Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Man Chop 24 Months Jail For Cocaine And Igbo Selling

By: Esther Ayoola Oneman wey dem call Olalowo Olatunji, wey be 44 years old, don collect 24 months jail sentence for Federal High Court wey dey Lagos. Justice Ambrose Lewis-Allagoa give di judgement afta di man admit say im guilty for two-count charge wey NDLEA bring come court. NDLEA tuk say dem arrest am on March 8, 2026 for Victoria Island as e dey sell 89 grams of cocaine and 20 grams of Indian hemp. Di prosecutor, Peter Ekuri, tell […]

todayMay 20, 2026 21

Lagos

Lagos Gornment Ban Heavy Load For Danfo

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don announce ban on movement of goods and heavy luggage for danfo across di state. Na di Lagos Metropolitan Area Transport Authority dey tuk dis one for statement wey dia Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi, release on Tuesday. Dem say di enforcement go start from June 1, 2026, and e go affect buses wey dey carry passengers for public transport system. Dem explain say di decision na based on say some pipo dey […]

todayMay 20, 2026 21

Lagos

Sanwo-Olu Open Big Data Centre For Lekki, Call Lagos Di Headmaster City Of Tech

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don declare say Lagos na di number one Africa digital economy, dat investment for technology and infrastructure dey cry. E tuk dis one during di inauguration of Kasi Tec Data Centre Campus for Lekki on Tuesday. Di governor say di new facility go hellep boost Naija digital infrastructure and support economic growth. Sanwo Olu sti call on foreign investors make dem come invest for Lagos, say di state get good environment wey […]

todayMay 20, 2026 26

Sport Yarns

Super Eagles To Jam Guinea-Bissau, Tanzania, Madagascar for AFCON 2027 Qualifiers

By : Jolayemi Olajide Nigeria don land for Group L as dem go face Guinea-Bissau, Tanzania and Madagascar for 2027 AFCON qualifiers. Di draw happen for Cairo, Egypt on Tuesday, and Super Eagles fans don begin expect tough matches. Nigeria don meet Guinea-Bissau plenty times before, including 2021 and 2023 AFCON competitions, while dem beat Tanzania 2-1 for 2025 AFCON. Super Eagles now go battle to secure one of the tickets for Africa biggest football tournament.

todayMay 19, 2026 29

obodo oyinbo

By : Jolayemi Olajide World Health Organization officials on Tuesday don warn say Ebola outbreak for north-eastern DR Congo dey spread faster than dem first think. Dr Anne Ancia of WHO tell newsmen say as dem dey investigate more, dem dey discover fresh cases for different areas around Ituri province, wey be di centre of di outbreak. Residents for di area talk say na so pipo dey die, die anyhow, say so far, di deadly virus don already kpai 131 […]

todayMay 19, 2026 17

OBODO NAIJA

Jonathan Hail Gowon, Say Him Policies Still Dey Help Nigeria

By : Jolayemi Olajide Former Presido, Goodluck Jonathan don praise former Head of State Yakubu Gowon, say many policies wey im bring during him time still dey help Nigeria till today. Jonathan talk dis one for Abuja during the launch of Gowon autobiography titled “My Life of Duty and Allegiance.” Im say Gowon show strong leadership as young leader during Nigeria civil war and still stand for unity with him “No victor, no vanquished” message. Jonathan also hail Gowon for […]

todayMay 19, 2026 25

Uncategorized

Desmond Elliot Deny Hand For Obasa Impeachment Mata 

By : Jolayemi Olajide Water don pass garri, na now stroy dey come out, lagos lawmaker, Desmond Elliot don clear mata say, nor be im plan di removal Speaker Mudashiru Obasa for Lagos Assembly for 2025. Di senior man Surulere constituency 1 rep clear dis mata for tv sit down tuk on Tuesday for lagos Di lawmaker tuk say when dem impeach Obasa, im no dey Nigeria at all. According to am, na only after e come back and see […]

todayMay 19, 2026 24

Sport Yarns

Super Eagles to Know Dia 2027 AFCON Qualifier Opponents Tuesday

By : Jolayemi Olajide Say Three-time African champions Super Eagles go know dia opponents for the 2027 AFCON qualifiers on Tuesday as Confederation of African Football dey prepare to do di official draw for Cairo, Egypt. The tournament wey dem tag AFCON PAMOJA 2027 go hapun from June 19 to July 17, 2027, and na the first time three countries, Kenya, Tanzania and Uganda, go host am together. Nigeria don win the competition three times before for 1980, 1994 and […]

todayMay 19, 2026 14

OBODO NAIJA

EFCC Gbab former Power Minister Saleh Mamman for Kaduna

By : Jolayemi Olajide Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don arrest former Minister of Power, Saleh Mamman, after Federal High Court for Abuja convict and sentence am say im collobi public funds. According to reports, EFCC Chairmo, Ola Olukoyede, konfam say di arrest happen around 3:30am on Tuesday. Olukoyede talk say operatives pick up Mamman for Kaduna, wia dem also arrest two oda pipo wey allegedly dey protect am. Di arrest come as anti-graft agency continue efforts to […]

todayMay 19, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds