News-auth

697 Results / Page 3 of 78

Background

Lagos

Lagos CAN Name Dia New Secretariat Afta Oluremi Tinubu for Alausa

By: Esther Ayoola Lagos State branch of Christian Association of Nigeria don rename dia permanent secretariat afta Oluremi Tinubu, almost 30 years afta dem open di place. U sabi say di building wey dem dey name “Senator Oluremi Tinubu CAN Lagos State Secretariat” for Alausa, Ikeja, na Daniel Okoh, di national president of CAN, na im officially open am. Okoh praise Lagos CAN members for dia ogbonge doings and unity […]

todayFebruary 25, 2026

National

Akure Police Commando Gbab 10 Suspected Kidnappers For Ondo State

By; Esther Ayoola Police for Ondo State don arrest 10 suspected kidnappers for Akure and recover ransom money wey dem collect from dia victims. Police tuk, tuk, Jimoh Abayomi, konfamate to tori pipo, from force headquarters, say di arrest na big breakthrough as dem dey continue crackdown on kidnapping and other violent crimes for di state. Say na joint operation between Anti-Kidnapping Section and PMF personnel from Force Headquarters carry […]

todayFebruary 25, 2026 4

National

Ogbomoso Askident Kpai Pregnant Woman, Five Final Year Student For Kwara

By: Esther Ayoola Six people, including one pregnant woman and five final-year nursing students, say ni kpai for one big car askident for Kwara side of Ilorin, Ogbomoso road. FRSC Kwara commandant, Rosemary Alo, konfam say di askident hapun for Ote area for Kwara. Alo say, Some of di victims kpai on di spot, while some others kpai for hospital. Say di five nursing students, na 500-level students wey dey […]

todayFebruary 25, 2026 5

National

APC Govos, Presidency Ginger Bodi For Grassroot Issues

By: Esther Ayoola All Progressives Congress Governors forum don go put bodi for grassroot doings to push di Renewed Hope Agenda of President Bola Ahmed Tinubu, say time don reach for dia reform to show workings. Untop di yarnings for di PGF Renewed Hope Ambassadors Summit 2026, Vice President Kashim Shettima ni carry di mata dey yarn, say time don pass wey dem go dey tell pipo to manage di […]

todayFebruary 25, 2026 2

National

Obi, ADC Drag APC Say Dem Use Hunger Finish Nigerians

By: Esther Ayoola Di 2023 labour parti presidential candidate, Peter Obi once again don drag di All Progressives Congress gornment afta gunmen, wey be suspected political thugs, attack some African Democratic Congress chieftains for house of John Odigie-Oyegun for Benin City, Edo State. Say, di attack hapun shortly afta di party leaders come back from ADC secretariat wia dem formally welcome Olumide Akpata join di party. Obi fry mouth untop […]

todayFebruary 25, 2026 3

National

FG Knock US Congress, Say No Be Religious Persecution for Naija

By: Esther Ayoola Wi Federal Gornment once again don react to US Congress tuk about alleged attack on Christians, say nobody dey support any kind religious persecution for Naija. On Monday, US House Committees on Appropriations and Foreign Affairs submit report to White House, recommend sanction over wetin dem call persecution of Christians for Naija. Reacting, Minister of Information, Mohammed Idris, say Naija never get any gornment policy wey target […]

todayFebruary 25, 2026 3

obodo oyinbo

Drone Attack Hit Kordofan Market, Sudan, Kpaing Plenty Civilians

By: Esther Ayoola Say di story dey worwor everyday for Sudan, dat drone attack don kpai plenty civilians for south-central Kordofan, Sudan. According to report from UN and humanitarian pipo, Fighting between Sudan army and Rapid Support Forces (RSF), don reach another level, as pipo dey kpai, kapi every day. UN officials say, drone hit market, hospital, aid convoy, and house, wey civilian bin dey hide. Dem warn say, di […]

todayFebruary 25, 2026 2

obodo oyinbo

Oyinbo Jaguda Break “No-Contact Order,” Stab Pipo To Death For Washington

By: Esther Ayoola Say one jaguda boy enter area for Washington state, U.S. stab, stab pipo anyhow, and dat nobody sabi wetin im dey think cause dis serious damage to innocent pipo Pierce County Sheriff say four pipo kpai for one house for di Tuesday attack. Di Sheriff reveal dat, one police officer wey reach di scene at 9:33 ni shoot di 32-year-old suspect, and di man kpai on di […]

todayFebruary 25, 2026 7

obodo oyinbo

Japan To Arrange Station Missile For Island Near Taiwan Based On China Tension

By: Esther Ayoola Report don land say, Japan wan position surface-to-air missile for one small island wey near Taiwan by March 2031. Japan defence minister, Sanae Takaichi, explain, say Na di first time Japan dey share where dem go put missile for Yonaguni island since 2022. While China dey claim Taiwan as dia own and report say, dem wan use force to “reunify” am. Tension don dey rise like two […]

todayFebruary 25, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app