News-auth

697 Results / Page 42 of 78

Background

Lagos

Lagos Internal Revenue Service Drag Lagos Employers for Tax Returns

By: Esther Ayoola Lagos State Internal Revenue Service, LIRS, don dey drop  reminder again, dat make  all employers for Lagos ensure say, by January 31, 2026 make dem submit  dia tax returns for 2025 financial year. For statement wey office release, LIRS Chairmo, Dr Ayodele Subair, tuk say, di order, dey under Nigeria Tax Administration Act 2025, and employers must declare all workers’ pay and pay correct tax. Oga Ayodele […]

todayJanuary 16, 2026 7

Lagos

Makoko Residents Block Road Gorment Demolish Dia Building

By: Esther Ayoola Residents of Makoko, Ilaje Aiyetoro Community, Yaba, say nor be small matching dem do for Lagos State House of Assembly yesterday, block part of di road dey protest say gorment go demolish dia buildings. Di protesters, wey be affected residents, dey beg Lagos Gornment make dem limit di demolition to 100 metres, and dat if dey continue di way dem go, say plenty families go dey homeless. […]

todayJanuary 16, 2026 9

National

President Tinubu Hail Baba Bisi Akande at 87, Call Am Pillar of Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu like dis, dey cut cap for senior govo, di b4, b4 govo Osun State  and APC pioneer chairmo, Chief Bisi Akande, as e clock 87 years of age. Tinubu describe am as mentor, ally and strong pillar wey hellep build and sustain democracy for Naija. According to Oga Presido, Baba Akande follow Obafemi Awolowo political ideology and later leave im accountant work […]

todayJanuary 16, 2026 11

National

Rivers Lawmakers Accuse Fubara, Insist Say Dem Must Impeach

By: Esther Ayoola Lawmakers of di Rivers State House of Assembly today we be Friday, dey insist dat, dem must investigate dia govo, Siminalayi Fubara, even accuse am say, im dey blackmail dem. Di lawmakers hold press today for Port Harcourt, wia dem tuk dia mind say Fubara nor dey fit enough to handle crisis for di oil rich state. According to di lawmakers, Fubara dey infringe on di 1999 […]

todayJanuary 16, 2026 8

obodo oyinbo

Museveni Lead Uganda President Election From first results with 76 percent

By: Esther Ayoola Oga Presido of Uganda, Yoweri Museveni like dis don dey dust im opponents, dey lead Uganda election result as counting of votes dey on. According to Electoral Commission of Uganda, afta dem count almost half of di polling units, Museveni get about 76 percent of di vote, while im main challenger, Bobi Wine, get around 20 percent. Like dis di gbege nor be here, say Bobi Wine […]

todayJanuary 16, 2026 8

Sports

CAF Unveil eAFCON Game, For Gamers

By: Esther Ayoola CAF don unveil eAFCON, di digital version of TotalEnergies African cup of Nations, to take African football enter di eSports world, incase your country lose real life, you use di computer game hold bodi. For statement wey dem release on Friday, CAF tuk, say di move na part of dia commercial strategy to grow business and reach more people. CAF explain say dem dey do beta joinbodi […]

todayJanuary 16, 2026 13 2

National

Nigeria, UAE Sign Big Trade Deal, Ministry Of Trade Explain Why

By: Esther Ayoola Minister of Industry, Trade and Investment, Jumoke Oduwole, don explain why wi oga presido go sign trade deal with UAE. She explain for TV sit don tuk on Thursday, say di Comprehensive Economic Partnership Agreement (CEPA) go allow over 7,000 Nigerian product enter UAE market duty-free. Oduwole add say dis deal go give local exporters beta road to carry products to di Gulf and global markets, hellep […]

todayJanuary 16, 2026 5

south west

Makinde Inaugurate Oyo Oba Council Afta 15 Years

By: Esther Ayoola Oyo State Govo, Seyi Makinde, don inaugurate Oyo State Council of Obas and Chiefs afta 15 years, wit Olubadan of Ibadan, Oba Rashidi Ladoja, as di first chairman. Di event happen for House of Chiefs, Secretariat, Ibadan, but Alaafin of Oyo, Oba Akeem Owoade, no show face for di inauguration. Govnor Makinde tuk say di chairmanship go dey rotate between Olubadan, Alaafin and Soun of Ogbomoso, say […]

todayJanuary 16, 2026 4

National

Witness Tell Court How EFCC Try Force Am To Testify Against Former CBN Govo, Emefiele

By: Esther Ayoola Say Court Scarra, when One defence witness, Nnamdi Offiial, go tell Special Offences Court for Ikeja say di Economic Financial Crime Commission (EFCC) officers try force im client, Henry Omoile, make e tuk wetin nor correct against former CBN governor, Godwin Emefiele. News Bin Report say, Emefiele and Omoile dey face charges of corruption and fraud, but both of dem don plead say dem no guilty. Official, […]

todayJanuary 16, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app