News-edi 1

1366 Results / Page 27 of 152

Background

National

Defence Minister Declare Say New Generals Must Fight Security Wahala

By: Rilwan Agbomeji Di minister of defence, Gen. Christopher Musa (rtd), don tell newly promoted Nigerian army generals make dem bring fresh and better strategies to tackle security wahala for di country. E talk dis one during di decoration ceremony of 28 major generals for Abuja. Musa remind dem say Nigerians dey watch dem and dey expect results, and di security challenges na everybody own, so dem must face am […]

todayDecember 11, 2025 7

Sports

Super Falcons Fall Enter 37th For FIFA Ranking

By: Rilwan Agbomeji According to report say Super Falcons don drop enter 37th position for latest FIFA Women World Ranking. FIFA release di new ranking on Thursday, and di Falcons no play any match during di last international break. Dem bin before dey 36th position for di world. Even with di drop, Naija still dey hold number one spot for Africa.  

todayDecember 11, 2025 10

foreign

How Tanker Wey US Seize Take Hide Im True Location

By: Rilwan Agbomeji US authorities don confirm say dia forces seize one vessel for Wednesday evening afta helicopter raid near Venezuela coast. Reports match di ship wey dem see for US footage with Skipper, using photo from TankerTrackers.com wey dey monitor oil movement. Tracking data show say di vessel never report its location since 7 November, and maritime analysts for Kpler even believe say e do ship-to-ship transfer to cover […]

todayDecember 11, 2025 7

National

Bayelsa Deputy Gov Collapse, Dem Rush Am Go Hospital

By: Rilwan Agbomeji Bayelsa Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, slump for Government House Yenagoa and dem rush am go hospital sharp sharp. Reports wey land troway say di incident happen Thursday afternoon and di matter serious. Sources add say dem carry am go Federal Medical Centre Yenagoa for sharp treatment, but hospital officials never yarn anything. Di Deputy Governor media person, Doubara Atasi, confirm say di thing happen but e […]

todayDecember 11, 2025 7

Lagos

Area Boys Brutalise Lagos Police Officer Say Im Go Thief

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Police Command don begin touchlight marras afta one viral video burst online, show how area boys  dey manhandle one uniformed police officer over allegation say im go thief. Di clip, wey circulate on Wednesday, capture di officer as blood dey pour from im mouth as angry area pipo surround am like say dem get am for mind before. Shege promax just dey whaooo whaooo […]

todayDecember 11, 2025 16 1

Sports

Super Eagle Legend Babangida Sama Message Give Coach Chelle To Arrange Beta Team For AFCON

By: Rilwan Agbomeji Former Naija winger, Tijani Babangida don tier better warning, role am, package am, give wi Super Eagles coach Eric Chelle say, make e no base di team only on striker Victor Osimhen for di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. Na for tuk tuk session with tori pipo on Wednesday, Babangida dey talk dis one,  say e dey risky as Naija dey depend too much on […]

todayDecember 11, 2025 10

International

Us Drag Mata Go Seize Oil Tanker Near Venezuela

By: Rilwan Agbomeji Dem say trouble dey sleep yanga dey go wake am, US don seize one big oil tanker wey dey near venezuela,  na oga  Donald Trump dey yarn dis one on Wednesday, and dis one don dey make tension with caracas rise. Untop yanings with tori pipo for im yard, Trump yarn say na di biggest tanker wey dem don ever seize, but e no give any more […]

todayDecember 11, 2025 7

National

Fubara Explain Why Im Move To Di APC

By: Rilwan Agbomeji Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don explain why im cartapot enter di All Progressives Congress, say, im dey carry plenty personal and political wahala because e refuse tell im own side of di tori wey dey cause gbagan for di state. Di governor yarn dis one as e commission di newly expanded Ahoada–Omoku Road for Rivers West, road wey Julius Berger build and wey be part of […]

todayDecember 11, 2025 6

National

Tinubu Open Plan Say Im Wan Use Sea Resources Take Create Jobs

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don drop mata again say contri pipo go join bodi use sea and mami water resources take boost economy, create work, and bring long-term progress. Vice presido Kashim Shettima talk di matt for presidential villa during meeting with senior executive course 47 from national institute for policy and strategic studies. Tinubu direct all ministries and agencies make dem check NIPSS report […]

todayDecember 11, 2025 5 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app