News-edi 1

2593 Results / Page 140 of 289

Background

Sports

El Clasico Final: Barcelona Conquer Real Madrid 3-2

By Ebi Oboko Barcelona don go beat  Real Madrid 3-2 for El Clasico for Spain Super Cup final for Saudi Arabia, ni dem run dis one. Raphinha shine shine bobo, score two goals for  di Catalan side. Barcelona  wey dey top La Liga  qualify for di final afta dem hammer Real Betis 5-0 for semifinal. Real Madrid beat Atletico 2-1 for di second semifinal before dis final. Last year, Barcelona […]

todayJanuary 12, 2026 105 5

Sports

Super Eagles To Buy Waka To Rabat For AFCON Semis

By Ebi Oboko Unto update for AFCON, say Super Eagles go waka from Fes go Rabat on Monday afternoon for dia semi-final match wey dem go play against AFCON 2025 host Morocco. Team media officer Promise Efoghe na im yan one. On Sunday, Super Eagles don return Fes and dem do recovery session by 6:15pm for Saardienne football complex. Now, all the players and officials go travel to Rabat,  ready […]

todayJanuary 12, 2026 41 2

Lagos

Lagos State Varsity Don Open Job Recruitment For Students

By: Rilwan Agbomeji Lagos State University (LASU) don start recruit students enter LASU Cadet Corps, as dem officially announce am for X dis week. Di programme na student-focused paramilitary and leadership training, wey go help build discipline, patriotism, teamwork and leadership skills among undergraduates. How e go work be say cadets go also help with campus security, orderliness and official school events inside LASU. So if you be student wey […]

todayJanuary 9, 2026 37

Sports

CAF Comot Referee For Super Eagles Match Against Algeria

By: Rilwan Agbomeji CAF don comot Somali referee Omar Abdulkadir Artan from handling Super Eagles vs Algeria quarter-final for AFCON 2025, wey go happen Saturday for Grand Stade de Marrakech. Na because dem catch am say e wear boot brand wey no dey approved by official sponsors for one earlier match, and that one break CAF rule. Even though na di same man wey win Referee of di Year for […]

todayJanuary 9, 2026 53

Sports

Mahrez Yarn Say E No Fear Super Eagles Attack At All

By: Rilwan Agbomeji Algeria captain Riyad Mahrez don talk say e no dey fear  Super Eagles attack at all at all, ahead of Nigeria vs Algeria quarter-final for AFCON 2025 dis Saturday. Di Desert Foxes and Super Eagles go meet again for anoda big rivalry match as dem both enter knockout stage unbeaten. Nigeria don score 12 goals so far, pass any oda team for di tournament, but Mahrez still […]

todayJanuary 9, 2026 42 2

National

INEC Open Phase Two For Voter Registration For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don drop message for all Lagosian phone, wey never register with INEC, to go do dia voter registration. Resident Electoral Commissioner (REC) for Lagos, Ayobami Salami, ni on di message on Thursday. Say, Di first phase of voter registration end December 10, 2025, but di second phase don start since January 5, 2026, and dey happen for all local government areas […]

todayJanuary 8, 2026 29 2

National

ADC Swear For New Chairmo To Do Constitution Review

By: Rilwan Agbomeji National Chairmo of Africa  Democratic congress, David Mark, don  go swear  Senior Lawyer,  Etigwe Uwa (SAN)  say make im do  Chairmo for di party Constitution Review Committee for Abuja. Untop marras wey sup for di party headquarters for Abuja on Thursday, Mark tell di committee make dem work framework wey go promote inclusiveness, transparency and accountability, and still follow di party original principles. Im say di party […]

todayJanuary 8, 2026 26

Sports

CAF To Run WAFCON Draw 2026 Fixtures For Morocco

By: Rilwan Agbomeji Confederation of African Football (CAF) share update say di Women African Cup Of Nations  2026 final draw go hold for Rabat, Morocco on Thursday, January 15. According to CAF official post on X, Di draw go start 2pm local time (1pm GMT) For di same day, CAF go announce winners for Women Coach of di Year, Interclub Player of di Year, and Women Club of di Year […]

todayJanuary 8, 2026 50

National

Afenifere Don Raise Alarm As Terror Attacks Dey Plenty For Yorubaland

By: Rilwan Agbomeji Afenifere, di pan-Yoruba socio-political group, don yarn say dem dey worried about di way terror attacks don increase for Yorubaland and oda parts of Nigeria. For statement wey dem release for Ibadan, di group publicity secretary, Jare Ajayi, call South-West governors make dem act on di security resolutions wey dem agree on for dia meeting on November 24, 2025. Recently, gunmen attack forest guards for Old Oyo […]

todayJanuary 8, 2026 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds