Blog masonry

Background

National

IGP Olatunji Disu Visit Blast Victims, Tighten Security For Maiduguri

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don visit di victims of di recent bomb blast for Maiduguri wey dey hospital, come check di Monday Market bomb site. Im still waka go Borno State Gornment House and Police Command to see how security dey and plan beta joint action. IGP Disu tuk say im dey feel for di victims and dia family, and dat police go do everything to catch di jaguda boys wey dey do di thing. E […]

todayMarch 18, 2026 31

National

VP Shettima Condemn Maiduguri Blast Wey Kpai 25, Pray For Di Families

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don mourn di 25 people wey kpai for di explosions wey happen for different areas for Maiduguri, Borno State on Monday. VP Shettima, tuk dis tuk on Tuesday during di closing of di Annual Ramadan for State House Mosque, Abuja, E sha pray make Almighty Allah give di dead pipo peaceful rest for Aljannah firdaus and give dia family strength to survive di lose.

todayMarch 18, 2026 13

National

Vice Presido Shettima Hail Soludo For Unity, Development, And Nation Progress

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don praise Anambra State Govo Chukwuma Soludo for im work for Anambra. Shettima yarn dis while e dey represent Presido Bola Tinubu for di inauguration and swearing-in of Soludo and him deputy, Dr Onyekachukwu Ibezim, for Awka, di state capital. According to Shettima, Soludo dey show national interest pass partisan politics, and im leadership dey unify pipo and make progress without wahala.

todayMarch 18, 2026 15

National

President Tinubu Order All Appointees Wey Wan Contest 2027 Election To Exit Im Gorment

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don order, say make all im political appointees wey wan run for any election for 2027 resign from dia work before March 31. Head of Information for OSGF, Dewan Goshit, naim announce dis news on Tuesday. Baba Seyi say, dis follow Section 88(1) of di Electoral Act 2026 and di INEC timetable for party primaries. Dis order dey affect all presidential appointees wey dey try enter party primaries or seek nomination […]

todayMarch 18, 2026 12

National

President Tinubu Land London For Historic State Visit

By; Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu, wey dey go do historic state visit, don land London, United Kingdom with im wife, Oluremi Tinubu. According to president tuk, tuk, Bayo Onanuga dem touch London Stansted Airport for 3:18 pm on Tuesday. Tinubu meet Mark Bevan, Deputy Lieutenant of Essex, plus Naija acting High Commissioner Ambassador Mohammed Maidugu and other big oga dem. For di visit, King Charles III and Queen Camilla go host Tinubu and im wife for Windsor Castle […]

todayMarch 18, 2026 16

National

Keyamo Admit Say Na Because Akure Airport Fence Weak Ni Make Jaguda Boys Enter

By: Esther Ayoola Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, tuk on Tuesday for radio, Ilese-Ijebu, Ogun State, say na one weak link for back of Akure Airport, Ondo State naim allow jaguda boys enter di airport do nonsense. Di Minister say all airports for di obodo Naija sha get dia safety packages, travellers nor suppose fear, but wetin hapun dat day for Akure airport na di weak link cause am. Keyamo also admit say FAAN and Ondo State […]

todayMarch 18, 2026 9

Lagos

LASODA Give 50 Disabled Workers Tools To Boost Work Productivity For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Office for Disability Affairs (LASODA) don do give away to 50 physically challenged workers for different ministries, give dem beta working tools and technology to make dia work easier. General Manager, Adenike Oyetunde-Lawal tuk for di programme, wey dem call “Enhancing Productivity: Supporting Civil Servants with Disabilities,” say, na part of effort to boost work efficiency. According to di LASODA General Manager, di programme na to make civil servants with disabilities more productive and effective […]

todayMarch 18, 2026 8

Lagos

Naija Secure £746 Million From UK To Upgrade Apapa, Tin Can Ports

By: Esther Ayoola Federal gornment say dem don get ogbonge support of £746 million financing from UK wey go hellep upgrade Naija ports. Minister of Marine and Blue Economy, Dr. Adegboyega Oyetola, yan dis one for Abuja, say dis money go transform Apapa Port and Tin Can Island Port for Lagos, di main ports wey dey handle more than 70% of Naija trade. Say di financing agreement, dem go officially sign am, wen President Bola Ahmed Tinubu enter im meetings […]

todayMarch 18, 2026 11

Lagos

Wike PDP Committee Hold Lagos Congress, Pick New Leaders

By: Esther Ayoola Say like dis, di Nyesom Wike-led Pipos Democratic Party National Caretaker Committee don hold congress for Lagos State on March 17, 2026, to elect new state executive members. Di party’s National Deputy Secretary, Adedeji Doherty, say delegates from all 20 local government areas and 37 local council development areas join dis particular exercise for Lagos. According report dis dey come because di Court of Appeal cancelling di Ibadan convention wey produce old state executive two weeks ago. […]

todayMarch 18, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds