Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Ooni Of Ife Tell Students to take advantage of NELFUND Loan

By : Jolayemi Olajide Di Ooni of Ife, Adeyeye Ogunwusi don advise students make dem take advantage of Nigerian Education Loan Fund to hellep pay dia school fees Im tukĀ  dis one for im palace for Ile-Ife on Monday when dem receive Executive Director of Finance and Administration of NELFUND, Dr Femi Akinfala. Ooni show concern say plenty eligible students for Osun State never still apply for di loan opportunity. Im still commend Federal Gornment for di initiative, say e […]

todayMay 12, 2026 22

Lagos

Court Throway Alaba Traders Case, Say Police Get Right To Do Investigation

By: Jolayemi Olajide A Lagos State High Court for Ikeja don throw away case wey two traders for Alaba International Market carry enter court, say Police no break dia fundamental rights. Justice Ismail Ijelu tuk say Nigeria Police Force get di power to invite anybody to come answer question for ongoing investigation. Di traders, Uchechukwu Chukwuma wey people sabi as ā€œMayorā€ and Alexander Jonah, bin accuse police say dem dey harass dem and dey threaten to arrest dem. But court […]

todayMay 12, 2026 24

Lagos

Lagos Gorment to Ā Launch Special Driver’s License for Lagosians

By : Jolayemi Olajide Lagos State gornmentĀ  say like dis, wan launch dia own driver’s license in collabo with Federal Gornment to improve road safety and order for Lagos traffic. Commissioner for Transportation Oluwaseun Osiyemi naim yarn dis one on Monday inside im ministerial briefing for Alausa, Ikeja. Saying dat,Ā Ā  dem go launch di state-owned license in few weeks. Cue in sound He still add say Federal Executive Council don approve funding for phase one of Green Line rail project […]

todayMay 12, 2026 26

OBODO NAIJA

Tinubu Appoint Retired Major General Famadewa As First-Ever Special Adviser On Homeland Security

By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido President Bola Tinubu don give retired Major General Adeyinka Famadewa new position say make e work as Special Adviser on Homeland Security. Say dis na di first time Nigeria dey create dis kain position for federal level. Dem drop the announcement on Monday through office of SGF George Akume. Gornment talk say the new office go help security pipo to reason together, share beta intel, and tackle all di security gbege wey dey […]

todayMay 11, 2026 51 2

Sport Yarns

FIFA Select 11 Man Team to Analyse Players and Teams For Award For 2026 World Cup

By : Jolayemi Olajide FIFA don announce 11-member Technical Study Group wey go analyse matches and decide winners of major individual awards for di 2026 World Cup. Dem unveil di panel on Monday during virtual media briefing ahead of di tournament wey go start next month for Estadio Azteca. Di group go dey led by FIFA Senior Football Expert, Pascal Zuberbühler, and e include big football names like Pablo Zabaleta, Jürgen Klinsmann, Michael O’Neill, Otto Addo, Paulo Wanchope and Gilberto […]

todayMay 11, 2026 31 2

Sport Yarns

Chelsea Crew, Victor Moses Pay Curtesy visit to Oba Elegushi Palace for Lagos

By : Jolayemi Olajide Chelsea F.C. wow dia football fans for Lagos send a delegation do surprise visit Lagos on Sunday, and na Oba Saheed Ademola Elegushi for im palace. Say na Former Super Eagles star Victor Moses follow di delegation. According to Oba Elegushi, di visit make sense cause e go hellep connect football, culture and international friendship. Dis meeting show say Chelsea still get strong link with Nigeria fans and football community.

todayMay 11, 2026 28 2

obodo oyinbo

Macron Insist Say Make Colonial Masters Return Africa Stolen Artefacts

By: Esther Ayoola French Presido, Emmanuel Macron don declare say di plan to return African artworks wey dem bin thief during colonial time don become something wey nobody fit stop again. Macron yarn dis one for economic summit for Nairobi, and e remind people say e don promise since 2017 to help return di stolen works back to Africa. According to reports, France parliament just pass law wey go make am easier for dem to return plenty cultural artefacts wey […]

todayMay 11, 2026 29 2

Lagos

Lagos NMA Leadership Enter Gear 5, Suspending Dia Chairmo Saheed

By: Esther Ayoola Say like dis, na serious Leadership gbege dey inside Nigerian Medical Association, Lagos chapter, dat different groups dey claim leadership position. Dis one sef start on Monday few days afta national leadership konfam, Dr. Babajide Saheed as chairmo of di Lagos branch. One faction for di Lagos chapter later announce say dem don remove Saheed from office over alleged violation of di association constitution. According to di group, dem make dis decision during Emergency General Meeting wey […]

todayMay 11, 2026 24

OBODO NAIJA

WAEC bring new mean to stop student from using sukili during exams

By: Jolayemi Olajide WAEC don announce new way, wey dem wan take fight exam malpractice and make examination process faster and more transparent for candidates across obodo Naija. Di exam body don launch one ā€œexamination malpractice quarterā€ for im website, where candidates wey get issues related to misconduct fit check dia status directly without delay. Head of WAEC Nigeria National Office, Dr Amos Dangut, naim announce di update on Monday during briefing on dia ongoing 2026 Computer-Based WASSCE. Say moving […]

todayMay 11, 2026 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds