Blog masonry

Background

Lagos

Govenor Sanwo Olu Promise To Take Fake Goods

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don promise say dem go improve on consumer protection because of plenty bad goods and services wey dey enter di Lagos market. Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu tuk dis one yesterday for World Consumer Rights Day wey dem dey call “Safe Products, Confident Consumers.” E press tuk say pipo dey lose billions of naira every year from fake medicine, defective goods, and misleading adverts. Sanwo-Olu, wey Attorney General Lawal Pedro represent, say, di biggest problem […]

todayMarch 18, 2026 15

National

Ondo Police, FAAN Disagree Over Who Dem Arrest For Akure Airport

Ondo State Police Command don disagree with Federal Airport Authority of Nigeria (FAAN) over di pipo wey dem arrest for Akure Airport on Sunday. Di Police tuk say di people wey dem arrest no be bandits, na ordinary criminals, and dem want make FAAN no misrepresent di case. Managing Director of FAAN, Olubunmi Kuku,  bin konfamate dat dem gbab four suspected bandits for Ondo airport. Say dem don alert di CP, di army, di MAC, and AVSEC pipo, dey all […]

todayMarch 17, 2026 17

National

Oyo State Gorment Tell Resident To Avoid Streams With Dia Waste

By: Esther Ayoola Oyo State Gornment don warn residents make dem stop open defecation and di way pipo dey dump waste anyhow for streams and waterways, say e fit weaken efforts to control erosion. Commissioner for Environment and Natural Resources, Ademola Aderinto, give di warning on Monday afta dem finish final inspection of some project sites under di Naija Erosion and Watershed Management Project supported by European Investment Bank. Places wey dem visit include Aborerin Stream for Eruwa, Fedomu Stream […]

todayMarch 17, 2026 11

National

FG Arrange Plan To Evacuate Nigerians From Middle East

By: Esther Ayoola Federal gornment say, dem dey arrange how to evacuate Nigerians wey dey trapped for some Middle East countries because of di ongoing crisis. Nor be amebo say di tension for di region rise afta United States and Israel carry out military strike against Iran on February 28. Tuk, tuk of di Ministry of Foreign Affairs, Kimiebi Ebienfa, say gornment dey work on administrative arrangements and release of money to start di evacuation. Dis update dey come afta […]

todayMarch 17, 2026 9

National

Wike Insist, Say Security Agencies Gallant On Top Banditry Issue For Abuja

By: Esther Ayoola Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don dismiss claims say banditry dey hapun frequently for Abuja. Wike tuk dis one during inspection of ongoing projects for di capital say im security agencies stand fit for crime. E admit say crime fit hapun anywhere for di world but insist say reports about banditry for Abuja say na bad belle pipo dey yan okpata.  

todayMarch 17, 2026 19

National

22 Passengers Wunjor As Train For Abuja–Kaduna Head Shake For Im Corridor

By: Esther Ayoola Say at least 22 passengers wunjor afta train wey from Abuja dey go Kaduna head shake for im corridor, forcing di train to stop and delay di journey. According to report About 429 passengers and 70 crew members bin dey inside di train when di incident hapun. Managing Director of Nigerian Railway Corporation, Kayode Opeifa, konfamate di number of pipo wey wunjor when im visit di corridor Opeifa tell journalists for Kaduna say di rail line still […]

todayMarch 17, 2026 8

National

Bomb Explosions Shake Maiduguri Afta Suspected Boko Haram Attack

By: Esther Ayoola Say nor be small tin hapun for Maiduguri dat bomb explosions hit di town on Monday evening, one for Monday Market and another near University of Maiduguri Teaching Hospital. According to report di bombs blast around 7:02 pm, hours afta suspected Boko Haram terrorists launch different attacks on three military positions across di state. Konfaming di report, Head of Operations of di Federal Fire Service, Borno branch, Mohammed Kafaran, say Federal Fire Service ni go assess di […]

todayMarch 17, 2026 12

National

Judge Vex, Tell Sowore Lawyer Make E Kneel For Court

By: Esther Ayoola Justice Mohammed Umar for Federal High Court Abuja omo cut chain on Monday for Omoyele Sowore lawyer, Marshall Abubakar, for court because say e tuk anyhow for court. Judge even tell am make e comot come kneel down for front of everybody. Say Abubakar raise hin voice for court say, date wey dem fix nor favour, di tin vex judge. Other lawyers con manage calm di judge down, while Sowore dey face case from DSS for say […]

todayMarch 17, 2026 16

obodo oyinbo

UK Gorment Dey Do Give Away With £53m To Hellep Poor For Iran War

By: Esther Ayoola Say like dis British Gornment dey do give away of £53 million to hellep pipo to manage demselves as oil price rise. U sabi say prices of tins rise because of di wahala wey dey go on for di Middle East. Prime Minister Keir Starmer say di money go mainly reach low-income pipo wey dey rural area wey dey use heating oil. Unlike gas and electricity wey Ofgem dey control, heating oil price dey  rise wetin nor […]

todayMarch 17, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds