Blog horizontal

Background

National

Nyesom Wike Bad Mouth Peter Obi, Question Im Leadership Quality

By: Esther Ayoola Oga Minister of di Federal capital Territory, Nyesom Wike don blast Peter Obi say im no get beta leadership to handle anything. Di FCT minister yarn dis one on Sunday for PDP 2026 convention wey dem hold for Moshood Abiola National Stadium. E say Obi waka comot from Labour Party when gbege start, instead of solving di problem, say dat move nor be smart move at all. […]

todayMarch 30, 2026 2

National

President Tinubu Share Hope Say Naija Go Overcome Hardship

By: Esther Ayoola Oga Presido Bola Tinubu, drop ogbonge hope, say Naija go fit overcome di jogolo wey kontri man and woman dey face. Im yarn dis one afta im special birthday prayers wey dem do for am for National Mosque for Abuja. Tinubu tuk say e dey grateful to God and reflect dat, di country economic situation wey Naija dey face, say na just small time, everybody go dey […]

todayMarch 30, 2026 2

National

President Tinubu Honour Fallen Hero, Promise To Give Im Entire Salary

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don announce say im wan create special fund to support soldiers, including those wey get wunjury and for families of those wey kpai for service. Im tuk dis one for statement  on Sunday as E dey mark im 74th birthday, say na to appreciate di sacrifice of Armed Forces. Baba Seyi say Im don direct Accountant-General make dem open special account for […]

todayMarch 30, 2026 2

National

Olabisi Onabanjo Students Accuse Oru-Ijebu Police Of Beating Leaders

By: Esther Ayoola Olabisi Onabanjo University SUG don accuse police for Oru-Ijebu say, dem go beat dia leaders and fire gun for students wey no carry weapon. Di SUG explain, say di jogolo start, afta dia legal director  go police station to check why police arrest some of dia students under “unclear and questionable” circumstances. According to di SUG, police physically assault, kick, choke, and manhandle di Legal Director, con […]

todayMarch 30, 2026 3

National

Oyo Assembly Speaker Adebo Ogundoyin Join 2027 Governorship Race

By: Esther Ayoola Oyo State House of Assembly Speaker, Adebo Ogundoyin, don announce say him wan run for 2027 governorship election for di state. Im make dis announcement On Sunday, as PDP stakeholders for Ibarapaland gather for one zonal meeting wey hapun for Igboora. Say, dem endorse Ogundoyin as dia preferred candidate. Di stakeholders explain dia support, say na based of im leadership, loyalty to di party, and how e […]

todayMarch 30, 2026 3

Lagos

Lagos Go Heavy For Staff Welfare, Put Plenty Money For Training

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don insist say dem go continue to dey improve dia workers welfare, putting plenty money for training, education, and social support systems for 2025 and 2026 budgets. Commissioner for Finance, Abayomi Oluyomi, tuk dis one when e dey yan with tori for Lagos during di giving of insurance death benefits to family members of dead public workers. For di N4.44 trillion 2026 “Budget of […]

todayMarch 30, 2026 2

Lagos

NRC Nab Man Wey Dey Steal Railway Parts For Lagos

By: Esther Ayoola Say nor be small tin for Lagos , dat di Nigerian Railway Corporation (NRC) don catch one 32-year-old pikin say im bin dey  move railway parts for Lagos. Managing Director/Chief Executive Officer, NRC, Dr Kayode Opeifa, naim put dis for statement on Sunday. Say di NRC police arrest di 32 years old pikin on Thursday for Mobolaji Johnson Train Station, Ebute-Metta, with 15 pandrol clips wey im […]

todayMarch 30, 2026

Lagos

NDLEA Catch Drug Kingpin, Discover Cocaine Wey Dem Hide For Lagos

By: Esther Ayoola Operatives of National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, don go burst one big drug dealer wey dey hide cocaine inside okporoko fish head, for Lagos. Na for statement wey dem wrap like moimoi on Sunday, agency, tuk tuk, Femi Babafemi, dey tuk dis tuk, say during di operation, dem recover three jumbo bags from a 36-year-old suspect, Akputa Ejike. Di tuk tuk person say, dis operation hapun […]

todayMarch 30, 2026 1

OBODO NAIJA

ADC Chairmo Pikin, Blessing Onuh, Join Tinubu Re-election Campaign

ADC National Chairmo Senator David Mark, pikin, Hon. Blessing Onuh, don join front line to support President Bola Tinubu re-election. she put for statement on Saturday say D.G. of Take Action Campaign Organisation wey dey push Tinubu second term, Tony Nwulu, don present her appointment letter and dat she go be National Woman Leader. Onuh pledge say she go work hard to make sure Tinubu win, even as her papa […]

todayMarch 29, 2026 6

OBODO NAIJA

Spain Release Arsenal Midfielder Zubimendi Over Knee Wahala

Spain don release Arsenal midfielder Martin Zubimendi from dia squad. According to Spain Football Federation  on Sunday,  say na to protect im health and avoid any serious pain to di knee. Zubimendi play small as substitute for Spain 3-0 win over Serbia on Friday. Im nor go play friendly against Egypt for Barcelona on Tuesday.

todayMarch 29, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app