Blog masonry

Background

south east

Ebonyi Police Catch Man Wey Try Burn PoS Lady to Steal Money

By: Alice Iduh Ebonyi state police command don gbab one jaguda boi after e attack one female PoS operator for Abakaliki, the state capital, say im pour fuel con try burn am to carry her money bag. Ebonyi Police tuk tuk, SP Joshua Ukandu naim de  confimate say dem catch di suspect on Friday before e fit dash away with di bag. Police quickly rescue di woman and collect back all her money wey e wan steal. Di whole wahala […]

todayDecember 5, 2025 11

Niger Delta

Delta Police Yan No Fire Fireworks This Yuletide, Zero Tolerance

By: Alice Iduh Delta State Police don yan say di long-time ban wey dey stop fireworks still dey gidigba as Christmas and New Year dey near, and dem no go tolerate anybody wey try break am. CP Olufemi Abaniwonda, through PPRO SP Bright Edafe, talk say di clampdown go cover di use, sell, storage, and public show of all pyrotechnics, including knock-outs and bangers. Di police talk say dem dey do am to stop criminals wey fit use fireworks cover […]

todayDecember 5, 2025 10

Niger Delta

Amaewhule Join 15 Lawmakers Waka Comot From PDP

By: Alice Iduh Speaker of the rivers state house of assembly, Amaewhule Martins don waka comot from PDP join 15 oda members of di House of Assembly on Friday, as di session dey go on. Dem talk say di wahala inside PDP na why dem gatz japa comot from di party. Among di big names wey join di waka na Deputy Speaker Dumle Maol, Major Jack, Linda Stewart, Franklin Nwabochi, Azeru Opara, Smart Adoki, Enemi George, Solomon Wami, and di […]

todayDecember 5, 2025 6

south west

Supreme Court Don Shut Osun Ag Mouth Over Local Govt Money Wahala

By: Alice Iduh Supreme Court don cancel Osun State Attorney General, Oluwole Jimi-Bada, case, wey him file against  AGF, Lateef Fagbemi, over di local government funds wey dem dey hold. court talk say na only di people wey win election and don take office fit sue or get sued. Justice Mohammed Idris talk say di Federal Government dey wrong to hold di local government money, say e dey breach 1999 Constitution. Di decision come Thursday, wen six justices side di […]

todayDecember 5, 2025 25

south west

Oyo Man Fall Inside Well, Fire Service Drag Body Out

By: Alice Iduh Oyo State Fire Service don recover body of one 65-year-old man wey fall inside deep well for Oke-Oga Atipe, Idi-Aga, Ibadan. Di wahala happen Thursday, December 4, 2025, wen one Mr Damola call di fire service at exactly 9:42 a.m. report say man don waka enter di well. Fire officers, wey Assistant Chief Fire Superintendent Bamidele Samsudeen lead, rush go di scene, but sadly, dem only fit drag di man body comot. Dem hand di body over […]

todayDecember 5, 2025 7

National

Tinubu 65 Ambassadorial Nominees Brace For Senate Grilling

By: Rilwan Agbomeji Next week, wi Presido Bola Ahmed Tinubu 65 ambassadorial nominees go siddon for front of lawmakers for grilling, to know whether dem dey qualify or not. Three opposition senators wey yarn under cover don drop warning say dis screening no be cruise, na only people wey get brain, backbone and clean name go escape, because foreign mission work no be job for smallie dem. For Thursday main sitting, Senate Presido Godswill Akpabio open Tinubu heavy list of […]

todayDecember 5, 2025 25

Business

FG Go Pay Road Contractors Owed Money Before December 20

By: Esther Ayoola Tori don land, Federal Government don rush cool road contractors wey don dey protest over unpaid money, promise say all outstanding payments go land before December 20, 2025. Minister of Works, David Umahi, yarn dis one during reopening of Keffi Flyover for Nasarawa State, add say President Bola Tinubu don sabi di debt wahala and don approve special committee to check and clear all owed funds. Contractors don show mad anger, dey stage protests at Ministry of […]

todayDecember 5, 2025 7

Entertainment

Imisi BBNaija Don Land: Ebute Metta Stand Still for Homecoming Showdown

By: Esther Ayoola Today, Imisi Ayanwale  di winner of tv reality show,   dey return to her Ebute Metta hometown for big  welcome party as fans gather make dem hail her home. She  win full N150 million grand prize back on October 5, 2025, and since then everybody don dey follow her matter with bumper to bumper.! As part of di plan, she don invite big names for entertainment from Bolaji Ogunmola to Wanni & Handi, Peller, Kolawole Ajeyemi, Spyro, Samuel […]

todayDecember 5, 2025 19

Lagos

Lagos Go Buy 100 New Trucks to Keep City Clean

By: Esther Ayoola Lagos State Gorment don yarn say dem go buy 100 new CNG compactor trucks next year as part of 10-year plan to make city clean. LAWMA Managing Director, Muyiwa Gbadegesin, talk say dem go dey add 200–250 new trucks every year until dem reach 2,000 1,000 for daily work, 1,000 for backup. E add say dis long-term plan go join state-wide household billing system, wey go help manage sanitation better. Na so Lagos dey ginger to stay […]

todayDecember 5, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app