News-edi 1

2355 Results / Page 139 of 262

Background

National

Osun Govo Adeleke Join Accord Party

By: Rilwan Agbomeji Still on di politcal movement, Osun State Govo, Ademola Adeleke don finally comout with im full chest, say im don join Accord Party to pursue im re-election wey go shelle forĀ  August next year. Governor Adeleke first confirmateĀ  dis mata for im verified x page few days afta e resign from Peoples Democratic Party. For im unveiling as new member, Adeleke tuk say e don actually register […]

todayDecember 10, 2025 11

International

Zelensky Yarn Marras Say Im Ready Run Election If Ukriane Dey Secured

By: Rilwan Agbomeji Ukrainian Presido, ZelenskyĀ  don reply US President Donald Trump say, Ā e ready to run new election if only dem fit konfamateĀ  sucurity and e go send new peace plan to Washington soon to try end dis four-year war wit Russia. Zelensky dey caput dis one afta e waka go plenty European country dey ask leaders how dem go take respond to US peace plan wey some people […]

todayDecember 10, 2025 18

Sports

NFF Promise To Pay Super Eagles Coachie Im Three Month Gbese Ahead Of AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Unto matter for sport, Nigeria Football Federation don comout clear fans doubt say dem go pay di Super Eagles coachie, Eric Chelle, salary wey dem owe am before di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. NFF top official talk say, dem dey owe di franco Malian Coachie Chelle three months salary plus bonuses, and dem wan pay am make e fit prepare di team wella. Di […]

todayDecember 10, 2025 18

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Rilwan Agbomeji For abuja,Ā  afta all di plenty drama for Osun state between di dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birthday message give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statementĀ  wey dem wrap like moimoiĀ  drop for her x page, Mama RemiĀ  dey hail Madam Adeleke for di serious work wey she dey do to uplift Osun people through […]

todayDecember 9, 2025 18

Lagos

Lagos Apc Shake Opposition With Talks Not To Disturb Tinubu

By: Rilwan Agbomeji Lagos branch of di All Progressives Congress (APC) dey vex carry matter for head dat make opposition no dey disturb president Bola Tinubu with ā€œfake politicking and fake wahalaā€ as 2027 dey wakaĀ  don near. APC lagos tuk tuk, seye oladejo,Ā  ni dey yarn dis one deyĀ  talk say dis time no be for confused coalitions or any political experiments. Di warning follow afta ADC yarn peter […]

todayDecember 9, 2025 18

Lagos

Lagos Govment Say No Structures Wey Dey Under High-Tension

By: Rilwan Agbomeji Lagos State government tire shirt oh say say dem go begin remove any building or structure wey people build under high-tension wire because e dey dangerous for residents. Na for inspection waka wey dem go do for Third Mainland Bridge area, Special Adviser Olajide BabatundeĀ  yarn dis one as im see plenty shanty and illegal structures wey no suppose dey di 50-metre right-of-way, im belle even turn […]

todayDecember 9, 2025 17 2

National

Senate Say Yes To Tinubu, Army Benin Republic Waka

By: Rilwan Agbomeji Wi Senate sharpaly do gree for wi oga Presido Bola Tinubu to carry Nigerian troops enter Republic of Benin, dem nor even stress am or do yanga say dem wan help restore peace. Oga senate Presido Godswill Akpabio announce di approval on Tuesday during plenary afta dem check Tinubu letter for Committee of di Whole according to Section 5, Part II of Constitution. Lawmakers join bodi vote,Ā  […]

todayDecember 9, 2025 16

National

Atiku Yarn Matas Say Late Yar’adua Still Dey Inspire Naija

By: Rilwan Agbomeji Wi former vice-presido Atiku Abubakar betterlicious don thruway salute give wi late general,Ā  Shehu Musa Yar’adua, say im still dey inspire politics for Naija. Im dey yanyanpu dis one for Abuja for inside union gathering, Atiku yarn say Yar’adua na correct mentor, brother-in-arms, and moral compass wey dey guide people even till now. Di former vice presido say,Ā  Yar’adua legacy dey motivate Nigerians wey still dey believe […]

todayDecember 9, 2025 14

National

Reps Tell NNCPL To Drop 2021 Audit Papers Dec 15 For Audit

By: Rilwan Agbomeji House of Reps Public Accounts Committee don claer marras dat make diĀ  nnpclĀ  drop all di missing documentsĀ  of company and show face for Abuja before December 15, 2025, overĀ  2021 spending audit wahala. Chairman Bamidele Salam vex for Monday sitting as e blast NNPCL for always dodging summons and refusing to bring di papers wey dem ask for. E talk say di kain disrespect wey di […]

todayDecember 9, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds