News-auth

1164 Results / Page 16 of 130

Background

National

Police Arrest 7 Suspects for Benue Kidnap Case

Security operatives for Benue State don arrest seven suspects wey dem link to di kidnapping wey hapun for Otukpo Local Government Area. Police PRO, Udeme Edet, naim dey konfamate  di mata for statement wey dem release on Friday. Recall say, di attack hapun on Wednesday when gunmen stop one Benue Links bus, rob di passengers and carry some of dem enter bush. Police tuk say na 14 people dem kidnap, […]

todayApril 18, 2026 35

Lagos

First Lady Insist Say Na Unity, Love And Respect Go Push Nigeria Forward

First Lady, Oluremi Tinubu again don press tuk  say national development go only work, when citizens joinbodi share values like love, tolerance, peace, sacrifice, compassion and service to humanity. She yarn this one on Friday for wia  she go do inauguration of Odo-Noforija Ultra-Modern Central Mosque for Epe, Lagos State. She no dey there physically, she send message through her Senior Special Assistant on Public Affairs and Strategy, Wahab Alawiye-King […]

todayApril 18, 2026 55

National

Wike Meet PDP NWC, Tell Dem make plans for No 2027 We Dey Elections

Di National Working Committee (NWC) of PDP Abdulrahman Mohammed branch don run  one meeting  with FCT Minister, Nyesom Wike, for Wadata Plaza, Abuja. Wike tuk say di meeting na to show im support for di party as dem dey prepare for 2027 election. E sti advise dem make dem bring beta plans wey go hellep PDP win elections and remain relevant. Wike also urge dem make dem continue reconciliation with […]

todayApril 17, 2026 16

National

Amaechi Drop Yarns Say Im Know Di Clour Of Naija Problem

Former Governor of Rivers State, Rotimi Amaechi, unto political doing don drop yarns oh, say ma know di colour of Naija problem and say im fit solve am if dem give am chance. Di former Minister of Transportation yarn dis one during recent political interview, where he tuk about him achievements as governor and minister. Na di aim take scarra table, say Buhari administration beta pass Tinubu gornment.

todayApril 17, 2026 14

Lagos

Konfam 89.5 FM Celebrate One-Year Anniversary

By: Esther Ayoola Lagos number one Family Radio, Konfam 89.5 FM scata area wetin nor good on Thursday 16 April with plenty Obule Obule, celebrating dia grand finale of dia one year Anniversary. Unto di doings, say na activities bulku for di event, Radio Fans and Favorite OAPs marking present for di event. Taking di center state, CEO, Kayode Adegbite fry, fry mouth inside im opening speech explain di journey […]

todayApril 17, 2026 13

National

FG Call For Emergency Meeting With Airline Pipo Say Aviation Fuel Rise

Di Federal Gornment don beg local airline operators make dem no stop flight operations because of di sharp increase for Jet A1 fuel price. Minister of Aviation, Festus Keyamo, make dis appeal for one letter wey im send give Airline Operators of Naija on Thursday. For di letter, Im also beg dem make dem think again before dem increase flight ticket price for passengers. Dis mata come as many airlines […]

todayApril 17, 2026 11

obodo oyinbo

UK King To Address US Congress For Visit

Say King Charles III wan give important speech for US Congress later dis month as part of im first state visit to United States. Buckingham Palace naim dey convasate dis one say from April 27 and go last four days, di king go address lawmakers with Queen Camilla by im side. Dem say di visit na to strengthen shared history and strong relationship between both countries, plus people-to-people connection.

todayApril 17, 2026 18

National

INEC Chairmo To Lead Big Talk On Nigeria Election Mata For April 29

Chairmo of Independent National Electoral Commission, INEC, Prof Joash Amupitan, say like don dey prepare body to deliver keynote speech for one big stakeholders meeting wey go tuk about Naija election process. Di programme dem title am, Law Corridor, one Abuja law firm, naim dey organise am and dat e go shelle April 29, 2026 for Abuja. According to report, say big men and women from political parties, civil society […]

todayApril 17, 2026 11

National

Akpabio Say Terror Attacks Na Plan To Shake Tinubu Government

Senate Presido Godswill Akpabio don finally tuk wetin do Naija, say all di recent terrorist attacks wey dey hapun for di obodo naija na plan by some people to distract President Tinubu. Im yarn dis one for Abuja during di opening of Naija Revenue Service headquarters. Akpabio even tuk say afta Tinubu win 2027 election, di bomb blasts go stop, say na pipo dey sponsor am.

todayApril 15, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds