Blog masonry

Background

Lagos

Sanwo-Olu Leak Sand For Beta Joinbodi Development For Lagos

By: Esther Ayoola Baba govo, Babajide Sanwo-Olu, don clear clear mata wey concern Lagos for 2026 say make Lagos residents nor worry demselves too much dat, 2026 go sengemege, say goment dey plan big projects for transport, agriculture, health, energy, environment and infrastructure. E tuk dis one on Sunday for di 26th Lagos State Annual Thanksgiving Service wey shelle for Tafawa Balewa Square, Lagos Island. Baba Sanwo Olu, say im goment go complete and commission all ongoing projects across di […]

todayJanuary 5, 2026 9 2

National

Kebbi Goment Open Town Schools Again After Bandit Wahala

By: Esther Ayoola Kebbi State goment don approve make some primary and secondary schools for big towns and cities resume immediately afta wetin jaguda boys use dia eyes see last year. U sabi say, dem bin close schools before, afta bandits attack Gorment Girls’ Comprehensive Secondary School for Maga town for November, wia dem kidnap 25 schoolgirls and kill one school guard. Commissioner for Basic and Secondary Education, Dr. Halimatu Bande, tuk say resumption go start today Monday, January 5, […]

todayJanuary 5, 2026 5 4

National

Kwankwaso Set Compass On How Im Wan Waka For 2027 Presidential Election

By: Esther Ayoola Oga national leader of New Nigeria People’s Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, say im nor be mumu oh, dat im go only waka go another party, if dem agree to give am presidential or vice-presidential ticket for 2027 election. U sabi say, Peter Obi join African Democratic Congress (ADC) last year and e go dey contest presidential ticket with Atiku Abubakar and Rotimi Amaechi, wey fit cause wahala inside party. Pipo dey also talk say Kwankwaso fit […]

todayJanuary 5, 2026 7

obodo oyinbo

US Wan Enter Colombia, Trump Say Colombia Presido Get Bad Character

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump like dis don turn attention to Colombia, say im no like Colombia Presido, Gustavo Petro. Dis one dey come afta world leaders send complain give am on why, U.S kramp Venezuela President Nicolas Maduro. For inside post for X, Trump tuk say goment for Colombia and Venezuela dey “sick,” and Petro dey do like person wey dey sell cocaine. Im still add am say, Cuba goment fit still join.

todayJanuary 5, 2026 5 6

Sports

Coach Chelle Explain Why Im Luck Super Eagles Training

By: Esther Ayoola Super Eagles coachie, Eric Chelle, don come clear im decision to close team training for three days before Nigeria play Mozambique for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16. Some Aproko pipo for Morocco bin dey vex say dem nor get access to di super eagles. In fact, Photojournalist Olawale Quadri bin tuk say, rain and catarrh wan bin finish journalists, sake of say dem wan do media parley with di team but Chelle no gree […]

todayJanuary 5, 2026 8

National

President Tinubu Order Security To Kramp Niger State Jaguda Boys

By Ebi Oboko Oga Presido, Bola Tinubu dey vex seriously don order im olopka, army, vigilante say make dem carry dia rake and fork enter the bushes of Niger state environs to gbab di jaguda boys wey attack communities for Niger State, kill over 40 pipo and kidnap plenty others. For statement wey im sign by imself on Sunday, Tinubu say im don send sms to wi Defence Minister, Service Chiefs, IGP and DSS boss to do james born track […]

todayJanuary 5, 2026 14 37

Sports

Cameroon Park South Africa Kaya Comot From AFCON, Beating Dem 2-1

By Ebi Oboko Junior Tchamadeu score first for 34th minute, and Christian Kofane add second goal two minutes after half-time, make Cameroon beat South Africa 2-1 for AFCON last-16. South Africa try fight back as Evidence Makgopa score late, but e no reach. Cameroon don enter  quarter-final, wia dem go face Morocco on Friday. Morocco sef beat Tanzania 1 kondo for dia round of 16 game just before the Cameroon game.

todayJanuary 5, 2026 16 17

Sports

EPL Result: Man City, Chelsea Play Draw Open Way for Arsenal

By Ebi Oboko E be like Arsenal don dey peel out with the EPL title beating Bournemouth 3-2, and with plenty wahala result yesterday. Leeds add salt to Ruben Amorim wunjury and Manchester United, drawing 1 1, Matheus Cunha ni score to save United one point. Everton lose 2 4 to Brentford as Igor Thiago run hat trick, while Beto and Barry score for Everton. Newcastle beat Crystal Palace 2 0 with Bruno Guimarães and Malick Thiaw goal, so like […]

todayJanuary 5, 2026 14 15

Business

Tins Wey You Need Sabi About Di Naija New Tax Law

By Ebi Oboko TO WHO E CONCERN – MAKE I JUST GIVE YOU DIS INFORMATE. QUESTIONS & ANSWERS ON DI NEW NIGERIA TAX LAW (Focus on Individuals and Small Businesses) 🟢 Q1: When Di  new Nigeria Tax Act go start work? A1: Di  new tax law go start from 1st January 2026. 🟢 Q2: Who dis tax law concern? A2: E concern everybody wey dey earn money for Nigeria – workers, content creators, remote workers, influencers, traders, etc. Even Nigerians […]

todayJanuary 5, 2026 27 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app