News-edi 2

1834 Results / Page 61 of 204

Background

OBODO NAIJA

NARD Give Federal Government August 10 Deadline, Threaten Nationwide Strike

By: Yusuf Abuh Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don give Federal Gornment till 8:00 a.m. on Monday, August 10, 2026, to fulfil di agreement wey dem sign before, or dem go begin total and indefinite strike for public hospitals across di country. Di doctors tok dis one after dia National Executive Council (NEC) meeting wey hold for Gombe State, say plenty promises wey gornment make never see implementation. Dem […]

todayJuly 31, 2026 14

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Clear Gofnors Im Mind, Stop Building Needless Flyovers

By: Yusuf Abuh Wi Presido Bola Tinubu don tia shirt oh,  say some state govos just dey waste gorment money. Dat dis gofnors just dey build fly over up and down even when di place nor get traffic Baba Seyi tuk tok dis one when im receive Oyo State traditional rulers for Aso Rock Baba say im nor understand wetin dey hapun, dat now state gorment dey pocket beta kpogiri […]

todayJuly 31, 2026 14

south west

Osun SSG Don Regain Freedom After Police Arrest

By: Yusuf Abuh Osun State Police Command don release Secretary to di State Government, Teslim Igbalaiye, after dem arrest am for im house for Osogbo on Wednesday. Imole Campaign Council tuk, tuk person, Pelumi Olajengbesi, announce di release and thank di Inspector General of Police and Osun Police Commissioner for responding to calls make dem free am. Police spokesperson, Abiodun Ojelabi, too confirm say Igbalaiye don regain im freedom. Igbalaiye […]

todayJuly 31, 2026 11

Lagos

LAWMA Lock Shops For Ojuelegba Over Illegal Refuse Dumping

By: Yusuf Abuh Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don cut chain oh, like dis now hand don touch some shops and business places for Tejuosho-Ojuelegba area because say traders dey dump dirty anyhow. Dis one hapun on Thursday after several warnings and repeated failure by di affected traders to obey sanitation rules. LAWMA oga, Dr. Muyiwa Gbadegesin, say di action na to restore clean environment, protect public health and make […]

todayJuly 31, 2026 13

Sports

Malawi Shock Super Falcons For WAFCON Opener

By: Yusuf Abuh Malawi don cause big surprise on Tuesday, beating defending champions Nigeria 3-2 for dia Group C opening match for 2026 Women's Africa Cup of Nations for Rabat. Temwa Chawinga score two goals, while Tabitha Chawinga add one to give di tournament debutants dia first-ever WAFCON victory. Rasheedat Ajibade and Uchenna Kanu naim score for di Super Falcons. Di historic win don give Malawi perfect start to dia […]

todayJuly 29, 2026 32 1

obodo oyinbo

Oil Price Drop As US, Iran Start Anoda Peace Tuk

By: Yusuf Abuh Washington and Tehran don begin fresh peace tuk, and dis one don make global oil price fall wetin nor good  as Brent crude drop below $84 per barrel. As at last week di oil bin dey sell as high as 100 dollars. Data from Oilprice.com show say Brent fall from around $87 on Monday reach about $83.92 on Tuesday, while US own oil, West Texas Intermediate, drop […]

todayJuly 29, 2026 13

OBODO NAIJA

Tinubu Tell Opponents Say 2027 Election No Go Easy

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don tire warn politicians wey dey plan to challenge am for 2027 say e no go give up power without a strong fight. Tinubu talk dis one on Tuesday when e receive Catholic Bishops Conference of Nigeria for Presidential Villa, Abuja, as e say democracy allow everybody to contest. Di President add say anybody wey wan take over from am go try, […]

todayJuly 29, 2026 11

Lagos

Lagos Gornment Open New Olusosun Road For Waste Management

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don commission di new 1.2-kilometre access road inside Ojota, to make waste management easier across di state. According to report dis new road go make possible for betaliocious waste management inside di obodo Nigeria. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, naim sorosoke dis mata as im ma go inspect di road. Oga Gbadegesin sef con say dis road go make waste movement smooth for […]

todayJuly 29, 2026 19

Sports

Zidane Finally Grab France Job As Deschamps Era End

By: Esther Daniel Zinedine Zidane don become new France national team coach on Tuesday, July 28, after French Football Federation announce am to replace Didier Deschamps. Di 54-year-old former France star don dey wait for dis opportunity for years, as many people see am as di right person for di job. Deschamps leave di position after 14 years in charge, ending one of di longest coaching eras for France national […]

todayJuly 28, 2026 31 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds