bullet With Owo Church Attackers

By: Esther Ayoola One Amotekun officer wey dem dey call SSG don testify for Federal High Court for Abuja say e fight gun battle with one of di pipo wey attack St. Francis Catholic Church for Owo on June 5, 2022. E say afta dem hear wetin hapun, dem rush enter bush based on information from eyewitnesses and meet di attackers as dem dey run. SSG tuk say when e […]

todayFebruary 11, 2026 4

National

President Tinubu Drop Yarns On How To Make Naija Economy Strong

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu, once again don loud doings say im wan give Naija economy ordechi, make  di economy strong, kakarakokoro. Im yan dis one for di second day of di  National Economic Council (NEC)  conference. Na Senate Presido, Na Godswill Akpabio, represent am, take tuk di tuk, promising say e go push reforms wey go bring betalicious result to di obodo Nigeria.

todayFebruary 11, 2026 2

National

Atiku Sukili Mouth For Electoral Act Mix-Up

By: Esther Ayoola Former Vice President Atiku Abubakar sef don join dey drag di naija Senate over di way dem handle di Electoral Act mata, say mixing manual and electronic transmission (e go be like rice and ogbonor mixed together,)  dat e go make election result drag. Di senior man yarn dis one afta im visit former military Presido Ibrahim Babangida for Minna with Oyo State Govo, Seyi Makinde. Atiku […]

todayFebruary 11, 2026 3

National

Suspected Herdsmen Kpai, Kpai Five, Kidnap 14 For Benue Villages

By: Esther Ayoola Say Five pipo don Kpai for Entekpa community, Adoka, Otukpo LGA, Benue State afta suspected armed herdsmen attack. According to report, di Gunmen still ambush one commercial bus for Utonkon, kpai two passengers, and kidnap 14 people. Some villagers for Adoka suffer gunshot wounds, while plenty others don miss. Eyewitness say, di attackers come with plenty cows, then suddenly start to shoot pipo and burn house. Ward […]

todayFebruary 11, 2026 3

National

Dangote Lower PMS Price To New Rate Of N774

By: Esther Ayoola Dangote Refinery say dem don reduce di gantry price of Premium Motor Spirit (PMS) by N25 per litre. Di Group Commercial Operations Department yarn marketers on Monday say di new ex-depot rate don drop from N799 go N774 per litre. Dem say di reduction dey effective immediately. Di Dangote group also add dat, di PMS lifting incentive don finish, and di move go make locally refined fuel […]

todayFebruary 11, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app