Blog masonry

Background

Sports

Okoronkwo, Alozie, Kanu Don Join Super Falcons Camp for Morocco

By: Esther Daniel Esther Okoronkwo, Michelle Alozie and Uchenna Kanu don join Super Falcons camp for Casablanca, Morocco, as di team dey prepare for dia next competition. Di three players arrive on Monday, making di total number of players for camp reach 22. Howeva, Gift Monday, Deborah Abiodun and Folashade Ijamilusi still dey expect to join di team later today for Marriott Hotel, where di squad dey stay. Di Super Falcons begin dia final preparation since last week Monday as […]

todayJuly 21, 2026 26

OBODO NAIJA

CBN Admit Say Dem Open Dollar, Pound Accounts for Alleged Fake Presidency Council

By: Esther Daniel Di Central Bank of Nigeria (CBN) don confirm say e open two foreign currency account for presidential foreign investment promotion council(PFIPC) Di confirmation come on Monday during House of Representatives public hearing for Abuja. CBN tuk say dem open di accounts after dem receive instruction from di Office of di Accountant-General of di Federation. Meanwhile, Oga Tinubu Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, appear before ICPC to give statement as investigation into di alleged fake agency dey continue. […]

todayJuly 21, 2026 25

Lagos

Fire Burn 17 Shops for Sabo Market Ikorodu

By: Esther Daniel No fewer than 17 shops don burn as fire catch Sabo Market for Ikorodu, Lagos, around 1:10 early Tuesday morning. LASEMA tok say di fire start from one shop and spread go oda shops, na electrical surge na di likely cause of di fire. Emergency workers quickly quench di fire before e spread go oda parts of di market. Goods like provisions, groceries and foodstuffs burn finish, but no life loss or injury dey recorded.

todayJuly 21, 2026 17

Sports

Spain Don Climb Number One For FIFA World Ranking After World Cup Victory

By: Esther Daniel Spain don become di new number one team for FIFA Men's World Ranking after dem beat Argentina 1-0 for extra time to win di 2026 FIFA World Cup final for New Jersey. Ferran Torres score di winning goal for di 106th minute as La Roja carry dia second World Cup trophy. Because of di victory, Spain gather extra 121. 17 ranking points to reach 1,995.88 points. Di latest FIFA ranking wey come out on Monday, July 20, […]

todayJuly 20, 2026 23

National

Police Officers Cast Demsleves Go Collect Bribe Of N53,000 From ICPC Chairmo

By: Esther Daniel Four police officers don land for wahala after dem allegedly collect N53,000 from  Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission,  ICPC Chairmo, Dr Musa Aliyu, during illegal stop-and-search operation for Banex area of Wuse, Abuja. FCT Police Commissioner, Ahmed Sanusi, yarn on Monday say di officers abandon dia official duty posts, mount illegal checkpoint and no know say di man wey dem stop na ICPC oga. According to am, dem force Aliyu withdraw N53,000 through POS, […]

todayJuly 20, 2026 25

Lagos

Lagos Police start stage three of Operation Kòs’àyè

By: Esther Daniel Lagos State Police Command don officially start di third phase of Operation Kòs'àyè, wey mean "No Hiding Place for Criminals," to tighten security across di state. Police tuk, tuk, CSP Abimbola Adbisi, announce di operation on Monday during a briefing wit journalists for di Lagos State Task Force office for Bolade, Oshodi. According to di senior woman, Di operation na based on  di Inspector General of Police, Tunji Disu commad, to follow up jaguda boys doing for […]

todayJuly 20, 2026 25

Sports

Portable Challenge Terry G Make Dem Fight Boxing

By: Esther Daniel Nigerian singer, Portable, don challenge veteran artiste Terry G to one celebrity boxing match, say di fight go help bring Terry G name back inside di spotlight. Portable talk dis one during interview for tv sit down tuk, wia e say e prefer to fight fellow entertainers instead of social media personalities like VeryDarkMan and Carter Efe. Di singer also claim say na im start celebrity boxing for Nigeria and say e don make millions of naira […]

todayJuly 20, 2026 49

obodo oyinbo

Andy Burnham To Collect Swear As New Britain Prime Minister

By: Esther Daniel Andy Burnham don become Britain new Prime Minister today as e move enter 10 Downing Street, replacing Keir Starmer after Labour change leader. Burnham go try solve all di jogolos inside di UK, from economy to public services, as people dey expect quick results. After King Charles III ask am to form new gornment, Burnham go give im first speech outside 10 Downing Street. Burnham promise to change every every for the united kingdom gorment.

todayJuly 20, 2026 26

National

Ghost Agency Budget Mata Strolls Enter National Assembly

By: Esther Daniel Speaker of House of Representatives, Tajudeen Abbas, go today launch one special committee to investigate how dem take put N1.32 billion for Presidential Foreign Investment Promotion Council inside 2026 budget, even though di agency never dey legally. Di committee, wey Honourable Yusuf Gagdi dey lead, go hold public hearing for National Assembly Complex for Abuja. U sabi say, di  investigation start after police arrest Adeyemi Adeniyi, wey allegedly claim say na im be Director-General of the agency […]

todayJuly 20, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds