Blog masonry

Background

Lagos

LSSTF Begin Campaign Against Rising Yahoo Yahoo

By: Esther Daniel Lagos State Security Trust Fund don advise Lagos residents and Nigerians make dem protect dia digital identity as cyber fraud dey increase for di country. Lagos State Coordinator of LSSTF Campaign Against Crime, Cultism and Other Vices, Dr. Oladimeji Moses, yan dis one during one youtube interview  on Saturday. According to am, figures from di National Bureau of Statistics show say more than 119,000 data breaches naim don  happen for 2025, and na so yahoo dey increase […]

todayJuly 20, 2026 21

Lagos

Army Burst Illegal Bunkering Site For Lagos, Arrest Six

By: Esther Daniel Nigerian Army say troops from 65 Battalion don go gbab  six suspected illegal bunkerers, dat is oil thief thief  as dem dey fetch crude oil form di  site inside  Orile  area of Lagos State. According to the Army, dis one hapiun last week,  the operation hapun after dem receive correct intelligence about  dis oil thief thief. Say During the raid, soldiers recover four drums, including two wey contain suspected illegally refined fuel, plus one white Ford bus […]

todayJuly 20, 2026 16

Uncategorized

Marketers Pause Fuel Loading as Dangote Change Payment Style

By: Esther Daniel Some petroleum marketers don stop to load fuel from Dangote Refinery after reports say di refinery don begin sell fuel in dollars. Marketers say dem dey wait make Dangote explain di new price template before dem buy more fuel. But Dangote Refinery deny di claim, insist say fuel loading still dey happen as normal for di Lekki plant.

todayJuly 20, 2026 18

obodo oyinbo

Trump Knock Tuchel Over England World Cup Exit

By: Esther Daniel US President Donald Trump don condem England coach Thomas Tuchel over di team 2-1 loss to Argentina for di 2026 FIFA World Cup semi-final. Trump say Tuchel make big  mistake wey im move captain Harry Kane into a defensive role after England score first. According to am, di decision give Argentina chance to take over di game and score two late goals to qualify for di final against Spain. Before di  match, di White House don publicly […]

todayJuly 20, 2026 25 2

OBODO NAIJA

Atiku Knock 2026 Budget, Say E No Clear

By: Esther Daniel Former Vice President and ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don condem di 2026 Federal Budget, say e be big  attack on transparency and accountability for Nigeria democracy. For statement wey im media assist, Phrank Shaibu, release, Atiku tok say 84 percent of di entire budget dey inside just 10 Ministries, Departments and Agencies (MDAs), while ₦12.8 trillion dey under di Service-Wide Vote (SWV) for di Ministry of Budget and Economic Planning. According to am, the SWV jump […]

todayJuly 20, 2026 17

OBODO NAIJA

Makinde No Get Weight for 2027 Race – Bwala

By: Esther Daniel Daniel Bwala, Special Adviser to oga  Bola Tinubu on Policy Communication, don tok say Oyo State Govor Seyi Makinde and AAC presidential candidate Omoyele Sowore no get strong political weight ahead of 2027 election. For TV siddon tuk, Bwala tok say all di political calculations no dey favour Makinde, sti add say di Oyo State govo no fit even win presidential election for im own state. Bwala tok say if dem check di numbers and political strength, […]

todayJuly 20, 2026 18

Lagos

Two Firefighters Collapse as Fire Burn Ketu-Ikosi Building

Nor be small gbege as Two firefighters  land demsleves for hospital after dem collapse as dem  dey try fight fire wey burn di top floor of a three-storey residential building for Ketu-Ikosi, Lagos. Lagos State Emergency Management Agency tuk, tuk, Olawale Afolabi, konfamate dat dis fire hapun early mormor Sunday for No. 11, Ademola Taiwo Street. According to am, di fire hapun because of electric from prepaid meter inside one of di ejima buildings. Firefighters from LASEMA and Lagos State […]

todayJuly 20, 2026 71 1

OBODO NAIJA

Ogun State King Back Adebutu for 2027 Ogun Gofnorship Race

Senior man Alake and Paramount Ruler of Egbaland, Oba Adedotun Gbadebo, don publicly support PDP gofnorship candidate, Hon. Oladipupo Adebutu, ahead of di 2027 Ogun election. Oba Gbadebo give im support  when Adebutu and im campaign team visit di Egba Traditional Council to collect  royal Avian. Di monarch praise di Adebutu family, describing dem as people wey get long history of generosity and commitment to Egbaland development.

todayJuly 20, 2026 21

OBODO NAIJA

President Tinubu Call for Joint Action Against Afro-Phobia for South Africa

Wi oga Presido, Bola Tinubu don call on African leaders make dem join hand together to condemn di ongoing xenophobic attacks against Africans for South Africa. Im fry mouth inside di 69th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of State and Government for Sierra Leone, Tinubu wey Vice President Kashim Shettima represent, say one united voice go send strong message say intolerance no go dey accepted. Di President also press tuks say  Nigeria’s support for ECOWAS Compact for di […]

todayJuly 20, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds