News-auth

318 Results / Page 3 of 36

Background

National

Bandits Kpai 5 For Otobi, Benue State

By: Esther Ayoola Nor be small thing oh, eehooo, say Bandits don kpai kpai pipo for Benue again oh, say  five pipo kpai for Otobi community, Otukpo LGA, Benue State. One of di people wey dem say die, na 2019 PDP House of Assembly candidate, Igbabe Ochi. According to report, di attack happen around 1:30am on Tuesday, after community volunteer guards do better commando scarra some jaguda boys wey wan […]

todayJanuary 13, 2026 5 1

Lagos

Lagos Council declare Seven-Day Mourning For Badagry King

By: Esther Ayoola Di Chairmo of Badagry Local Gornment, Babatunde Hunpe, on Tuesday don go declare, say dem go observe seven days of mourning for di late Akran of Badagry, Aholu Menu Toyi I, wey die on Monday, January 12. Hunpe make dis announcement for Badagry through im Chief Press Secretary, Kriko Augustine. Di govo of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu, approve di announcement as Akran join him ancestors peacefully afta […]

todayJanuary 13, 2026 4 3

National

Lagos APC Tell Obi Say Tinubu Dey Active For Governance

By: Esther Ayoola Di Lagos State chapter of di All Progressices Congress on Tuesday don tuk dia tuk, say, wi oga Presido, Bola Tinubu no dey miss and dat e dey active for him duties. Di comment follow question wey Peter Obi, Labour Party presidential candidate for 2023, raise about di president’s presence yesterday. APC spokesman, Seye Oladejo, tell newsmen for Lagos say Tinubu still dey fully involved for governance, […]

todayJanuary 13, 2026 4 6

Sports

CAF To Arrange Draw For 2027 AFCON Qualifiers

By: Esther Ayoola Di Confederation of African Football (CAF) go do draw for di preliminary round of di 2027 Africa Cup of Nations (AFCON) qualifiers on Tuesday evening, wey go officially start di journey to di tournament. CAF on Monday don release di official pots for di teams wey go play for di preliminary stage. Pot 1 get Lesotho, Burundi, Ethiopia, Eswatini, South Sudan and Mauritius. Pot 2 get Chad, […]

todayJanuary 13, 2026 9 3

Lagos

Okpebholo Address Marras On Di Shops Wey Jaguda Boys Burn For Ekpoma

By: Esther Ayoola Following di Badness wey sup for Ekpoma over di weekend, Edo State Govo, Senator Monday Okpebholo, on Tuesday don drop promise, say di state gorment go hellep rebuild di shops wey fire burn for Ekpoma Police Division, for Esan West Local Government Area. Okpebholo tuk dis one when e visit di police station to assess di damage to di shops wey Police Officers Wives Association build. According […]

todayJanuary 13, 2026 4

National

Edo Gorment React To Jaguda Boys Doings For Ekpoma

By: Esther Ayoola Edo State Governor, Monday Okpebholo, don condemn di attack wey hoodlums carry go Onojie of Ekpoma palace after dem hijack peaceful protest against kidnapping and insecurity for di area. Di protesters scata market, kill goats, beat cows, block major road and destroy parts of di palace, making businesses come standstill. Governor Okpebholo finally visit di palace on Monday and tuk say di violence no dey acceptable, dat […]

todayJanuary 13, 2026 3

National

President Tinubu Put Bodi For Climate Change Submit In Abu Dhabi

By: Esther Ayoola Say like dis wi oga Presido, Bola Tinubu don arrange bodi to tuk Naija mata for climate change and sustainability for Sustainability Summit wey dey sup for Abu Dhabi, UAE. Untop yanings with tori pipo, Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar tuk say Tinubu go yan with other world leaders about Nigeria climate plan and how we fit develop. Tuggar also tuk say, Oga presido go use […]

todayJanuary 13, 2026 4

Lagos

Lagos Court Kramp Man For Yahooing N60m Naira

By: Esther Ayoola Police for Zone 2 Lagos, don do jaki chan for one man wey dem name Israel Onen for Federal High Court over N60 million visa yahoo wey im do. Onen face four charges wey include conspiracy, fraud, money laundering, and stealing. Court hear say between 2024 and 2025, Onen joinbodi with some pipo wey sti dey on di run  collect N60 million from one innocent  Ayodele Emmanuel. […]

todayJanuary 13, 2026 4 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app