News-edi 1

2593 Results / Page 130 of 289

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Package New Election Bill 2026

President Bola Ahmad Tinubu don sign di Electoral Act Amendment Bill 2026 into law on Wednesday, even as many Nigerians dey complain about one clause wey make electronic transmission of election results optional. Di signing hapun for Presidential Villa with Senate President Godswill Akpabio, Speaker Abbas Tajudeen, Senate Leader Opeyemi Bamidele, Deputy Speaker Benjamin Kalu and other top government officials present on wednesday. According to Tinubu, say im follow di […]

todayFebruary 19, 2026 19

Sports

Arsenal Blow Two-Goal Lead, Dirty Dia Title Hope

Arsenal title hope for Premier League don suffer big setback as dem throway two-goal lead and play 2-2 draw with bottom team Wolves on Wednesday night for Molineux. Bukayo Saka score early goal and Piero Hincapie add another one for second half, make am be like say Mikel Arteta boys go extend dia lead for top of di table. But Wolves no gree give up, as Hugo Bueno pull one […]

todayFebruary 19, 2026 33

obodo oyinbo

Bill Gates Cancel Last Minute AI meeting

Say area don gather for New Delhi for one ogbonge AI summit, dat Indian leader Narendra Modi go tok, plus tech chiefs like OpenAI Sam Altman. Bill Gates bin suppose tuk too, but e cancel last minute. Gates say im comot body so dat pipo go really focus on wetin AI Summit really mean.  

todayFebruary 19, 2026 32

Lagos

Lagos Fire Service Launch Marshal Club, Do Safety Training

By: Esther Ayoola Lagos State Fire and Rescue Service don launch Fire Marshal Club and carry out Safety Walk to waka town make pipo sabi how to prevent fire and respond in emergency. Say, di awareness waka start from dia headquarters for Alausa, Ikeja, pass Ikeja Fire Station, then return headquarters on Sunday. According to di Controller General, Margaret Adeseye, di way  fire  dey worry Lagos, too much, however cases […]

todayFebruary 16, 2026 35

National

Senate Explain E- Transmission Of Election Results clearly

By: Esther Ayoola Di Senate don explain dat, na wetin dem see for book, ni make dem take decide say electronic transmission of election results go dey optional instead of compulsory for di new Electoral Bill 2026. Dem say di decision no be by emotion, but afta dem consult people for communication and power sectors about di real situation for di country. Inside statement on Sunday, ni Senate Leader, Senator […]

todayFebruary 16, 2026 21

Sports

Saka Turn Center Mid Helping Arsenal Smash Wigan 4-0

By: Esther Ayoola Arsenal coachie, Mikel Arteta tok say Bukayo Saka fit play for center mid role afta dem win Wigan 4-0. Saka no suppose start, but he enter last minute because Riccardo Calafiori wunjor for warm-up. Myles Lewis-Skelly come shift back from midfield go left-back, Saka dey center behind Gabriel Jesus, with Gabriel Martinelli and Noni Madueke for each side. Say dis last-minute change   confuse Wigan, helping arsenal revenge […]

todayFebruary 16, 2026 35

Sports

Ikorodu City Wunjor Pipos Elephant For Aba As Rangers Close Gap

By: Esther Ayoola League leaders Ikorodu City do small show Micheals win important away match for Enyimba ground for Aba, to continue dia doings for top of Nigeria Premier Football League. Joseph Arumala ni score for di 29th minute, settling di match as Ikorodu City hold strong to di end. Dis win put Ikorodu City for 44 points from 26 games, dem dey pass Rivers United wey don drop go […]

todayFebruary 16, 2026 31

obodo oyinbo

Ukraine Former Energy Minister Galushchenko Land Police Net For Corruption

By: Esther Ayoola Former Ukraine energy minister German Galushchenko don land police net as im dey try japa from di country. U sabi say, e leave gornment last year afta e name show for corruption list. E dey among people wey dem tuk say, dem collect $100m for November embezzlement scandal. Say di mata sef shake President Volodymyr Zelensky gornment wey promise to fight corruption before Russia attack, so like […]

todayFebruary 16, 2026 38

obodo oyinbo

Israeli Soldiers Kpai 11 Palestinians For Gaza, Including Pij Commander

By: Esther Ayoola Israeli soldiers don kpai kpai at least 11 Palestinians for different parts of Gaza, According to hospital authorities, For Jabalia camp, dem hit tents wey displaced people dey, kill five. For Khan Younis, another five people Kpai. Say Dem also kill PIJ commander Sami al-Dahdouh for Tal al-Hawa, east Gaza City, say, di mata, na every day e dey worwor for Gaza.

todayFebruary 16, 2026 29

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds