Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Cancel Ogun Trip, Waka Go Jos On Top Insecurity Marras

Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don cancel im Ogun trip wey suppose happen on Wednesday, make im first waka go Jos, Plateau State, to feel with victims of di gbege wey kpai at least 27 pipo for Angwan Rukuba district on Sunday. Na Special Adviser to di Presido on Informate and Strategy, Bayo Onanuga, talk am for statement wey im sign on Wednesday. Di move come after Tinubu and Plateau State Govo, Caleb Mutfwang meet for Aso Rock Villa on Wednesday […]

todayApril 2, 2026 14

Politics

APC Resume Dia E-registration System, PDP Claim 4.2 Million Members

APC don resume dia registration doings even as politics don dey hot. APC tuk tuk, Felix Morka, for statement on Wednesday announce am say, dem don resume electronic registration for all wards and approved spots nationwide. E tell old members make dem go confirm dia membership, and new people make dem rush join di party sharp sharp. But for PDP side, one faction wey Tanimu Turaki lead, and Seyi Makinde back, dey claim say dem don gather like 4.2 million […]

todayApril 2, 2026 15

Lagos

Make Una Shine Eye Well Well For Fake And Expired Products – LASCOPA

Lagos State Consumer Protection Agency (LASCOPA) don warn Lagosians say make dem shine eye well well, as Easter dey come, say chances of people to cheat and sell bad market dey high for dis period. For statement wey dem drop for dia X page on Thursday, General Manager, Afolabi Solebo, talk say make consumers stay sharp as buying and selling go increase. E say make people careful because price fit shoot up, some traders fit sell fake, expired or dangerous […]

todayApril 2, 2026 16

Sports

Super Eagles Hold 26th Spot After Win Over Iran, Draw With Jordan For FIFA Ranking

Nigeria Super Eagles still hold 26th place for di new FIFA World Ranking. FIFA ranking  normally dey follow Elo system wey dey calculate points based on match result, opponent level, and how important di match be. For March friendly matches, dem beat Iran 2-1 and draw Jordan 2-2. Di win against Iran give dem 5.34 points, but di draw with Jordan wey no too strong make dem lose 1.81 points.

todayApril 2, 2026 12

obodo oyinbo

UN Question Di Death Of 3 Indonesian Peacekeepers For Lebanon

All 15 members for UN Security Council don condemn di wahala wey make three Indonesian UN peacekeepers kpai die for Lebanon. Di council tok dis one for join bodi statement, say di incidents happen for UNIFIL area for south Lebanon, including two deadly explosions, as fighting dey go on along di Blue Line between Israel and Lebanon. Dem wish di injured quick recovery, praise all UN peacekeepers wey dey risk dia life for international peace, and reaffirm say dem support […]

todayApril 2, 2026 16

OBODO NAIJA

ADC, PDP, Obi Blast INEC As Dem Drop David Mark, Aregbesola Recognition

Di African Democratic Congress, Peoples Democratic Party, and Peter Obi dey vex wetin nor good for  INEC say dem  remove David Mark, Rauf Aregbesola and some other party leaders from recognition. INEC tuk say dem take dis decision because of court order wey say make dem maintain status quo until dem settle case about David Mark leadership. ADC tuk, tuk Bolaji Abdullahi and PDP own Ini Ememobong say dis action na plan to scata democracy for Nigeria. Dem even accuse […]

todayApril 2, 2026 14

OBODO NAIJA

Kaduna North, South Join Body To Back Bola Tinubu, Uba Sani For 2027

Former Kaduna Central senator Shehu Sani talk say Kaduna North wey be mostly Muslim and South wey be mostly Christian don join body under one political party for di first time since 1999. E yarn dis one after Imself, Abbas Tajudeen and Sunday Marshall visit Bola Tinubu for Aso Rock. According to am, di unity na because of wetin Uba Sani and Tinubu don achieve, and both North and South don agree to support dem again for 2027 election.

todayApril 2, 2026 13

OBODO NAIJA

President Tinubu Change Date For Ogun Airport Inauguration To April 4

Ogun State Gornment don shift di inauguration of Gateway International Airport and other big projects wey dem plan for Thursday, April 2. Dis one happen after Bola Tinubu change di date of im visit to di state. For statement wey Special Adviser to di Governor on Government House and General Services, Babatunde Olaotan release on Wednesday, dem talk say dem don move di event. Now, di inauguration go happen on Saturday, April 4 instead. Gornment say dem dey prepare well […]

todayApril 2, 2026 15

Lagos

How Lagos Gorment Wan Shift Pipo From NEPA Light To Solar Power

Lagos State gornment say dem want make pipo begin shift from poor light to solar power for their houses and small businesses. Commissioner for Energy, Biodun Ogunleye,  say like dis dem dey work on  system wey go make pipo pay for solar like how dem dey pay NEPA bill every month. Ogunleye yarn dis one during one solar project launch for Radio Lagos and Eko FM for Ikeja. E explain say dis plan go help residents reduce dependence on unreliable […]

todayApril 2, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds