News-edi 1

2341 Results / Page 38 of 261

Background

Lagos

Hamzat Select Senior Politician Obanikoro to Run im 2027 Campaign

By : Jolayemi Olajide Lagos State APC gofnorship candidate, Obafemi Hamzat, don point fingers hand give Nigeria former High Commissioner to Ghana, Senator Musiliu Obanikoro, say nothing wey im go tell am, dat n aim go lead im 2027 campaign. Hamzat drop di tuk on Wednesday for one meeting wey di campaign council hold to log dia plans. According to Amebo pipo, President Bola Tinubu don already sign di paper […]

todayJune 5, 2026 6

Sports

Liverpool Sign Andoni Iraola

Liverpool done officially appoint former Bournemouth coach, Andoni Iraola, as dia new manager on Thursday. Dis one dey hapun after dem sack Arne Slot last Saturday bicoz di poor team performance. Di 43-year-old Spanish coach tuk for interview say he dey over jolly to join di club, as everybody know say Liverpool na one of di biggest teams for di whole world.

todayJune 5, 2026 11

obodo oyinbo

Israel-Lebanon Ceasefire Bombing Continue

Israeli Army still dey carry out heavy strikes for Lebanon even after US try broker new ceasefire agreement wey suppose calm tension between Israel and Lebanon. So like dis now, Hezbollah leader, Naim Qassem don reject di ceasefire, call am fake, and say dem go still target northern Israel if Israel no stop di attacks. Lebanon Health Ministry say since March 2, over 3,526 people don kpai and 10,733 pipo […]

todayJune 5, 2026 5

OBODO NAIJA

State Police: Presidency Set To Sign Am!

Naija don dey move closer to start state police and dat, like dis di Presidency dey move very fast to change di law book wey go make am hapun. Oga Chief of Staff to the President, Femi Gbajabiamila, naim break dis news on Thursday after one major meeting inside State House for Abuja. According to Femi, dis mata don start many months ago after President Bola Tinubu give the order.

todayJune 5, 2026 8

OBODO NAIJA

We Go Rescue Kidnapped Oyo, Borno Pupils – FG

Di Federal Gornment don assure Nigerians say dem dey do everything possible to rescue di 82 pupils and teachers wey kidnappers dem carry for Oyo and Borno States. Di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, tuk dis one on Thursday for Radio House, Abuja, during one special national security tuk tuk wey dem do for Abuja. According to Idris, Baba Seyi don direct security agencies to move fast […]

todayJune 5, 2026 10

Lagos

Police Catch Four Cultists

Lagos State Police Command don catch four suspected cultists and recover gun, bullets, plus jackknife during one sharp operation wey dem do for Egbeda area. Di Command tok-tok person, SP Abimbola Adebisi, naim use a yam chop mouth on Thursday tuk how police use small jet li move to go gbab dis pipo  for midnight inside Alimosho axis. Among di tins wey di police dem collect from dia hand na […]

todayJune 5, 2026 17

Sport Yarns

Napoli  Wave Bye-Bye to Conte, Allegri Fit Take Over

By : Jolayemi Olajide Napoli don confirm say coach Antonio Conte dey leave di club before im contract finish. Conte wey help Napoli win Serie A title for 2024/25 season fit soon return as Italy national team coach. Reports say Napoli don dey discuss with Massimiliano Allegri to take over di coaching job. Allegri recently lose im position after AC Milan fail qualify for next season Champions League.

todayJune 4, 2026 11

obodo oyinbo

Oil Price Jump as Trump Vow Say Iran Sea Blockade Go continue

By : Jolayemi Olajide US Presido, Donald Trump dey press tuk  oh,  say US naval blockade for  Iran go fit last for months, as oil price go rise, dat dem nor understand wetin IRAN dey do. According to tatafo, Trump go gat wait for fresh military briefing on possible action against Iran from top US military commander Admiral Brad Cooper. As peace tuks between Iran and America still nor get […]

todayJune 4, 2026 13

OBODO NAIJA

Judge Order Sowore To Con Defend Imself Why Im Call President Bad Name

By : Jolayemi Olajide Justice Mohammed Umar for Federal High Court, Abuja don order Omoyele Sowore, the AAC presidential candidate, to appear an  defend imself  for accusate   im call President Bola Tinubu bad name for nothing. Di judge fling Sowore lawyer, Marshall Abubakar, wey bin dey beg make court forget di mata, con order say the hearing must happen every day starting from Friday, June 5. The Department of State […]

todayJune 4, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds