News-edi 1

2593 Results / Page 86 of 289

Background

obodo oyinbo

Iran Fit Strike UAE – US Mission Warn

US mission for United Arab Emirates don issue warning say possible aerial threats fit happen. Dem advise Americans say make dem follow instructions from UAE authorities and get ready to run, after reports say, Iranian missiles and drones dey target UAE. Di US Mission explain say dis warning na based on di rising tension and safety concern for di region.

todayMay 5, 2026 26

Sports

Joshua Fit Finish Fury If Im Ready Mentally – Robert Garcia 

Former Anthony Joshua trainer, Robert Garcia, wey bin train Joshua for im rematch against Oleksandr Usyk, say like dis, dat, Joshua fit knock Tyson Fury out if dem meet for dia heavyweight fight. E tuk dis one for interview with ESNEWS on Monday night, say everything depend on if Joshua enter di ring with ginger. Garcia share believe say Joshua get beta skill and strong right hand wey fit end […]

todayMay 5, 2026 16

Sports

Sporting Lagos Beat Ranchers Bees for NNL Super Four Opener

Sporting Lagos beat Ranchers Bees 1-0 for di opening match of dia Nigeria National League Super Four playoff for Ikenne on Monday. Dem start di game with strong attacking pressure and show readiness from di beginning. Seun Akanji nearly score first for 17th minute but Ranchers Bees goalkeeper stop am. Aliyu Baba also try for attack as Sporting Lagos push hard until dem secure di winning goal.

todayMay 5, 2026 15

Sports

Doku Late Equalizer Save Man City as Everton Spoil Dia Title Charge

Finally Arsenal pull clear for EPL table following Manchester City 3-3 with Everton on Monday. City bin dey lead well for first half after Doku open di scoring, but dem lose di lead for second half. Everton fight back as Thierno Barry score two goals, while Jake O’Brien join header one, before Doku late equalizer settle di tie. Di result mean say Arsenal now get beta chance to win di […]

todayMay 5, 2026 20

Politics

Peter Obi, Kwankwaso Join NDC

Two of Nigeria top opposition, Peter Obi and Rabiu Musa Kwankwaso on Sunday like dis don buy waka officially join Nigeria Democratic Congress (NDC). Party big wigs, including leader Seriake Dickson na im  welcome dem for dia national secretariat for Abuja on Sunday. After di joining, Obi and kwankwaso  fry mouth, telling di gorment of di day to allow multi party system exist.

todayMay 4, 2026 31

OBODO NAIJA

Police Sack ASP Nuhu Usman, 4 Others

Di Nigeria Police force don sack ASP Nuhu Usman and four other officers wey  illegal kpai  one suspect for Effurun, Delta State. Nor be Amebo again say, police kpai 28-year-old, Mene Ogidi  for warri, and di tin cause serious anger online. Police tuk, tuk, DCP Anthony Placid, na im give dis annoucment on Sunday, say dem go still charge di officers to court for di mata.

todayMay 4, 2026 18

obodo oyinbo

Trump Launch Plan to Free Ships for Hormuz

US Presido, Donald Trump don announce new naval mission wey dem call “Project Freedom”, to escort stranded ships comot from Strait of Hormuz. Iranian lawmaker Ebrahim Azizi say if U.S enter di strait, dem go see am as breach of ceasefire agreement. Say like dis, Iran Foreign Ministry still dey look di response wey dem receive from Washington on dia new 14-point plan to end di war. Trump bin already […]

todayMay 4, 2026 13

Sports

Inter Milan Win Third Serie A Title in Six Seasons

Inter Milan don win Serie A title again, securing dia 21st Scudetto with 2-0 victory over Parma for San Siro. Marcus Thuram na im start di scoring before half-time, before Henrikh Mkhitaryan add another goal for second half to seal di win. With three matches still remaining, Inter don dey top Napoli by 12 points and AC Milan by 15 points. Dis na dia third title in six seasons, as […]

todayMay 4, 2026 14

obodo oyinbo

US Fit No Accept New Iran Peace Proposal – Donald Trump

Donald Trump talk on Saturday say e go check new peace proposal wey come from Iran, but e still show doubt whether di deal go work, as e no close door for possible fresh attack on Iran. Peace talks between United States and Iran don jam for ground since ceasefire start on April 8. One round of peace talks wey happen for Pakistan to end di war wey don pass […]

todayMay 3, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds