Blog masonry

Background

National

President Tinubu Do Small Cabinet Change, Edun To Pass Baton Oyedele

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve small cabinet reshuffle wey affect two ministers for Federal Executive Council. Minister of Finance, Wale Edun, go hand over to Taiwo Oyedele wey go become new Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy. Also, Minister of Housing and Urban Development, Ahmed Musa Dangiwa, go hand over to Muttaqha Rabe Darma wey don dey nominated as minister designate. According to memo wey SGF George Akume sign, dis changes […]

todayApril 22, 2026 22

National

VP Shettima Tuk Why Mehn Need Explain President Tinubu Policies

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don go tell Naija tuk, tuk pipo say make dem dey rep dis kontri wella, break down gornment policies, so dat mama Nkechi and baba Bayo go understand for market. Di vice presido yarn dis one for Kaduna during NIPR Week 2026, where dem gather Tuk, tuk pipo from different places, celebrate dem. According to Shettima, Baba Seyi reforms nor go make complete sense, if no bodi explain to di Citizens understanding.

todayApril 22, 2026 25

National

President Tinubu Declare Say No Shakement For Naija Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don make am clear say, e nor get how as e go be, say democracy for Naija go stand  fit,  no mata di intimidation. Im yarn dis one when im receive big delegation from Enugu State, wey Peter Mbah carry come State House. Tinubu praise Mbah for di work wey im dey do to fight insecurity and improve health, education, and infrastructure for Enugu state.

todayApril 22, 2026 21

National

Why Adeleke Make Afro Star Davido Head of Im Re-Election Campaign for Youths

By: Esther Ayoola Afro beat star, Davido don take new role as head of youth mobilisation for Accord Party campaign council for Osun State. Say na im uncle, Governor Ademola Adeleke, na im appoint am as dem prepare for di August 2026 governorship election. Davido share di news for im X page, unto how dem wan take run a smooth campaign and secure victory. According to reports, say na based on di singer influence na why im uncle choose am […]

todayApril 22, 2026 26

Lagos

Truck Kpai Anoda Dispatch Rider For Otedola Bridge, Lagos

By: Esther Ayoola Say Anoda dispatch rider don lose im life again for road askident for Lagos State, less than 24 hours afta similar one hapun for Alapere area. According to di tuk, tuk of Lagos State Traffic Management Authority, Adebayo Taofiq, statement on Tuesday, di crash hapun for Otedola Bridge inward Secretariat for Ogudu Toll Gate Road, as heavy-duty Volvo truck jam di rider. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk say di rider kpai on di  spot because […]

todayApril 22, 2026 20

Lagos

Police Waka Lagos To Rascal One Chance Kidnappers

By: Esther Ayoola Di Lagos State Police command don carry work for head dey do on di spot check to rascal all di rascalities for inside di obodo Lagos. Say dis waka na, Oga commissioner, Fatai Tijani naim lead di waka by imself on Tuesday for di city. According to di Commissioner, di Tuesday waka sef na based on complains from Lagosians about one chance motors, and how dem take dey kidnap pipo for lagos, make am waka di waka.

todayApril 22, 2026 28

Lagos

Lagos First Lady Group Dash 11 Orphanages N60m Support

By: Esther Ayoola Say nor bi small betament hapun for Lagos oh, dat not fewer than 11 orphanage homes for Lagos receive household items and welfare support worth about N60 million from Committee of Wives of Lagos State Officials. Dis donation, wey First Lady Dr. Ibijoke Sanwo-Olu lead, hapun for Banquet Hall of First Lady Office for Alausa, Ikeja. Gornment tuk say di support include cash cheque for school mata and medical care for children for di orphanages. Sanwo-Olu say […]

todayApril 22, 2026 17

National

Yul Edochie Dismiss Peter Obi 2027 Ambition

By: Esther Ayoola Nollywood actor and politician, Yul Edochie, don scarra mouth say Peter Obi nor go fit become President of Naija for dis present time. Edochie yarn dis one for im X page on Tuesday, where e tuk say Obi political strength no strong reach. E sti go ahead press tuk say wetin Obi dey do with African Democratic Congress no go work, say na “dead on arrival” and waste of time.

todayApril 21, 2026 37

Sports

Super Falcons Climb FIFA Ranking, Sti Reigning As Africa Number One

By: Esther Ayoola Naija Super Falcons don climb one step go 36th position for latest FIFA Women ranking, and dem sti be number one for Africa. Dis new ranking wey dem release on Tuesday show small improvement from where dem dey before for December 2025. Di update come afta two friendly matches wey dem play against Cameroon, where dem first lose 1–0 for February before dem bounce back win 3–1 for March 2026.

todayApril 21, 2026 34

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds