Blog masonry

Background

Sport Yarns

FIFA Boss Infantino Face Media to address world cup Ticket Prices

By : Jolayemi Olajide FIFA Presido, Gianni Infantino go face journalists inside Mexico City on Wednesday because of high ticket price and immigration drama wey dey disturb World Cup start. Di football chief dey fry mouth to clear di US security blocking one top referee, fans, and officials not to enter dia country for di tournament. Infantino set dis urgent press tuk as co-host Mexico prepare to face South Africa on Thursday for the opening match inside Estadio Azteca.  

todayJune 10, 2026 14

south west

Gunmen Kidnap Ifedayo Local Government Vice Chairmo For Osun

By : Jolayemi Olajide Problem dem say e nor dey finish, dad some jaguda boys don sti go kidnap the Vice Chairmo of Ifedayo Local Government Area, Debo Farounbi, attacking Ora community along Osun and Kwara boundary on Tuesday night. Di bad boys storm di area around 10pm, scata bullet for air, cause serious fear before dem bundle the chairmo and three other pipo face bush. According to tatafo pipo, say na Military men and local rugged mehn naim rascal […]

todayJune 10, 2026 26

OBODO NAIJA

Northern Elders cut chain For Tinubu, say make im do state of emergency

By : Jolayemi Olajide Northern elders under NEF banner don cut chain dey drag we oga Presido, Bola Tinubu body say make im declare national security emergency before everyia scarra. Di group tuk, tuk, Abubakar Jiddere, naim drop one hot statement about security mata for inside country, say e red. According to Abubakar everybody dey shake because wetin dis jaguda boys dey do. NEF make am clear say no country fit boast of any beta progress when communities dey under […]

todayJune 10, 2026 26

Sport Yarns

Omar Artan Return Mogadishu For Hero Welcome, Vow 2030 Come Back

By : Shalom Ovie Somali referee, Omar Artan, wey United States deny entry for World Cup duty, don come back Mogadishu for hero welcome on Wednesday as supporters gader for airport wave flag greet am. Artan tuk say e no go give up, promise say e go still participate for 2030 World Cup despite the rejection. di referee land for Mogadishu main airport through Turkish Airlines flight, where more than 100 fans celebrate am for VIP section.  

todayJune 10, 2026 27

obodo oyinbo

Gunmen Kpai 12 For south africa, Police Launch Investigation

By : Shalom Ovie Nor be small jogolo for south Africa, say Twelve pipo don kpai after gunmen attack one small community, midnight on Tuesday. Police say about 10 attackers naim run dis package, enter  different sides and begin shoot residents ratata for different locations. Police tuk tuk woman, Colonel Dimakatso Nevhuhulwi,  say di suspects escape, while investigators begin touch light  wetin really play for di area.

todayJune 10, 2026 20

OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo Go Corner dey Demand N5bn

By : Shalom Ovie Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for public. According to tatafo, Kenneth go tv sit down tuk use yamchop call di former Anambra state govo bad name, dat im nor  be beta leader, […]

todayJune 10, 2026 26

south west

Osun Police gbab 3 Suspected Cultists, jaguda boys, Recover Pistols

By : Shalom Ovie Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state. For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez. Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live ammunition, cartridges, cutlasses and axes. di command add say investigation […]

todayJune 10, 2026 20

OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Blow Whistle On Top Peter Obi Head

Popular Nollywoord Actor, Kenneth Okonkwo don come out clear marras say, he get duty to report any crime against di state wey come to him knowledge and that South-East pipo don too suffer. He yarn dis one for him X social media page on Wednesday say, no person suppose still dey take dem or any Nigerian citizen play or carry out wayo wayo without challenge. He say, Obunike na just one among many others wey dem allegedly scam through NDC […]

todayJune 10, 2026 32 2

Economics

IMF Raise Alarm Say Nigeria External Debt Fit Reach $72.6bn Before 2027 Election

International Monetary Fund (IMF) don warn say Nigeria public external debt fit jump by over $20 billion reach $72.6 billion by 2027. Dem talk say election year spending pressure fit make borrowing even worse. For dia 2026 Article IV report wey dem release on Tuesday, IMF show say Nigeria external debt go rise from $51.9bn for 2025, go $66.5bn for 2026, before e finally reach $72.6bn for 2027, that one na almost 40% increase inside two years. IMF talk say […]

todayJune 10, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds