Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Oshiomhole Blast Umahi On Top Bad Federal Roads

Senator wey dey represent Edo North, Adams Oshiomhole, don blast Minister of Works, Dave Umahi, say e dey rush start new road projects while plenty old roads still dey bad condition. Oshiomhole tok dis one for Senate on Wednesday, as e point say road wey connect Edo and some Delta cities still dey poor shape. E say di way Umahi dey share road projects no balance and e fit make people believe say e dey favour some areas pass others. […]

todayJuly 30, 2026 23

Lagos

Adedeji Omope Promise More Development For Bariga

Bariga LCDA Chairman, Adedeji Omope, don promise more infrastructure, youth empowerment and social programmes for residents. Omope make di promise as Bariga LCDA celebrate her first anniversary in office on Wednesday. During di celebration, more than 2,000 residents receive bags of rice to help reduce di effect of economic hardship. She thank residents for dia support and say di achievements come through teamwork between government and di pipo.

todayJuly 30, 2026 24

Sports

Tobi Amusan Eye Third Commonwealth Games Gold

Nigeria star athlete, Tobi Amusan, go start her fight for third straight Commonwealth Games gold medal today for women 100 metres hurdles for Glasgow, Scotland. Di world record holder and defending champion go run for di first heat against athletes from Ghana, Canada, Jamaica and other countries. Di qualifying race go start by 11:30 dis morning, while di final go happen by 9:49 tonight for Scotstoun Stadium. Amusan, wey don win di last two editions of di Games, dey hope […]

todayJuly 30, 2026 30

obodo oyinbo

Russia Missile Attack Kpai One Pesin for Kyiv

Ukraine officials say at least one pesin kpai after Russia launch missile attack early Thursday morning for Kyiv, Ukraine capital. Say na so everything spoil for di city sote Mayor, Vitali Klitschko con tell residents make dem run enter shelter for safety. Poland Armed Forces say dem quickly send fighter jets protect dia airspace because di Russian air strikes happen close to dia border, while rescue workers rush go affected areas to help victims. Ukraine President, Volodymyr Zelenskyy, wey warn […]

todayJuly 30, 2026 14

OBODO NAIJA

Head of Civil Service Konfam Say Fake Agency DG Documents Na Scam

House of Representatives committee chairmo, Yusuf Gagdi, don tok say investigation don show say di appointment letter wey Director-General Adeyemi present na fake, and even di law wey e use support am na forged document. Gagdi tuk dis for Abuja on Wednesday, as Head of Civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, appear before di committee for di second time and confirm say di documents no be original. Walson-Jack admit say her office no do enough verification before dem […]

todayJuly 30, 2026 19

Lagos

Police Gbab Suspected Armed Robber for Lagos

Lagos State Police Command don arrest one 29-year-old man wey dem suspect say na armed robber during routine patrol on Wednesday for Igando area of Lagos. Police tuk, tuk person, SP Abimbola Adebisi, naim konfamate dis one say officers sight three men wey dey ride one motorcycle and dey behave funny and na so dem take follow dem up. She say as di suspects see police, dem try run, but officers catch one of dem while di remaining two escape […]

todayJuly 30, 2026 46 1

obodo oyinbo

Europe Dey Feel Di Heat As Wildfire Spread

European Union don call for stronger action against climate change as fresh heatwave dey threaten France, Spain and other European countries with more wildfires. EU Crisis Management Commissioner, Hadja Lahbib, say Europe must invest more in climate action, forest management and disaster preparedness as global warming dey get worse. So far, more than 330,000 people don run from their homes, with about 220,000 evacuated in France and 110,000 in Spain because of di wildfires. Di EU also warn say countries […]

todayJuly 29, 2026 22

OBODO NAIJA

Reps Committee Reopen Investigation On Top Presidential Council Marras

House of Representatives ad hoc committee again don open mata to touch light every every unto wetin sup  into di alleged operation of di disputed Presidential Foreign Intervention Promotion Council. Di committee like dis dey ask di self-acclaimed Director-General of the council, Adeniyi Adeyemi, thick thick question and dem con finally konfam say di appoint letter na fake. Head of di  Civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, and representatives of di Inspector-General of Police sef make present for […]

todayJuly 29, 2026 21

OBODO NAIJA

Nigeria Tell South Africa Make Dem Stop Xenophobic Attacks

Nigeria don call on South Africa to take urgent action to stop di repeated xenophobic attacks against Nigerians and other African nationals. Minister of State for Foreign Affairs, Sola Enikanolaiye, tuk dis one during a meeting with South Africa's Minister of International Relations and Cooperation, Ronald Lamola, for Abuja. Enikanolaiye say President Bola Tinubu direct di meeting because di attacks dey threaten di long-standing relationship between both countries. He also remind South Africa of Nigeria's role in di fight against […]

todayJuly 29, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds