Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Dey Plan Special Number Plates For Pipo Wey Get Disability

Lagos State Gornment don begin plan to introduce special vehicle number plates for people wey get disability, so movement fit easier and everybody fit enjoy equal access across di state. According to statement from di state gornment, Lagos State Office for Disability Affairs, LASODA, and Lagos State Motor Vehicle Administration Agency, MVAA, na dem dey work together to bring di plan to life. Di idea come after LASODA management visit MVAA, where both agencies discuss how dem go create and […]

todayJuly 29, 2026 22

Sports

Cucurella Draw Spain Coachie Face On Top Him Body

Spain defender, Marc Cucurella, don honour World Cup-winning coach, Luis de la Fuente, by drawing di coach tattoo for him body after Spain win di World Cup. Cucurella help Spain beat Argentina 1-0 for di final, as De la Fuente lead di team to another international trophy. Di Real Madrid defender reveal di new tattoo for social media after him £52 million move from Chelsea in June. Di tattoo show di coach holding di World Cup trophy with di number […]

todayJuly 29, 2026 28

obodo oyinbo

South Africa See Shege As Migrants Comot

South Africa dey face serious labour shortage after thousands of foreign workers leave di country because of anti-migrant attacks and tighter immigration enforcement. According to One Zimbabwean farmworker wey porpoly dis mata, Aaron Majatamhe, say plenty fruits and grapes still dey for farms because no enough workers dey to harvest them. Di shortage don affect farms, factories and even homes, as employers now dey struggle to find workers. Reports show say more than 160,000 migrants don return to dia home […]

todayJuly 29, 2026 24

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Tuk Say Naija Economy Dey Improve

Wi oga Presido, Bola Tinubu don rake again, say if bad belle pipo like, make dem tuk from now  till tomorrow, dat wetin im knw be say Naija economy don bunch back like bounchy bounchy cattle. Na oga  Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, mouth naim yarn dis one on Tuesday after e lead di National Communications Team go meet di Presido for wi decision headquaters. According to Idris, as dem enter area, na so baba Seyi begin […]

todayJuly 29, 2026 22

Lagos

Lagos Tighten Safety Rules for High-Rise Buildings

Lagos State Gornment don carry mata for head  dey hawk Lagos problem, say, di way building take collapse don too much, and like dis na to “protesion” every every for di obodo Lagos naim be di goal. Small tin, person go hear, one building don collapse, if nor be building na fire as dem ginger all lagosians to dey very careful with dia safety. Na di oga kpatakpata, Director-General of di Lagos State Safety Commission, Lanre Mojola,  naim use im […]

todayJuly 29, 2026 23

Sports

Malawi Shock Super Falcons For WAFCON Opener

By: Yusuf Abuh Malawi don cause big surprise on Tuesday, beating defending champions Nigeria 3-2 for dia Group C opening match for 2026 Women's Africa Cup of Nations for Rabat. Temwa Chawinga score two goals, while Tabitha Chawinga add one to give di tournament debutants dia first-ever WAFCON victory. Rasheedat Ajibade and Uchenna Kanu naim score for di Super Falcons. Di historic win don give Malawi perfect start to dia campaign, while Nigeria go need recover for dia next Group […]

todayJuly 29, 2026 39 1

obodo oyinbo

Oil Price Drop As US, Iran Start Anoda Peace Tuk

By: Yusuf Abuh Washington and Tehran don begin fresh peace tuk, and dis one don make global oil price fall wetin nor good  as Brent crude drop below $84 per barrel. As at last week di oil bin dey sell as high as 100 dollars. Data from Oilprice.com show say Brent fall from around $87 on Monday reach about $83.92 on Tuesday, while US own oil, West Texas Intermediate, drop to around $79 per barrel. Like dis na, marketers stand […]

todayJuly 29, 2026 14

OBODO NAIJA

Tinubu Tell Opponents Say 2027 Election No Go Easy

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don tire warn politicians wey dey plan to challenge am for 2027 say e no go give up power without a strong fight. Tinubu talk dis one on Tuesday when e receive Catholic Bishops Conference of Nigeria for Presidential Villa, Abuja, as e say democracy allow everybody to contest. Di President add say anybody wey wan take over from am go try, because politics na game wia everybody get equal opportunity.   […]

todayJuly 29, 2026 12

Lagos

Lagos Gornment Open New Olusosun Road For Waste Management

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don commission di new 1.2-kilometre access road inside Ojota, to make waste management easier across di state. According to report dis new road go make possible for betaliocious waste management inside di obodo Nigeria. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, naim sorosoke dis mata as im ma go inspect di road. Oga Gbadegesin sef con say dis road go make waste movement smooth for di obodo Lagos.   Read similar tori for here: https://konfamfm.com/lagos-govt-gbab-12-people-wey-dey-throway-dirty-anyhow/

todayJuly 29, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds