News-edi 1

1370 Results / Page 82 of 153

Background

Entertainment

Nancy Iheme Don React To Regina Daniels Marriage Wahala, Drop Strong Message For Ladies

Actress Nancy Iheme don drop her mind for Instagram as di wahala between Regina Daniels and her husband, Senator Ned Nwoko, dey hot. Even though she no call anybody name, her long post clear say e relate to di gist, as she warn young women make dem shine dia eye before dem marry older men. Nancy talk say many old men sabi play smart and women wey wan marry dem […]

todayNovember 5, 2025 15

Entertainment

Dem No Pay Me For Voice P-Square Do Me — Waje

Nigerian singer Waje don open up say she no collect shishi for di voice wey she drop for P-Square 2007 banger “Do Me.” She yarn dis one for HonestBunch Podcast as she remember her early hustle for music industry. According to her, di collabo wey first make Nigerians sabi her voice no bring any money or official recognition. “I no earn even one kobo from P-Square’s Do Me,” she talk […]

todayNovember 5, 2025 9

International

UK Don Order Poultry Restriction As Bird Flu Dey Spread

Di UK goment don order make all poultry and captive birds for England remain indoors from Thursday, November 6, as bird flu don begin waka up and down for di country. For di statement wey dem drop on Tuesday, November 4, di Department for Environment, Food and Rural Affairs (DEFRA) talk say di new rule go affect anybody wey get more than 50 birds or dey sell or give egg […]

todayNovember 5, 2025 5

International

Child Bride Fit Die If She No Raise £80,000

One young woman for Iran wey dem force marry as pikin dey face execution by hanging for di murd£r of her husband unless she fit raise £80,000 to settle di man family. Di woman, Goli Koohkan, now 25, marry her cousin when she be just 12 years old, and born her first pikin at 13. By 18, she don dey for prison after court sentence her to de@th for di […]

todayNovember 5, 2025 9 3

International

TP Mazembe Fan Kpai For Machete Fight With Lupopo Fans

Big wahala don shelle for Congo as TP Mazembe confirm say one of dia fans don die after machete knack am during Sunday Linafoot derby against FC Saint-Eloi Lupopo. Di five-time African champions talk for statement wey dem drop on Monday say di fan die for Lubumbashi Kenya area after di violent clash. “TP Mazembe dey mourn di death of one of dia supporters wey die on Sunday, November 2nd, […]

todayNovember 5, 2025 14

National

New Edo Law: Force Enter Govt Property, You Go Jail — Okpebholo

Edo State Governor, Monday Okpebholo, don sign new law wey go carry 10 years jail for anybody we force or violently enter government property for di state. Di governor still sign another section wey talk say anybody we sell or transfer government land without di governor consent go face five years imprisonment. Dis one follow statement from di governor Chief Press Secretary, Fred Itua, wey drop on Tuesday for Benin. […]

todayNovember 5, 2025 10

National

DSS Sack 115 Officers, Warn People Wey Dey Pose As Agents

DSS Sack 115 personnel, warn Nigerians against fake agents. Di Department of State Services (DSS) don sack 115 of dia personnel as part of ongoing internal reforms wey aim to strengthen professionalism and integrity inside di Service. Di secret police drop di update on Tuesday for dia official X handle, saying di dismissal happen over a period of time and e dey part of bigger effort to clean up di […]

todayNovember 5, 2025 9

National

Tinubu Welcome Catholic Archbishop Kaigama For Aso Rock

Tinubu meet catholic Archbishop Kaigama for Aso Rock as Trump talk say christians dey face persecution for Nigeria. President Bola Tinubu on Tuesday don hold meeting with di Catholic Archbishop of Abuja, Ignatius Kaigama, for inside Presidential Villa, Abuja. Di purpose of Kaigama visit never clear as people wey dey close to di presidency never talk anything about di meeting. Di meeting come shortly after one strong claim by United […]

todayNovember 5, 2025 14

Lagos

Lagos, NCF Don Call For Join Body Fight Against Plastic And Dirty Environment

Lagos State Government and di Nigerian Conservation Foundation (NCF) don call on Lagos people and companies make dem join hand fight plastic wahala and dirty environment wey don dey choke di state. Governor Babajide Sanwo-Olu yarn dis one for di 19th Walk for Nature event wey happen for Yabatech, where im talk say di theme “Lagos, Let’s Beat Plastic Pollution” no just sweet for ear, e serious well-well. Di governor […]

todayNovember 5, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app