News-edi 1

1477 Results / Page 39 of 165

Background

Sports

Udeze Question Super Eagles Final Squad For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Former Super Eagles star Ifeanyi Udeze don talk say di final 28-man squad wey Nigeria release for AFCON 2025 get many questions wey never receive answer. Di final list drop on Thursday and e spark plenty debate for football circles. Nigeria pick three goalkeepers, eight defenders, eight midfielders and nine forwards for di tournament. Udeze say di selection still raise eyebrow and Nigerians deserve clearer justification.  

todayDecember 12, 2025 16

National

Senate Clear Fani-Kayode, Omokri, Ikpeazu, Ex-INEC Chair, Others For Ambassadorial Posts

By: Rilwan Agbomeji Di Senate Committee on Foreign Affairs turn to small theatre as dem screen Fani-Kayode, Dambazau, ex-INEC oga Yakubu Mahmood, Florence Ajimobi, Reno Omokri and di rest for ambassadorial positions. As senior men waka enter di meeting, all di ambassador wey dem wan screen take di bow but Omokri batch reach na so everywhere catch fire between Senator Mohammed Ali Ndume and Senator Adams Oshiomhole.

todayDecember 12, 2025 26

National

INEC Show Report Card Say Voter Registration Hit 2.6 Million

By: Rilwan Agbomeji Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce say over 2.6 million Nigerians complete dia voter registration for di first phase of di Continuous Voter Registration wey end on December 10. INEC Chairmo, Prof. Joash Amupitan, talk dis one for Abuja, and im say more than 1.5 million people register online while about 1.1 million do physical capture. Im add say di highest turnout come from Osun, […]

todayDecember 11, 2025 12

National

Defence Minister Declare Say New Generals Must Fight Security Wahala

By: Rilwan Agbomeji Di minister of defence, Gen. Christopher Musa (rtd), don tell newly promoted Nigerian army generals make dem bring fresh and better strategies to tackle security wahala for di country. E talk dis one during di decoration ceremony of 28 major generals for Abuja. Musa remind dem say Nigerians dey watch dem and dey expect results, and di security challenges na everybody own, so dem must face am […]

todayDecember 11, 2025 10

Sports

Super Falcons Fall Enter 37th For FIFA Ranking

By: Rilwan Agbomeji According to report say Super Falcons don drop enter 37th position for latest FIFA Women World Ranking. FIFA release di new ranking on Thursday, and di Falcons no play any match during di last international break. Dem bin before dey 36th position for di world. Even with di drop, Naija still dey hold number one spot for Africa.  

todayDecember 11, 2025 12

foreign

How Tanker Wey US Seize Take Hide Im True Location

By: Rilwan Agbomeji US authorities don confirm say dia forces seize one vessel for Wednesday evening afta helicopter raid near Venezuela coast. Reports match di ship wey dem see for US footage with Skipper, using photo from TankerTrackers.com wey dey monitor oil movement. Tracking data show say di vessel never report its location since 7 November, and maritime analysts for Kpler even believe say e do ship-to-ship transfer to cover […]

todayDecember 11, 2025 10

National

Bayelsa Deputy Gov Collapse, Dem Rush Am Go Hospital

By: Rilwan Agbomeji Bayelsa Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, slump for Government House Yenagoa and dem rush am go hospital sharp sharp. Reports wey land troway say di incident happen Thursday afternoon and di matter serious. Sources add say dem carry am go Federal Medical Centre Yenagoa for sharp treatment, but hospital officials never yarn anything. Di Deputy Governor media person, Doubara Atasi, confirm say di thing happen but e […]

todayDecember 11, 2025 9

Lagos

Area Boys Brutalise Lagos Police Officer Say Im Go Thief

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Police Command don begin touchlight marras afta one viral video burst online, show how area boys  dey manhandle one uniformed police officer over allegation say im go thief. Di clip, wey circulate on Wednesday, capture di officer as blood dey pour from im mouth as angry area pipo surround am like say dem get am for mind before. Shege promax just dey whaooo whaooo […]

todayDecember 11, 2025 20 1

Sports

Super Eagle Legend Babangida Sama Message Give Coach Chelle To Arrange Beta Team For AFCON

By: Rilwan Agbomeji Former Naija winger, Tijani Babangida don tier better warning, role am, package am, give wi Super Eagles coach Eric Chelle say, make e no base di team only on striker Victor Osimhen for di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. Na for tuk tuk session with tori pipo on Wednesday, Babangida dey talk dis one,  say e dey risky as Naija dey depend too much on […]

todayDecember 11, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app