Blog masonry

Background

Sports

Diego ForlanĀ Take Over Uruguay Coaching Job After Bielsa Kawasaki

By : Yusuf Abuh Uruguay don appoint former striker Diego Forlan as interim coach of dia national team after Marcelo Bielsa comot following di team poor performance for di 2026 FIFA World Cup. Uruguay Football Association announce say Forlan go take charge after di two-time world champions fail to pass group stage. Bielsa tenure end after Uruguay finish third for dia group with just two points behind Spain, Cape Verde and Saudi Arabia. Forlan, wey be 47 years old, sign […]

todayJuly 13, 2026 19 6

Sport Yarns

Stanley Nwabali Return back to Chippa United for South Africa

By : Yusuf Abuh Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali don return to South African club Chippa United five months after e announce say e dey leave di team. Chippa United konfam say di Nigeria international don come back to Eastern Cape ahead of di new season. Di club say Nwabali experience, leadership and presence go bring more value to their squad. Di goalkeeper transfer plan wey make am leave di club before no work out, so e don rejoin Chippa […]

todayJuly 13, 2026 20

OBODO NAIJA

Soldiers Scata ISWAP Attack, Kpai Cameraman

By: Yusuf Abuh Troops of Operation Hadin Kai don go kpai plenty ISWAP terrorists after dem stop one attack for Cross Kauwa, Kukawa Local Government Area of Borno State. Military tuk say among di pipo wey die na one ISWAP cameraman, and diam idea tools. According to Acting Military Information Officer, Mohammed Goni, di terrorists try attack di troops position around 10:20 p.m. on July 11, but soldiers resist dem and show dem beta workings sya power pass power. Di […]

todayJuly 13, 2026 19

Lagos

Lagos Court Sentence 16 Offenders To Jail

By: Yusuf Abuh Lagos wast management pipo Ā don secure court conviction for 16 environmental offenders wey dem arrest for illegal waste dumping across Lagos. According to reports, Di Ā offenders appear before Oshodi Special Offences and Mobile Court and each receive four months jail sentence for offences including dumping waste for wrong places and refusing to use approved waste collectors. LAWMA Ā tuk, tuk, Mukaila Sanusi, konfam, say dem arrest di people during enforcement operations for areas like Gbagada Expressway, Anthony Oke, […]

todayJuly 13, 2026 20

south west

Oyo State Gornment tTo Release Orire Kidnap Victims To Families On Monday

By: Yusuf Abuh After 56 days for kidnappers camp, di rescued victims now dey recover for Army hospital for Ibadan, an say by di end of today dem go reunite with dia families. Baba Govo, Seyi Makinde talk say doctors go monitor dem for 48 hours before di military hand dem over to Oyo State Government. Im say gornment don begin arrangements to reunite dem with dia families as soon as dem complete medical checks. Makinde also reveal say some […]

todayJuly 13, 2026 27

Sports

Sinner Defeat Zverev

By: Yusuf Abuh Jannik Sinner don defend im Wimbledon title after e beat Alexander Zverev for one tough four-set final match on Sunday. The world number one lose di first set but come back strong to win 6-7, 7-6, 6-3, 6-4 and lift di trophy again. Sinner use beta serving and powerful shots to wear down Zverev, wey enter di final with 13-match winning streak for Grand Slam games. Di Italian tennis star don now win five Grand Slam titles […]

todayJuly 13, 2026 23

obodo oyinbo

Iran Guards Close Down Hormuz Strait Till Further Notice

By: Yusuf Abuh Iran Revolutionary Guards don announce say Strait of Hormuz go remain closed until further notice after dem fire warning shots inside one vessel wey dodge enter di area. Di Guards say di ship ignore several instructions to use approved shipping corridor before dem stop am. According to aproko pipo, dis development fit make US-Iran kpokpo demselves again as both sides dey face tension after recent attacks and threats.

todayJuly 13, 2026 23

OBODO NAIJA

FG Push NIMC To Register Every Nigerian For National Identity

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don direct National Identity Management Commission (NIMC) make dem register every Nigerian for national identity database before di end of 2026. NIMC Director-General, Abisoye Coker-Odusote, talk dis one during interview for TV sit down tuk on Sunday. She say di plan na to help gornment get beta national identity system wey go improve planning, governance and service delivery. Coker-Odusote add say NIMC dey work with partners under World Bank-supported ID4D project to […]

todayJuly 13, 2026 17

OBODO NAIJA

Oluremi Tinubu Lunch Food Bank

By: Yusuf Abuh Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, A.k.a Iya kuli kuli, A.k.a Iya Alakara, A.k.a nawa mama be dis don go throw beta salutate give Kogi State Govo, Ahmed Usman Ododo for di beta National Community Food Bank wey im build for Lokoja, to stop kpaturekor doings. Di senior woman first lady, porporly dis mata during, on ogbonge visit to inspect diĀ  project. She talk say di modern facility go help fight hunger and malnutrition, especially for women, […]

todayJuly 13, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds