Blog horizontal

Background

Sports

Lamine Yamal React As Dembele Snub Am

Barcelona winger Lamine Yamal don react after Ousmane Dembélé no include am among im top three players for Ballon d’Or. Yamal jokingly ask whether Dembélé friendship with Kylian Mbappé fit get anything to do with di decision. Yamal make di comment after football transfer expert Fabrizio Romano post am for X on Wednesday. With smile, Yamal talk say, “Na Kylian Mbappé padi e be, abi?” But Yamal say e no […]

todaySeptember 9, 2026 10

Politics

Obi Say Nigeria Must Cut Gornment Cost, Fight Corruption

By: Kofoworola Olayinka Peter Obi don call for reduction in cost of gofnance and stronger fight against corruption to free money for health, education and poverty reduction. Obi make di call while speaking on Naija, saying gornment must unite di country, improve security and channel resources into critical areas. Di former Anambra gofnor also link poverty with insecurity, saying more people wey gornment fit lift out of poverty go help […]

todaySeptember 9, 2026 10

OBODO NAIJA

Alcohol Dey Encourage Banditry, E Dey Destroy Brain And Kidney

By: Damilola Adekunle NAFDAC DG, Professor Mojisola Adeyeye, don warn pipo say alcohol fit damage important organs for pesin bodi. She tok say na because sachet and small PET bottle alcohol don become too common, NAFDAC ban alcohol wey dey below 200 millilitres. Adeyeye tok say even as some pipo  no dey  happy as dem ban am, Nigerians still dey worry about how alcohol fit affect di  future of dia […]

todaySeptember 9, 2026 11

obodo oyinbo

Iran And America Start Another Round of War

By: Damilola Adekunle Iran and America don exchange fresh blows again as Tehran attack US targets for Middle East, following American strikes on Iranian oil tanker. Iran Revolutionary Guards tok say dem attack 20 US vessels around Strait of Hormuz, as dem also target an American military base for Jordan. Di US military tok say Iran first target one of di warships, as di fresh attacks don push oil price […]

todaySeptember 9, 2026 8

OBODO NAIJA

Keyamo Tell Everybody Make Dem Condemn Attack On Peter Obi

By: Adekunle Damilola Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don call for fairness and consistency for how media dey report political matters. Keyamo make di call while condemning di disruption of NDC presidential candidate Peter Obi  planned visit to Benue State. Im say whether na internal disagreement for NDC or supporters of APC and other rival parties cause di incident, nobody suppose tolerate am for democracy. Keyamo say […]

todaySeptember 9, 2026 10

Sports

NFF Appoint Eguavoen and Danjuma To Coach Di Falcons

By: Adekunle Damilola Nor be small shocky shocky for Naija football space, like dis na NFF give senior man, former Super Eagles coach, Augustine Eguavoen AKA Cerezo, say make im go role with di babes as interim coach of di  Super Falcons so dat dem go focus on  dia 2028 Olympic Games qualifiers. Say na Cerezo go train di senior girls as dem dey prepare to face Comoros for di […]

todaySeptember 9, 2026 11

obodo oyinbo

UN Cry Out As Ebola kpai over 3,200 Pipo for DR Congo

By: Mariam Ajayi Dis Ebola virus nor get same for eyes oh, see di way e dey rush  DR Congo, you go sorry for dem. Infact United Nations dey  scream, help oh help for DR Congo, say na over 3,200 pipo don kpeme, and like dis health workers dey sweat like person chrismas Goat, e nor easy. According to UN tok-tok person, Stephane Dujarric, To pull di handbrake on dis […]

todaySeptember 9, 2026 7

Lagos

APC Gather Religious Leaders Fire Prayers for Baba Presido

By: Mariam Ajayi Election don reach everybody mind dey shakebalabala, nor be small prayer wey di All Progressives Progress  Congress fire yesterday Onikan stadium for Lagos, say any opposition wey Say Bola  Tinubu  and Kadri Obafemi Hamzat nor go win di 2027 election, say make dem comot body joor. Senior mehn Pastors, Imams, and traditional worshippers naim put body for di mata. Gofnor Babajide Sanwo-Olu, party chairmo Cornelius Ojelabi, plus […]

todaySeptember 9, 2026 11

OBODO NAIJA

Peter Obi Carry Perper Body Ginger Give Federal Gornment

By: Mariam Ajayi Peter Obi don call on federal gornment to save thousands of Nigerians wey terrorists don drive comot dia villages. Obi drop dis fire call for X after e storm Mangu IDP camp inside Plateau State, an u know di badness wey sup for  Yelwata inside Benue State on Tuesday, wey boy block am. Supporters con dey ask, wetin dey give dis man mind, di former Anmabra state […]

todaySeptember 9, 2026 8

Politics

Ladi Adebutu Become Gbademu of Owu Kingdom

By: Ayobami Dada Ogun PDP gofnorship candidate, Ladi Adebutu, don become Gbademu of Owu Kingdom, as e promise say e go use the traditional title push development for Owu, Egba and Ogun State. Dem install Adebutu on Tuesday for Olowu palace for Abeokuta, with traditional rulers, politicians, family members and other big people present for di ceremony. Adebutu thank Olowu of Owu Kingdom, Oba Saka Matemilola, say the honour no […]

todaySeptember 8, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds