Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Talk Tough For Jos Attack, Say Peace Must Reign

Wi oga Presido Bola Tinubu on Thursday don finally visit di palm Sunday attack victims for Jos, Plateau State. E say dis one na to calm tension and make justice hapun. For there, senior man Tinubu tell di Nigeria police and soldiers to go after di killers con sti order di plateau gorment to  install CCTV cameras for betament security doings for di state.

todayApril 3, 2026 12

OBODO NAIJA

Ogun Gorment Close Ijebu Ode School After Gas Leak

Ogun State gornment don order say Our Lady of Apostles Secondary School for Ijebu Ode make dem close am after suspected gas leak wey hospitalize about 30 students and staff. Di gbege hapun on Wednesday just after school assembly, when some kind gas spread across di school compound. Commissioner for Environment, Ola Oresanya, tuk on Thursday say Governor Dapo Abiodun don direct security agencies make dem investigate how di incident hapun, why e happen, and who responsible. Say  di investigation […]

todayApril 3, 2026 12

Lagos

Lagos Gorment Catch Task force Members Wey Dey Harass Drivers

Lagos gorment don gbab three taskforce boys wey dem dey call “Omotaku” say dem dey harass drivers for Lagos highway Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab,  yarn dis for im verified X page on Thursday. According to Wahab, di Omotaku dey always dey disturb drivers once dia car spoil for Lagos highways, dey force dem to give money or things. Di gornment catch dem make dem stop dis kind wahala and restore peace for road.

todayApril 3, 2026 16

Lagos

Lagos CP Tijani Meet Stakeholders, Promise Beta Policing

Di new Lagos state police commissioner, Tijani Fatai don run ogbonge meeting with stakeholders for di state to promise say dem go run policing wella for di state. Baba commissioner of police give dis assurance as part of packages to run di national police week, 2026. Di gathering involve all di different characteristics of human beings wey dey stay Lagos, na so oga Fatai take fry im mouth tuk say dem go do dia best as police with beta collabo […]

todayApril 3, 2026 15

Lagos

Presido Tinubu Land Lagos To Celebrate Easter And Open Projects

Wi oga Presido Bola Tinubu don enter Lagos for easter celebration after im go condole victims of di Angwan Rukuba attack. Tinubu arrive airport around 7:20 p.m., where Lagos State Govo Babajide Sanwo-Olu and other top officials receive am. People wey see am tuk say Tinubu go celebrate Easter and also inaugurate some gornment projects for di state.

todayApril 3, 2026 10

Sports

DR Congo And Nine Oda African Countries Qualify For 2026 World Cup.

Africa don lock record 10 teams for 2026 FIFA World Cup after DR Congo knack di last spot. Di Leopards take di slot after dem hammer Nigeria for African play-offs, then knack Jamaica 1-0 for intercontinental play-offs on Tuesday night. Dem join nine oda African countries wey don already secure dia place. Meanwhile, Super Eagles no fit make am again for second time straight. Na first time Africa go carry 10 teams go World Cup, show say dem dey strong […]

todayApril 2, 2026 24

obodo oyinbo

Iran Yarn Say Dem Go Hit US Hard After Trump Threaten Dem

On Thursday, Iran yarn say dem go give US and Israel crashing attacks, as dem fire missile reach Tel Aviv after US President Donald Trump talk say dem go bomb Iran “back to Stone Ages.” Di fight don dey since US and Israel start strike Iran over one month ago, e don spread for whole Middle East, dey shake global economy, affect plenty millions pipo worldwide. For White House talk, Trump yarn say US dey very close to achieve wetin […]

todayApril 2, 2026 16

OBODO NAIJA

World Bank Approve $500m Credit Giv Nigeria Agricultural Value Chains.

World Bank don approve $500 million credit give Nigeria to boost agriculture, especially for small farmers, value chains and food security. For statement wey World Bank drop for their website on Thursday, dem talk say di money go make small farmers produce more, create jobs, and make food and nutrition better for di Obodo Nigeria. Di global lender talk say agriculture still be Nigeria biggest employer, but e never dey show better workings sake of say gbege dey for di […]

todayApril 2, 2026 16

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Cancel Ogun Trip, Waka Go Jos On Top Insecurity Marras

Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don cancel im Ogun trip wey suppose happen on Wednesday, make im first waka go Jos, Plateau State, to feel with victims of di gbege wey kpai at least 27 pipo for Angwan Rukuba district on Sunday. Na Special Adviser to di Presido on Informate and Strategy, Bayo Onanuga, talk am for statement wey im sign on Wednesday. Di move come after Tinubu and Plateau State Govo, Caleb Mutfwang meet for Aso Rock Villa on Wednesday […]

todayApril 2, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds