Blog horizontal

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Approve N3.3trn Plan To Clear Power Sector Old Debt

Wi oga Presido Bola Tinubu don approve N3.3 trillion plan to pay old debts wey dem dey owe Nigeria power sector. Dis decision come after final check of all di debts, wey pile up from February 2015 reach March 2025. According to a statement, president tuk tuk, Bayo Onanuga, di gornment agree on N3.3 trillion as full payment to settle everything in a clear and fair way. And dat dem […]

todayApril 6, 2026 19

OBODO NAIJA

Two Kpai, Many Wunjur As Truck Driver Crash For Soka Junction, Oyo State

Oyo State Police command don konfam say two pipo kpai and many others collobi wunjury after one big askident wey hapun for Soka Junction, Oluyole, Oyo State on Saturday night. Police tuk tuk person, Olayinka Ayanlade, na im dey explain dis mata give tori pipo on Sunday. According to Ayanlade, di gbege start when one white truck, say na one Abdullahi Bashiru bin dey drive dis truck, lose control because […]

todayApril 6, 2026 17

OBODO NAIJA

Ondo Speaker Explain Why Christians Need To Always Support Peace, Unity

Ondo Speaker Explain Why Christians Need to Always Support Peace, Unity   Speaker of Ondo State House of Assembly, Olamide Oladiji, don tell Christians for im state say, make dem dey promote peace, unity and get patience. E tuk dis one for im Easter message wey e give Christians for Akure on Sunday. Oladiji encourage Christians make dem follow Jesus Christ example, try to  sacrifice, love and build beta togetherness. […]

todayApril 6, 2026 12

OBODO NAIJA

NDLEA Bust Big Drug Syndicate, see  Cocaine wey dem Hide

Wi National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don buy robo cup waka scatter one big drug syndicate for Lagos, say dem don dey track am for three weeks. Director of Media and Advocacy, Femi Babafemi,  na im dey yarn dis one on Sunday for Abuja. say dem discover cocaine wey dem hide for tins wey get palm kernel extract. Dat di plan before na to send di drugs go United […]

todayApril 6, 2026 12

Lagos

LASEMA Report Two Fire Incidents For Lagos After Electrical Surge

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don share ogbonge update say na two separate fire gbege na im hapun for Lagos on Sunday, an all na electric na cause am. LASEMA tuk tuk oga, Afolabi Olawale,  na im dey konfamate dis mata as tori pipo bin dey touch light im frequency for dia office Lagos. Say di first fire hapun for FESTAC Town Phase 2 when one conduit wire spark […]

todayApril 6, 2026 20

Lagos

Governor Sanwo-Olu Enter 50-Year Property Agreement With Ikoyi-Property Owners

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu don approve 50-year rent package for pipo wey get property for Ikoyi-Obalende area. Di announcement come out through im special adviser on e-GIS and Urban Development, Olajide Babatunde, during one stakeholders meeting wey hapun for Ikoyi. Babatunde clear matas say dis approval na result of plenty years of discussion between Lagos State gornment and Obalende residents about di future of di community.

todayApril 6, 2026 17

OBODO NAIJA

How Oga Presido Tinubu Dey Get Sleepless Night Because of Insecurity

Wi Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris,  say like dis, wi oga  Presido Bola Tinubu dey work harder now to join hand with other countries make dem fit stop insecurity for Nigeria. Idris yarn dis one to journalists after im meet di President for Lagos on Sunday. Im talk say Tinubu dey reach out to neighbouring countries and international partners to fight problems like terrorism wey don scatta […]

todayApril 6, 2026 17

Sports

Chelsea Suspend Enzo Fernandez Say Im Break Club Rules

Say like dis na, Enzo Fernandez no go play for Chelsea for di next two matches after im talk about im future. Dis na according to update by coachie Liam Rosenior for im pre match conference. According to Rosenoir, di club get ruled and Enzo don pass di line as make comment say im wan join Real Madrid. Di 25-year-old Argentine wey join Chelsea January 2023 for record £107 million, […]

todayApril 3, 2026 30

obodo oyinbo

Iran Raise Alarm For Strait of Hormuz Security Vote Postponement

Iran don warn di UN Security Council say make dem nor do any “provocative action”, ahead of a scheduled vote wey dem wan take settle di wahala for strait of Hormuz. Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi na drop dis yarnings ahead of di Security Council suppose vote on draft resolution. Say di resolution na to hellep create force to secure di shipping lane wey dey vital to global energy supply. […]

todayApril 3, 2026 21

Lagos

Lagos CP Tijani Fatai Tight Security Wella Ahead Of Easter

For Lagos state police command, commissioner of police, Tijani Fatai don order massive deployment of officers across di state to make sure say pipo dey safe before, during, and after easter celebration. According to a statement released by police tuk tuk , Abimbola Adebisi, on Friday, say di police go station officers for churches, highways, parks, transport hubs and other important places to stop any wahala. Dat dem go also […]

todayApril 3, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds