Blog horizontal

Background

Sports

Super Falcons Set For UK Training Tour

African champions, Super Falcons, don set to travel go United Kingdom later dis month for training camp as part of preparation for di 2026 Women’s Africa Cup of Nations. Di training tour go happen from May 23 to 28, as Head coach Justine Madugu go use di chance check new players and test fresh legs ahead of di tournament. According to reports, di team go play one friendly match during […]

todayMay 9, 2026 14

OBODO NAIJA

Police Gbab 2 Jaduga Boys For Kwara, Recover AK-47 Gun

Police operatives for Kwara State don arrest two men wey dem suspect say na members of one kidnapping gang, and recover guns plus bullets for one operation for Ilorin. Di Commissioner of Police for di state, Adekimi Ojo, drop dis one for statement wey police tuk tuk person, Adetoun Ejire-Adeyemi, release on Saturday. According to di statement, na officers from di Intelligence Response Team wey dey under di state command […]

todayMay 9, 2026 18

obodo oyinbo

Mexico Wan Close School Sake of World Cup and Hot Weather

Mexico government don yarn say dem go close schools 40 days before normal time because World Cup dey come and hot weather don too much for many parts of di country. Education oga Mario Delgado na im yarn dis one on Friday for one event wey happen for Sonora, Northern Mexico, say dem go close school on June 5 make pikin and teachers no suffer for di serious heat, and […]

todayMay 9, 2026 11

obodo oyinbo

Ethiopia Woman Born 5 Pikin After 12 Years of Waiting

By : Jolayemi Olajide One 35-year-old woman, Bedriya Adem, don born rare quintuplets for Harari Regional State for Ethiopia after she wait 12 years to get pikin. According to report, She deliver four boys and one girl through Caesarean section on Tuesday evening. Doctors for the hospital talk say both di mama and the babies dey healthy, and di newborns weigh between 1.3kg and 1.4kg. Medical director of the hospital, […]

todayMay 8, 2026 20

OBODO NAIJA

Minister of Tegbe clear matas say im nor Promise to Fix Light In 3 Months

By : Jolayemi Olajide Power Minister-designate, Joseph Olasunkanmi Tegbe, don deny reports wey claim say e promise to fix Nigeria power grid within three months. E yarn dis one through im tuk tuk,  Adeola Adelabu, say di reports no represent wetin e truly tuk during im Senate screening on May 6, 2026. For statement wey dem post on X on Thursday, the minister explain say,  e only mention say gornment […]

todayMay 8, 2026 19

Sport Yarns

World Athletics Block IOC Move, Hold Ban on Belarus Sports Return

By : Jolayemi Olajide World Athletics don reject International Olympic Committee recommendation wey talk say Belarus athletes and teams fit return to compete under dia national flag for international events. Dis mata sef dey come after IOC executive board meeting on Thursday ginger sports bodies to allow Belarus back, but still maintain restriction on Russia because of Ukraine war. Both Russia and Belarus bin dey banned from Olympic competition since […]

todayMay 8, 2026 13

Entertainment

Shakira Link Up Burna Boy, Tease New World Cup Gbedu “Dai Dai”

By: Jolayemi Olajide Colombia music queen, Shakira don drop  2026 World Cup gbedu, dem title “Dai Dai”, shoot small video for Brazil Maracana Stadium yesterday. Di Colombian singer wey sing 2010 “Waka Waka”,  team up with Nigerian artiste Burna Boy to produce di song. For di 67-second video, Shakira enter di  pitch of Maracana for Rio de Janeiro, after she perform free concert for Copacabana Beach last Saturday. Di song […]

todayMay 8, 2026 37

Sport Yarns

Trump Reject $1,000 World Cup Ticket, Say E Too Expensive

By: Jolayemi Olajide US Presido, Donald Trump don scata table say, even im sef nor go pay $1,000 ticket price to watch USA vs Paraguay for 2026 World Cup opener. Di tournament go start June 11, with US, Canada and Mexico as co-host, while USA go begin dia campaign for Los Angeles on June 12. Trump tell media say im no even know say ticket reach dat amount, but im  […]

todayMay 8, 2026 14

Sport Yarns

Aston Villa Wipe Forest 4-0, Enter First European Final In 44 Years

By: Jolayemi Olajide Aston Villa don qualify for dia first European final in 44 years, beating Nottingham Forest 4-0 for dia Europa League semi-final second leg on Thursday. Dem overturn di 1-0 first leg loss as Ollie Watkins score before half-time, while Emiliano Buendia add another one through penalty after di break. Captain John McGinn finish di job with two late goals to seal di win for Villa wey end […]

todayMay 8, 2026 17

obodo oyinbo

Germany Finance Minister Blame Trump Iran War As Tax Revenue Go Down For Germany

By : Jolayemi Olajide Germany finance minister Lars Klingbeil like dey vex wetin nor good dat, Donald Trump “ war for Iran”  dey scata tins for dem, say na wetin cause big drop for germany expected tax money. Di German Finance minister yarn dis one for news tuk on Thursday, dat, di US presido action don really bring global energy down and e dey affect economy worldwide. Say Germany don […]

todayMay 8, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds