Blog masonry

Background

Lagos

Jandor Tuk Why Lagos Governorship Race Dey Open, Say Hamzat Never Declare

By: Esther Ayoola Lagos 2023 governorship candidate of di pipos democratic party, Abdulazeez Adediran, AKA Jandor, don go pour cold water for Lagos Politics say Deputy Govo, Obafemi Hamzat, never declare say e wan contest 2027 governorship election. Jandor yarn dis one for TV sitdon tuk on monday E say Hamzat get plenty experience as deputy governor, but for now, no clear sign say e don enter race. According to Jandor, Baba Seyi never endorse anybody to carry APC flag […]

todayApril 21, 2026 27

Lagos

INTERPOL Catch Runaway Lagos Bizman Over Alleged Double Kpaing

By: Esther Ayoola Police for Lagos don do ogbonge waka gbab one businessman, Hammed Tajudeen Akanbi, wey dem accuse of kpaing Prince Ademola Akinloye and Sheriff Ishola Salami for separate attacks. AIG Olohundare Moshood Jimoh naim yarn dis one for press briefing on Monday for Zone 2 headquarters, Onikan. According to di AIG, na INTERPOL track and arrest Akanbi on April 15 for one hotel for Cotonou, Benin Republic, afta e run comot since police declare am wanted on February […]

todayApril 21, 2026 16

Lagos

How Speeding Tanker Jam And Kpai Dispatch Rider For Alapere

By: Esther Ayoola Say one serious road askident wey hapun for Motorways Inward Estate area for Alapere, Lagos State, don kpai one dispatch rider. According to Lagos State Traffic Management oga, Adebayo Taofiq, di askident involve empty NIPCO Tanker and di rider. Taofiq say di tanker driver bin dey speed when e jam di moving dispatch rider, and di rider kpai on di spot. LASTMA officials quickly rush go di scene to control di wahala as other dispatch riders vex […]

todayApril 21, 2026 27

National

PDP South-West Hail Seyi Makinde, Say Im Na Strong Man For Naija Democracy

By: Esther Ayoola Di Pipos Democratic Party South-West leaders don praise Seyi Makinde, say im na senior man behind Naija multi-party democracy. Dem yarn dis one on Monday for press conference wey dem hold for Ibadan. Party’s Zonal Publicity Secretary, Chief Sanya Atofarati, naim carry im mouth take explain dis mata for di press conference Im say, Oga Makinde don show true character through im policies and actions, and dat na man im be for democracy.

todayApril 21, 2026 25

National

APC Release 2027 Election timetable, Presidential Ticket For ₦100m, and Govo ₦50m

By: Esther Ayoola Say like dis All progressives Congrees APC don release dia timetable and schedule of activities for di 2027 general elections. Dis na according to statement wey di party National Publicity Secretary, Felix Morka tuk  wey im joinbodi sign with National Organising Secretary, Sulaiman Argungu on Monday for Abuja. Part of di schedule na how dem go run screening, appeal process and party primary elections for different positions, to show how candidates go emerge. Di statement also tuk […]

todayApril 21, 2026 31

National

Wike Declare Say PDP Door Sti Open For Returnee

By: Esther Ayoola Minister of FCT, Nyesom Wike, on Monday for PDP 108th National Executive Committee (NEC) meeting, say door sti open for dia pipo wey run comot di Pipos Democratic Party to return. Wike give di message as e dey address party leaders and members, and e advise di Abdulrahman Mohammed-led National Working Committee to continue reconciliation work. Im say na through forgiveness, dialogue, and unity, PDP fit rebuild trust and become stronger as political party.

todayApril 21, 2026 25

National

Oluyede Tell Troops Not To Relax For Naija Bandits

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, don tell troops of Operation Fansan Yamma make dem continue serious fight against bandits and criminals for North-West. Im yarn dis one when he visit dia headquarters for Gusau inside Zamfara State, where e check how ready di soldiers be and discuss security wahala for di area. According to Oluyede, say Naija must be saved by all means, no excuse.

todayApril 21, 2026 23

obodo oyinbo

Trump Insist Say No End To Di Blockade Of Strait Of Hormuz Unless Iran Agree Peace Deal

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don tuk say dem nor go lift di blockade wey dem put for Iran ports until dem reach agreement with Tehran. Di US presido Tuk for im Truth social say di blockade don dey affect Iran badly and say US dey win di for now. Say like dis, di temporary ceasefire between US and Iran go end on Wednesday, but nobody sure if new peace tuk go sti hapun for Pakistan or not. […]

todayApril 21, 2026 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds