Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Israeli Break Ceasefire Kpai 11 People For Gaza

Israeli military attack for Gaza Strip don kpai at least 11 Palestinians for different parts of di area. According to reports from medics and authorities on wednesady, among di dead na two children, one 3-year-old and one 14-year-old, wey come from di northern side of di conflict zone. For Gaza City, dem sti carry problem go strike police vehicle kpai about four pipo, including one police officer, and wunjure at least nine bystanders. According to Officials,  say all dis attacks […]

todayApril 15, 2026 26

National

Vice Presido Shettima Go Greet Governor Nasir Idris For Di Death Of Kebbi Speaker

Vice President Kashim Shettima, on behalf of President Bola Ahmed Tinubu, don go promise families of security officers wey dem kpai for Shanga area of Kebbi State say gornment go stand by dem. Im say di courage and sacrifice of di soldiers and police no go be in vain at all. For condolence visit wey he carry go meet Governor Nasir Idris for Birnin Kebbi, he sti mourn di death of Speaker Muhammad Usman Zuru wey die for Cairo.

todayApril 15, 2026 29

National

President Tinubu Launch New NRS Headquarters For Abuja

Wi oga presido Bola Ahmed Tinubu say, like dis NRS don enter new phase of beta money management, stronger institutions, and economic progress. Baba seyi dey yarn dis one as im go commission new Naija Revenue Service headquarters for Abuja. E say di reforms wey im gornment dey do, dey show beta workings, and dat di country dey move from uncertainty enter “better hope” gradually. Tinubu sti add say di new NRS building no be just structure, but symbol of […]

todayApril 15, 2026 22

Lagos

Lagos Gorment Carry Man Go Court Over Alleged Forceful Land Takeover of Church

Lagos State Gornment don carry one man, Olusola Shedrach, go High Court for Ikeja on Tuesday over allegation say e forcefully take over and damage land wey belong to Harvesters Church for Gbagada–Oworonshoki, Expressway area. Dem bring am come front of Justice Hakeem Oshodi on three-count charge wey include forceful takeover, wilful damage, and breach of peace. State prosecutor, Olufunmilayo Aluko, tell di court say dem ready for arraignment and telling di defendant to con start im plea. As e […]

todayApril 15, 2026 60

Lagos

How Lagos Govo Dey Ginger Mehn To Give Youths, Leadership Position

By: Esther Ayoola Oga Govo of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu don declare say make leaders dey try carry youths along, as e dey important for national development. E tuk dis one for Abuja Dialogue 2026 wey dem hold for State House Banquet Hall, Abuja. Di programme na di Office of Vice President and Lateef Jakande Leadership Academy organise am, with theme wey tuk say youth leadership na important structure for development. Sanwo-Olu sti add say di question nor be whether […]

todayApril 15, 2026 25

Sports

Chelle Call New Faces As Super Eagles Set For Unity Cup

Super Eagles coach Eric Chelle don open door for NPFL players and Nigerian players wey never play international before to join di team ahead of Unity Cup for London. Di tournament go hapun from May 26 to May 30 for The Valley stadium wey be Charlton Athletic home ground, and Nigeria go defend di title wey dem win last year against India, Jamaica and Zimbabwe. Chelle tuk say e wan use di competition try new players and give dem chance […]

todayApril 15, 2026 23

Sports

Lookman Fire Goal As Atletico Knock Barcelona Out Of Champions League

Say na Super Eagles star boy, Ademola Lookman  31st minute goal na help Atletico Madrid beat Barcelona for Champions League match, helleping dem move to di  semi-final. Atletico bin carry 2-0 advantage from first leg, but Barcelona come level am for early 25 minutes through Lamine Yamal and Ferran Torres goals for di return leg. After dat one, Atletico no panic, dem still hold body well under coach Diego Simeone and continue dey press. Later, fine team play land for […]

todayApril 15, 2026 36

Sports

Arsenal Title Hope Dey Fade – Mikel Obi

Former Chelsea midfielder John Obi Mikel say like dis Arsenal don dey run out of ideas for Premier League title race after dem lose 2-1 to Bournemouth for Emirates. Di result make dem still get 6 points lead, but Manchester City don close gap with a strong 3-0 win over Chelsea. City fit even level Arsenal if dem win dia outstanding match and also beat Arsenal for dia next league clash. Mikel advise Arteta say make e try motivate di […]

todayApril 15, 2026 18

obodo oyinbo

Wadagni Win Benin Republic Presidential Election Land Slide  

Provisional results wey come from  Benin Republic presidential election, say  Finance minister Romuald Wadagni don win di election with about 94 percent of votes, According to report, di electoral ogas never give final official result, but Wadagni don already take clear lead. Im opponent Paul Hounkpe don already accept defeat and congratulate am even before dem finish counting all di votes. Wadagni wey be 49 years old get strong support from outgoing president Patrice Talon, and many people believe say […]

todayApril 14, 2026 34

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds