Blog masonry

Background

Sports

Chelsea Suspend Enzo Fernandez Say Im Break Club Rules

Say like dis na, Enzo Fernandez no go play for Chelsea for di next two matches after im talk about im future. Dis na according to update by coachie Liam Rosenior for im pre match conference. According to Rosenoir, di club get ruled and Enzo don pass di line as make comment say im wan join Real Madrid. Di 25-year-old Argentine wey join Chelsea January 2023 for record £107 million, hint say im no sure if im go still dey […]

todayApril 3, 2026 18

obodo oyinbo

Iran Raise Alarm For Strait of Hormuz Security Vote Postponement

Iran don warn di UN Security Council say make dem nor do any “provocative action”, ahead of a scheduled vote wey dem wan take settle di wahala for strait of Hormuz. Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi na drop dis yarnings ahead of di Security Council suppose vote on draft resolution. Say di resolution na to hellep create force to secure di shipping lane wey dey vital to global energy supply. However, di planned vote dem later postpone am, and UN […]

todayApril 3, 2026 9

Lagos

Lagos CP Tijani Fatai Tight Security Wella Ahead Of Easter

For Lagos state police command, commissioner of police, Tijani Fatai don order massive deployment of officers across di state to make sure say pipo dey safe before, during, and after easter celebration. According to a statement released by police tuk tuk , Abimbola Adebisi, on Friday, say di police go station officers for churches, highways, parks, transport hubs and other important places to stop any wahala. Dat dem go also send marine police go riverine areas while traffic control arrangements […]

todayApril 3, 2026 9

OBODO NAIJA

Wike Confirm Say PDP Go Enter 2027 Election

Federal capital territory minister, Nyesom Wike don share update say Pipos Democratic Party go surely contest for 2027 general election, despite wetin pipo dey tuk say di party no get wait again. Im yarn dis one on Friday during one media meeting, wia im clear every, say PDP still dey strong even though say dem never produce president since 2015. According to Wike, di party need focus more on state and grassroots politics, no be only presidency, and build strong […]

todayApril 3, 2026 11

Politics

Umahi Urge South East Big Men To Support Bola Tinubu

Oga Minister of Work, David Umahi don tell im South East leaders say make dem come out with dia full chest support Bola Tinubu based on wetin di senior man don do for south east pipo. Im tuk dis one on Thursday for Enugu during di opening of completed part of di Enugu, Onitsha federal highway. Umahi come tell Hope Uzodimma to organise leaders for di zone make dem loudly support di president and spread di message. According to Umahi, […]

todayApril 3, 2026 3

Sports

Italy To Lose Euro 2032 Hosting based On bad Stadiums

Say like dis Italy fit lose their chance to co-hosting right of Euro 2032 if dem no fix their stadiums fast. According to UEFA president Aleksander Čeferin, Di country suppose host di tournament with Turkey, but bad infrastructure don put dem for serious doubt. Italy football federation get till October to present five stadiums wey go meet UEFA standard or dem fit lose di hosting rights.

todayApril 3, 2026 9

Sports

Former Arsenal Star, Gallas Name Di Cup Wey Arsenal Fit Win

Former Chelsea and Arsenal defender William Gallas tuk say di only trophy wey Arsenal fit win dis season na di Premier League. Dem bin dey try for quadruple, but dem lose Carabao Cup final to Manchester City. Now, Mikel Arteta side, dey fight for Premier League, FA Cup and Champions League. Gallas say e no believe say Arsenal fit win all three trophies dis season.

todayApril 3, 2026 3

Sports

Super Eagles To Face Poland, Portugal For Big June Friendlies

Say Nigeria go play Portugal and Poland for big international friendly games for June. Super Eagles, wey just beat Iran 2-1 and draw 2-2 with Jordan for Antalya, Turkey, don dey ready for dis summer programme against European teams. Dem go face Poland for PGE Narodowy Stadium, Warsaw on June 3, before waka go Portugal for second friendly on June 10. Portugal don also konfam say Nigeria go be dia last opponents before dem enter di 2026 FIFA World Cup […]

todayApril 3, 2026 3

Sports

NFF Finally Package Election Committee To Run Naija Football

Nigeria Football Federation (NFF) don inaugurate ogbonge Electoral Committee and Electoral Appeals Committee yesterday for their secretariat for Abuja. Dem pick 12 pipo for di two committees, as seven go serve for Electoral Committee while five go handle Electoral Appeals Committee work. Say na NFF president, Ibrahim Gusau, lead di inauguration  dey yarn after dem approve di committees during last week Extraordinary General Assembly say na to stabilize naija football.

todayApril 3, 2026 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app