Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Presidency laugh Obi say im promise to rule for One Term

By : Jolayemi Olajide Normally election time na time for promises and na so NDC popular candidate Peter Obi take go promises say im na one term e run if Naija make am president. Im yarn dis one on wednesday for interview, day never break reactions don dey trail di mata. According to Presidency, through Special Adviser to di President on Information and Strategy Bayo Onanuga, on Thursday for X, say Obi political history no show consistency or trustworthiness. Onanuga […]

todayMay 14, 2026 23

Sport Yarns

Foden Warn Arsenal Say Many Things Fit Happen For Final Day

By : Jolayemi Olajide Manchester City star boy, Phil Foden don yarn warning give Arsenal say Premier League title race fit still go down to final match day before e clear. Foden yarn dis one with Sky Sports after dem beat Crystal Palace 3 Kondo, on Wednesday night. E yarn say, di aim na to keep pushing and to mount pressure on top Arsenal head.

todayMay 14, 2026 23

obodo oyinbo

Xi Jinping Warn Trump Say Taiwan Matter Fit Cause Serious Wahala

By : Jolayemi Olajide Chinese Presido, Xi Jinping don warn US Presdio, Donald Trump say Taiwan matter fit scatter dia relationship go war level if dem no handle am well. Xi talk dis one for high-level meeting wey happen for Beijing on Thursday, where both leaders meet for more than two hours for Great Hall of di  People. According to Chinese foreign ministry, Xi tell Trump say Taiwan na di most sensitive matter between both countries, and say if dem […]

todayMay 14, 2026 16

OBODO NAIJA

APC Talk Say Dia 2027 Primary Election Dates Still Stand, Nothing Don Change

By: Jolayemi Olajide All Progressives Congress don clear air say dem never change dia timetable for 2027 primary election, as dem talk say all di dates wey dem announce before still stand gidigba. For statement wey party spokesman, Felix Morka sign on Wednesday night, APC talk say, House of Reps primary go hold on Friday, May 15, 2026, Senate primary go hold on Monday, May 18, 2026. State House of Assembly primary go happen on Wednesday, May 20, 2026, Governorship […]

todayMay 14, 2026 13

OBODO NAIJA

Police Assure INEC Say Dem Go Provide Maximum Security For Lagos

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police Command don assure say dem go join body with Independent National Electoral Commission (INEC)  ahead of  di 2027 general election, to make sure say gbege no burst for Lagos at all at all. For statement wey police tuk tuk pesin, SP Abimbola Adebisi drop on Wednesday, after INEC officials pay courtesy visit for police headquarters for Ikeja. Lagos State Resident Electoral Commissioner, Abayomi Salami wey lead di visit, hail CP Tijani Fatai for […]

todayMay 14, 2026 24

OBODO NAIJA

Justice Crack Bail Hearing jam rock say Lawyers dey fight for who go Lead

By : Jolayemi Olajide Di bail hearing of Nigerian activist, Justice Chidiebere, popularly known as Justice Crack, on Thursday say im village pipo follow am enter Federal High Court Abuja, na so lawyers dey fight, dey fight na me go tuk, na me go tuk. To di point dat everybody con confuse whether na show of love abi na village pipo performance, na judge pulse di hearing adjourn mata till Monday, May 18, for fresh application hearing. One of im […]

todayMay 14, 2026 29 2

OBODO NAIJA

Nigerian-Born Professor Rent Flat for Jail  for  US Over $1.4m Fraud Case

By : Jolayemi Olajide A United States federal court don sentence Nigerian-born former nonprofit CEO, Dr Nkechy Ezeh, to 70 months imprisonment for $1.4 million fraud wey involve mismanagement of taxpayer and donor funds meant for vulnerable preschool children. Di sentence come from Chief US District Judge Hala Y. Jarbou for Western District of Michigan, who also add separate 60-month term for tax evasion and order restitution payments. According to US Attorney Office for Western District of Michigan, di case […]

todayMay 14, 2026 25

Sports

Arne Slot Konfama Say Naim Go Sti Run Matas As Liverpool Coachie Next Season

By : Jolayemi Olajide Liverpool coachie, Arne Slot, don clear air say naim go sti run parrol for Liverpool F.C. next season as dem dey prepare for 2026/27 campaign. As football journalist Fabrizio Romano report on Thursday through X, Slot tok say plans for next season don already set, and di club already don dey discuss which player dem go sign. Di Liverpool coachie talk say im dey fully involved for di transfer discussions as di club dey find ways […]

todayMay 14, 2026 27

OBODO NAIJA

Dangote Reject NNPCL Plan to Increase Refinery Ownership As Fuel Supply Boom

By : Jolayemi Olajide Dangote Reject NNPCL Bid To Increase Stake for Refinery as Fuel Supply RiseBaba Presido of Dangote Group, Aliko Dangote, don reveal say dem reject request from Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) to increase dia 7.25 percent stake for Dangote Petroleum Refinery Im yarn dis one during one interview wey happen on Wednesday with news pipo. Di billionaire businessman say im company nor dey change ownership patterns, even as di $20 billion refinery for Lekki, Lagos […]

todayMay 14, 2026 29

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds