Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Bandits Kpai 6, Kidnap Many For Easter Church Attack For Kaduna

Say nor be small gbege for Kachia LGA of Kaduna State, dat Residents of Ariko community dey cry dat bandits attack dem early Sunday morning during Easter service, kill six worshippers and kidnap many others. Eyewitnesses talk say di gunmen come in large numbers, surround First ECWA Church and St. Augustine Catholic Church, then open fire on pipo wey dey worship. According to locals, di attackers carry out di operation to kidnap victims and collect money, as dem also steal […]

todayApril 7, 2026 3

OBODO NAIJA

Kemi Adeosun Expose How BVN Help Gorment Catch 45,000 Ghost Workers

Former Finance Minister Kemi Adeosun don expose mata tuk how Federal Gornment take use technology wipe out plenty fake names for gornment payroll. She say, when dem link salary system with BVN, dem discover about 45,000 ghost workers wey dey collect money for nothing. According to her, before dat time, gornment dey spend pass salaries wey dem suppose dem pay, say na so corruption full plenty gorment offices. She say instead of forcing new registration, dem just use BVN run […]

todayApril 7, 2026 5

OBODO NAIJA

BUA Chairmo Rabiu Hail Tinubu Reforms, Say Tough Step, but Na Correct Move

Chairmo of BUA Group, Abdulsamad Rabiu, like dis dey hail wi oga presido, Bola Tinubu economic, though say im reforms dey tough but na di right step forward for Nigeria. E talk dis one when e visit di president for Lagos for di easter break. After meeting na dis senior man con dey explain every, say, di gornment removal of fuel subsidy and devalue di naira, all dey correct, telling Nigerians to dey patient.

todayApril 7, 2026 4

obodo oyinbo

Presido Trump To Touch Light Iran Ceasefire Deal

White House officials, all di way from united state of America on Monday don konfamate say dem dey consider one 45-day ceasefire deal between U.S. and Iran for di Middle East war. Di senior men wey tuk with Agence France-Presse, say di only tin be say Donald Trump never sign di deal. Dem explain say na mediators bring di proposal as part of efforts to reduce di fighting, but Trump administration still insist to continue di military operation wey dem […]

todayApril 7, 2026 5

OBODO NAIJA

Naija Soldier Expose Full detail Of Army Monthly Salary

One dismissed Nigerian soldier Rotimi Olamilekan, don scatta table oh, wey people sabi as Soja Boi, explain how many army personnel dey suffer buy dia uniform and protective gear by demselves. E yarn dis one for one interview wey never drop, as e tuk say im last salary before dem sack am na around ₦109,000 to ₦111,000, after dem increase am from about ₦51,000. According to am, before di increment, even with allowance, di total money no pass ₦70,000, and […]

todayApril 7, 2026 2

Sports

Mbappe Set To Shine As Madrid Face Bayern For UCL Clash

Real Madrid coachie Arbeloa don konfamate say, star boy, Kylian Mbappe go dey available for di Champions League clash with Bayern Munich on Tuesday. For Pre match conference, Di Coachie explain say Mbappe na very important player for di team. Mbappe wey be their top scorer nor start di last games against Manchester City because of knee injury, but di team still win wella. Now wey e don recover, coach hint say Mbappe go likely play alongside Vinicius Junior for […]

todayApril 6, 2026 1

Politics

Oyo 2027, Makinde Set Mission To Choose Successor For 2027

Oyo State Governor Seyi Makinde on Sunday, for Ibadan, Oyo State say like dis now im don start process to choose who go succeed am for 2027 election. Di senior put for letter wey dem give tori pipo, say dem don involve credible people to make sure di transition smooth and fair, and im go make di announcement later. Makinde explain say, im don task im advisory council, led by Senior Advocate Bolaji Ayorinde, to meet all PDP governorship aspirants […]

todayApril 6, 2026 7

Lagos

Fanti Carnival 2026 Begin With Colourful Brazilian Display

Say like dis di 2026 Lagos Fanti Carnival don start on Monday for Tafawa Balewa Square. According to news post on X wey show different pictures, say pipo, cultural groups, and tourists dey celebrate di carnival, for di arena. Di carnival, wey dey hold every Easter Monday, normally na to show di strong cultural connection between Nigeria and Brazil. According to di organisers, di event dey promote heritage and identity while revellers dey enjoy procession wey start from historic communities […]

todayApril 6, 2026 5

OBODO NAIJA

Kwankwaso Condole With Jega As Im Wife, Hadiza, Pass Away

Former Kano Govo, Rabiu Kwankwaso, don commot condolence give former INEC Chairman, Attahiru Jega, as im wife, Hadiza Jega, kpai on sunday. For im Facebook post on Monday, Kwankwaso say Hadiza na woman wey get virtue and dignity, wey life don touch plenty pipo. Im add say, her life na blessing not only to her family but to everybody wey she show kindness and strength. Kwankwaso pray make Jega and im family get courage to bear di loss of dem […]

todayApril 6, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app