News-edi 2

1834 Results / Page 99 of 204

Background

National

Falana Give FG 14 Days To Collect $120.5B Wey NNPCL And Oil Companies Owe Naija

By: Esther Ayoola Human rights lawyer, Femi Falana (SAN), don give di Attorney General of di Federation, Lateef Fagbemi (SAN), 14 days to go drag $120.5 billion and N66.4 billion wey NNPCL, international oil companies, and others allegedly owe di Naija. Inside letter wey im write on June 2, 2026 for di group ASCAB, Falana say dis money na normal royaltu, crude oil theft, profit, taxes, and money wey dem […]

todayJune 5, 2026 14

south west

FG Vow To Rescue Kidnapped Oyo, Borno Pupils, Say Terrorism No Go Win

By: Esther Ayoola Di Federal Gornment don assure Nigerians say dem dey do everything possible to rescue di 82 pupils and teachers wey kidnappers carry for Oyo and Borno States. Di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, tuk dis one on Thursday for Radio House, Abuja, during one special national security tuk tuk wey dem do for Abuja According to Idris, baba seyi don direct security agencies to […]

todayJune 5, 2026 20 1

Lagos

Lagos Gorment Tighten Grip For Illegal Dredging, Say Communities Must Join Fight

By: Esther Ayoola Lagos State Government don promise to tighten monitoring and enforcement to stop illegal dredging and coastal degradation across di state 187-kilometre coastline. Di Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Ekundayo Bush-Alebiosu, naim sorosoke dis mata on Thursday news waka waka dem for im office. Bush-Alebiosu tuk say di ministry dey work with relevant agencies, stakeholders and communities to protect Lagos waterfronts and ensure sustainable development. According to am, […]

todayJune 5, 2026 13

National

President Tinubu, National Assembly Set Correct Activities To Celebrate June 12

By: Esther Ayoola Wi oga President Bola Tinubu don ready to scatta mouth with the National Assembly join-together address di country for 2026 Democracy Day. Di Inter-Ministerial Committee wey dem start on Tuesday tuk say other correct activities like Juma’at prayers, church service, and public lecture go also shele before di main day reach. Inside di program, special youth and women events go hold on June 10, then di Presido […]

todayJune 3, 2026 16

National

FG Tighten Ebola Check For Airports, Borders And Seaports Across Naija

By: Esther Ayool Federal Gornment don tighten Ebola check for airports, seaports and land borders across Naija to stop di virus from entering. Assistant Director Naija body mata pipo, Ado Bako, tuk say Naija never record any confirmed case yet. Ministry of Health yarn say travellers wey show symptoms or dem mark as high-risk go face extra screening, isolation and referral. As elders dey tuk, “better to close door before […]

todayJune 3, 2026 19

National

NANS Students Rise To Protest For Di 42 Borno Pupils Wey Kidnap Carry

By: Esther Ayoola NANS don drop words say students for North-East go march peaceful protest from June 5 to June 7 over di 42 school children wey gunmen carry for Borno.Chief of Staff to di Zonal Coordinator, Lukman Yusuf, announce say di action go happen same time for Borno, Bauchi, Gombe, Adamawa and Taraba. As elders dey tuk, “when pikin dey cry, e dey find something,” so di protest na […]

todayJune 3, 2026 14

south west

Gunmen Carry Former Minister Of Power Adelabu Sister And Twins For Ibadan

By: Esther Ayoola Former Minister of Power, Adebayo Adelabu, don cry out say armed men kidnap im younger sister, Olaide Busayo Adegoke John-Paul, and her 12-year-old twin boys for Ibadan. According to wetin im media aide, Femi Awogboro, talk, di attack happen early morning Wednesday as she dey carry di children go school, when gunmen block road and force dem enter motor. As Yoruba elders take tuk am, “when bush […]

todayJune 3, 2026 20

Sports

Liverpool Appoint Iraola As New Manager Afta Slot Sack

By: Esther Ayoola Liverpool don reach agreement to appoint Andoni Iraola as dia new manager afta successful tuks. Transfer expert Fabrizio Romano confirm di deal for X, say agreement don almost complete with im famous “here we go” update. Dis move come just few days afta di club sack Arne Slot following end-of-season review of dia performance. Iraola, wey lead AFC Bournemouth finish sixth and secure dia first-ever European qualification, […]

todayJune 3, 2026 11

Sports

Late Drama As Wales Hold Ghana 1-1

By: Esther Ayoola Lewis Koumas score late equaliser for added time as Wales draw 1-1 with Ghana for friendly match wey happen for dia home ground. Di result mean say Ghana never fit win any of dia last four matches, with three losses and one draw for dia recent games. Di Black Stars miss chance to start well under coach Carlos Queiroz as part of dia preparation for World Cup.

todayJune 3, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds