News-edi 1

1753 Results / Page 126 of 195

Background

Lagos

Lagos Go Host International Theatre Festival

Lagos don ready to take centre stage again as Lagos International Theatre Festival (LITF) return for di 2025 edition, wey go run from 10–16 November 2025. Di week-long event go celebrate creativity, culture and connection, turning Lagos into one global stage for world-class performance and cultural exchange. Organisers yarn say di festival wey dem don recognise as Africa’s number one international theatre event, go feature 20 productions across five stages […]

todayNovember 5, 2025 15

Lagos

You Fit Enter These Lagos Nursing Schools Without JAMB – See How To Apply

Lagos get some nursing schools wey no need JAMB before you fit enter, and dem dey offer Post-Basic Nursing and Direct Entry programs for people wey wan study nursing. Schools like Lagos University Teaching Hospital (LUTH), Nigerian Army College of Nursing (NACON), and Lagos State College of Nursing, Igando (LASCON) dey among di list. To gain admission, candidates must pass internal exams or interviews wey di school go conduct. For […]

todayNovember 5, 2025 16

National

Court Order NDLEA To Seize Pretty Mike Nightclub Over Drug Wahala

Di Federal High Court wey dey Lagos don order make one property wey belong to socialite and entertainer, Pretty Mike, dey under interim forfeiture after NDLEA accuse am say e use am keep and distribute drugs. Na Justice Musa Kakaki give di order on Tuesday after NDLEA lawyer, Mr. Buhari Abdullahi, carry motion go court. Di property, wey dey No. 7 Akin Adesola Street, Victoria Island, known as Proxy Lagos […]

todayNovember 5, 2025 18

Entertainment

Ned Nwoko Talk Say Regina Must Come Back Home Before Dem Free Sammy – Family

Regina Daniels’ elder brother, Sweezy, don raise alarm say dia younger brother, Samuel Daniels wey people sabi as Sammy West, don go missing after police arrest am for Lagos on Monday, November 3, before dem reportedly carry am go Abuja. According to reports, Sweezy drop message for Instagram accuse Senator Ned Nwoko of intimidation, talk say dis one no be ordinary arrest again. E  yarn say Sammy never get lawyer, […]

todayNovember 5, 2025 49 4

Entertainment

Regina Daniels Mama Talk Say Ned Give Police Money Make Dem Beat Her Pikin

Actress Regina Daniels’ mama, Rita Daniels, don cry come out say billionaire senator, Ned Nwoko, give police money make dem beat her pikin dem. Di woman raise alarm say her children don dey suffer for police hand for over seven hours as she beg Nigerians make dem come to her rescue. Dis wahala start after Regina Daniels herself come out accuse her husband, Ned Nwoko, say him send police go […]

todayNovember 4, 2025 13 2

Entertainment

Why I Dey Fear To Marry – Don Jazzy

Mavin Records oga, Don Jazzy don open up again about why e still dey single, say e dey fear marriage and di reason don make fans dey talk for online. As e yarn about love and relationship, di award-winning producer say sometimes e dey happy when e see couples wey dey enjoy dia love for social media, but e go come begin worry when e read about divorce and broken […]

todayNovember 4, 2025 26 2 2

Entertainment

Falz Talk Say Nigeria Condition Don Dey Depress Am

Nigerian rapper and activist, Folarin Falana wey everybody sabi as Falz, don talk say di wahala wey dey happen for Nigeria don dey make am feel depressed, especially as di level of tribal and religious tension dey rise every day. Falz yarn dis one after di gbege wey burst between Christian and Muslim youths for social media, afta report say former US President, Donald Trump, threaten to launch military action […]

todayNovember 4, 2025 16

Entertainment

Waje Don Clear Air, Say She Never Date M.I Abaga

Naija singer Aituaje Iruobe, wey everybody sabi as Waje, don finally open up about di long-time rumour say she and veteran rapper M.I Abaga bin dey date. Di singer yarn di matter for The Honest Bunch podcast, where she clear say she and M.I never date before, despite wetin many people don believe since dem drop di hit song “One Naira” in 2010. According to Waje, na di romantic theme […]

todayNovember 4, 2025 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app