Blog horizontal

Background

Lagos

How Lagos Gorment Wan Shift Pipo From NEPA Light To Solar Power

Lagos State gornment say dem want make pipo begin shift from poor light to solar power for their houses and small businesses. Commissioner for Energy, Biodun Ogunleye,  say like dis dem dey work on  system wey go make pipo pay for solar like how dem dey pay NEPA bill every month. Ogunleye yarn dis one during one solar project launch for Radio Lagos and Eko FM for Ikeja. E explain […]

todayApril 2, 2026 18

National

FG Declare Two Days Public Holidays For Easter

By: Esther Ayoola Federal Government don declare Friday April 3 and Monday April 6, 2026 as public holidays for Easter celebration. April 3 na Good Friday while April 6 na Easter Monday wey Christians go mark. Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, drop diannouncement on Wednesday and congratulate Christians for obodo Naija and obodo oyinbo. E sti advise Nigerians make dem follow example of Jesus Christ by showing love, forgiveness, patience, […]

todayApril 1, 2026 15

National

DSS Take El-Rufai To Base Afta Im Bail Hearing

By: Esther Ayoola Former Kaduna State governor, Nasir El-Rufai, like dis now don rent one bed room flat for DSS afta e bail hearing for Federal High Court, Kaduna on Wednesday jam rock. Say di security for court today nor be here, people begin suspect say dem fit carry mata go front. El-Rufai come court around 9:05 a.m. for one Hilux van wey attract plenty security eye. However, afta court, […]

todayApril 1, 2026 9

National

How WTO Madam Okonjo-Iweala Take Advice FG To Invest For Airport

By: Esther Ayoola Director-General of di World Trade Organization (WTO), Ngozi Okonjo-Iweala don tell Federal Government say dem need to fix and upgrade Naija airport dem if dem wan compete for global trade. She tuk dis one for Aircraft Acquisition and Investment Summit wey happen for Lagos, say beta airport no be choice again but must-do. She sti advise make gornment join hand with private investors so dat dem fit […]

todayApril 1, 2026 13

National

Adebayo Adelabu Deny Resignation Rumour

By: Esther Ayoola Oga minister of Power, Adebayo Adelabu don deny report say im resign to go contest for Oyo state 2027 governorship election. Oga Adelabu tuk dis one for TV sit down tuk say di news wey don go viral for social media na fake, as e never write any letter to step down. Adelabu explain say e stl dey focus on im work as Minister of Power, but […]

todayApril 1, 2026 14

Sports

Victor Boniface Return to Full Training, Fit Play Before Season Finish

By: Esther Ayoola Say Victor Boniface dey happy happy wetin nor good dat im don return back to full fitness afta missing for month sake of wunjury. Di Naija player do knee surgery for January, and people think say e no go play dis season again. But now, Boniface don start training dis week, and e fit even play for Bremen before season finish. Di 25-year-old wey join Green and […]

todayApril 1, 2026 14

National

IGP Disu Lead Nationwide Police Walk To Build Trust, Promote Fitness

By: Esther Ayoola Di Inspector General of Police, Olatunji Disu, don lead go lead one gonge nationwide walkathon yesterday wey involve senior officers, rank-and-file police, and members of di public as part of police week celebration. Say dem start di waka for Abuja from Force Headquarters go Unity Fountain. Untop yarnings with tori pipo, di senior man, Disu explain say na to display di spirit of di Naija police force […]

todayApril 1, 2026 10

Lagos

Lagos LG Chairmen Back Gov Sanwo-Olu Monthly Clean-Up Exercise

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don get support from all 57 LG/LCDA chairmen for di monthly environmental sanitation wey dem don bring back. Di mata follow one meeting wey some State Executive Council members hold with di council chairmen for Alausa, Ikeja. Oga Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab, make every tin clear for di meeting say e go make state and local government collabo to keep Lagos clean and […]

todayApril 1, 2026 20

obodo oyinbo

Israel Hit Lebanon Hard, Kpai Top Hezbollah Commander

Say like dis Israel don increase dia attack for Lebanon dis week, hitting places outside Hezbollah on Tuesday. According to reports, Dem strike one vehicle north of Beirut plus Jnah area for di middle of di capital. For di south and di suburbs, wey Hezbollah strong, dem sti dey hit places; one building for road to Beirut airport collapse afta dem evacuate di pipo wey dey inside. Israel say dem […]

todayApril 1, 2026 25

obodo oyinbo

Italy Sport Minister Tell Italy Football Ogas To Resign

By: Esther Ayoola Italy Sport Minister Andrea Abodi like dis don wire di head of football federation to resign afta Italy miss World Cup again. Italy lose for play-off to Bosnia-Herzegovina and no enter di USA, Canada, Mexico World Cup dis summer. Football oga , Gabriele Gravina tuk say e no wan resign, but di board go meet next week to decide im marras. Abodi dey insist dat dem need […]

todayApril 1, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds