Blog masonry

Background

Business

Speaker Obasa Explain Why Lagos Be Naija Number One Business Centre

By Ebi Oboko Speaker of Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa,  don drop yarns, say Lagos go continue to push Nigeria economy forward, even though Abuja naim be di Federal Capital Territory. E yarn dis one when e receive new leaders of Lagos Chamber of Commerce and Industry wey Leye Kupoluyi lead come pay am courtesy visit for Assembly. Obasa explain how  Lagos still tey  be di best place for pipo wey wan invest for Nigeria, because of beta […]

todayApril 17, 2026 26

Sports

Bayern Run Comeback Beat Real Madrid 4–3 For Crazy Champions League Night

Say nor be small drama on Wednesday night for Allianz Arena for Germany,  wia Bayern Munich beat Real Madrid 4–3 to qualify 6–4 on aggregate for Champions League semi-final against PSG. Madrid start di match  very fast, as Arda Guler score just under one minute and later add another goal from free-kick, while Kylian Mbappe also score to give them strong fight. Bayern answer back through Harry Kane and other team efforts to level di tie and keep pressure on […]

todayApril 16, 2026 40

obodo oyinbo

Iran Military Make Move To Block Red Sea, Gulf Trade After U.S Naval Blockade 

Iran military don sama warning say dem go block trade for Red Sea, Gulf, and Sea of Oman if US naval blockade on Iranian ports continue. Military commander Ali Abdollahi and Iran central command na im tuk dis one for State broadcast. According to di senior men, US dey create cause problem  for Iran ships and oil tanker movement, and dis sef violate dia ceasefire agreement. Military commander Ali make clear dat dem ma ready to protect dia national interest […]

todayApril 16, 2026 33

OBODO NAIJA

Nigerian Army Bury Fallen General, Soldiers For Borno

For Nigerian Army side, dem don bury Brigadier General Oseni Braimah, Captain Ismail and oda soldiers wey die for recent attack for Borno State. Dem do di burial for Maimalari Cantonment Cemetery for Maiduguri with full military honour. Na on April 9, fighters wey dem suspect say na Boko Haram and Islamic State West Africa Province attack soldiers for Benisheikh along Maiduguri-Damaturu road, kill di officers and men. Big people like Babagana Zulum and Christopher Musa show face for di […]

todayApril 16, 2026 50

Politics

2027 Presidential Election Go Be My Last To Contest – Atiku Abubakar

Former Vice President, Atiku Abubakar don agree finally say na 2027 presidential election go be im last attempt to become Nigeria president. E yarn dis one on Wednesday night during interview for TV sit don tuk, when dem ask am about im age and di coming election. Atiku explain say by dat time e go dey close to 80 years, so di stakes high and e no sure say e go run again after dat.

todayApril 16, 2026 38

Lagos

Lagos Police Grab 3 Suspected Armed Robbers, Recover Pistol

Lagos Police command  don robo cup style arrest three suspected armed robbers wey dey  involve for robbery wey hapun for one estate for Sangotedo on April 11 and 13, 2026. Police Tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, put dis for statement on Wednesday night give tori pipo According to di statement, Dem arrest dem after distress call, and police recover local pistol wey get six rounds of 9mm bullet, face mask, hammer, rope, tape, jackets and plier. Say Area boys even […]

todayApril 16, 2026 24

Lagos

Lagos Gorment Giv Obalende Park To Developer To Make Am Fine

Lagos State Gornment don officially hand over Obalende Park give redevelopers to build di place. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, after im run di mata on Wednesday  say di project dey very important for di state development. According to Wahab, dis kind move go help improve how Lagos look and how people go take use public spaces.

todayApril 16, 2026 29

obodo oyinbo

U.N Oga Guterres Beg US, Iran To Hold Serious Tuks

UN Secretary-General António Guterres like dis dey  call for serious tuk between United States and Iran, say make dem follow international law. E talk dis one to journalists for UN headquarters for New York on Tuesday. Guterres say humanitarian and legal responsibilities dey ignored for di Middle East mata and other places, and dis dey cause serious chaos, suffering and destruction.

todayApril 15, 2026 22 2

National

Akpabio Say Terror Attacks Na Plan To Shake Tinubu Government

Senate Presido Godswill Akpabio don finally tuk wetin do Naija, say all di recent terrorist attacks wey dey hapun for di obodo naija na plan by some people to distract President Tinubu. Im yarn dis one for Abuja during di opening of Naija Revenue Service headquarters. Akpabio even tuk say afta Tinubu win 2027 election, di bomb blasts go stop, say na pipo dey sponsor am.

todayApril 15, 2026 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds