News-edi 2

1834 Results / Page 97 of 204

Background

National

Warri–Itakpe Train Askident Kpai Three Passengers

By: Esther Ayoola Nor be small thing, say na Three passengers naim sadly kpai afta train wey dey run Warri–Itakpe get askident on Monday. NRC naim dey konfamate di incident for news statement. Di Nigerian Railway Corporation tuk say emergency teams and other authorities rush go di scene to help handle dsi situation. Di corporation add say dem sti dey monitor wetin hapun and promise say full statement go come […]

todayJune 9, 2026 18 1

National

Naija, Madagascar Link Up As Tinubu Receive New Leader

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don welcome Madagascar Presido, Colonel Michael Randrianirina, for Aso Villa, Abuja, on Monday. Di Madagascar leader visit Naija as part of efforts to strengthen relations between both countries. Randrianirina become presido for October 2025 afta dem remove  president Andry Rajoelina from office. Before e enter power, na im lead one army unit wey join anti-gornment protesters and later announce military control of […]

todayJune 9, 2026 15 1

Lagos

LNSA Enter Criminal Hideouts, kramp 279 Suspects For Lagos

By: Esther Ayoola Nna men, things dey hapun for Lagos o! di Lagos State Neighbourhood Safety Agency (LNSA) don show say dem no dey sleep when e come to area security, as dem burst a total of 279 suspected criminals inside one massive statewide operation. Oga boss of di agency, General Manager Prince Ifalade Oyekan, na him parade all di suspects on Monday for dia headquarters inside Oshodi. According to […]

todayJune 9, 2026 11

south west

Ogun Gorment Set Up Committee To Secure Schools

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment don decide oh say dem nor wan hear dem shoot bird mama fly, like dis don set up security Committee to tackle jaguda boys for schools. Na oga Commissioner for Education, Prof. Abayomi Arigbabu, naim carry dis mata tuk give tatafo, say di committee go hellep improve safety, emergency response and beta learning environment for students and teachers. Di senior man commissioner explain say […]

todayJune 9, 2026 8

National

States Arrange Bush Police To Chase Bandits Out Of Bush

By: Esther Ayoola Oboi unto security marra, like dis now bush men don mout naija forest, naim oyobo dey call forest guard, say war don start against jaguda boys for di bushes Kebbi, Gombe, Kwara, and other states. You sabi, baba Presido, Bola Tinubu, bin give green light make dem recruit 1,000 forest guards because of the plenty kidnapping and bandit attack wey hapun for Oyo and Kwara States. Na […]

todayJune 8, 2026 15 2

National

Peter Obi Clear Nigerians Not To Blame Any Tribe For Criminality For Naija

By: Esther Ayoola Naija Democratic congress, presidential candidate, Peter Obi don drop some wisdom word (oro ogbon), say make Nigerians make nor tagget any particular tribe for all di security badness wey dey sup for Naija. For message wey e post for im verified X handle on Monday, Obi tok say as Igbo man, e don face plenty name calling and say many Fulani people dey suffer di same thing […]

todayJune 8, 2026 13

Sports

Portugal Star Rafael Leão Out Of Naija Match Afta Red Card

By: Esther Ayoola Portugal winger Rafael Leão no go play for dia  final World Cup warm-up match against Naija on Wednesday afta im collect red card against Chile on Saturday. Referee bin comot Leão for pitch before half-time because he give Chile defender, Ivan Román, one heavy blow for face. Even though Portugal play with ten men, dem sti bounce back beat Chile 2-1 as Gonçalo Guedes and Bruno Fernandes […]

todayJune 8, 2026 14

Sports

How Denmark Star Christian Eriksen Faint Again For Field

By: Esther Ayoola Say nor be small fear catch fans on Sunday as Denmark midfielder, Christian Eriksen, fall down for pitch during dia friendly match against Ukraine. Dis badness dey hapun for di second time to di 34-year-old player afta im heart first stop during di Euro match against Finland five years ago. Di Danish Football Association don bring statement say Eriksen eye dey open and im dey receive treatment […]

todayJune 8, 2026 13

obodo oyinbo

Iran Threaten To Fire America And Israel As Dia War Clock 100 Days

By: Esther Ayoola Iran don threat say dem go drop tins for  America and Israel sake of bombing wey hapun for Beirut on Sunday, as the Middle East war clock exactly 100 days. This new round of wahala dey spoil tins,  hope say peace go soon reign, don jam rock, like dis Tehran clear everybody, say any peace tuk to end the war permanently must also stop the fight inside […]

todayJune 8, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds