Blog masonry

Background

Lagos

LASG Dey Talk Say Grassroot Engagement Na Key For Better Governance

Di Lagos State Government (LASG) don confirm say e still dey fully committed to better and inclusive governance through steady grassroot engagement and teamwork with local stakeholders. Dis assurance land during one Stakeholders’ Engagement Meeting wey bring together local government and LCDA chairmen, community leaders, and other stakeholders for di state. Di one-day event, wey carry di theme “Empowering Voices and Shaping Policies,” happen for Adeyemi-Bero Auditorium, Alausa, Ikeja. For him keynote speech, Dr. Afolabi Tajudeen, wey be di Special […]

todayNovember 11, 2025 15

Sports

Atalanta Don Sack Juric After Lookman Wahala, Bad Form

About one week after di touchline wahala between Nigerian baller Ademola Lookman and coach Ivan Juric, Atalanta don sack di coach as di club dey suffer poor form. Di Italian side announce say dem don part ways with Juric on Monday. Di coach wey take over from Gian Piero Gasperini during summer leave Atalanta for 13th position for Serie A table, with only two wins from 11 matches. Coincidentally, Juric bin lose him Roma job on November 10, 2024, before […]

todayNovember 11, 2025 18

Lagos

Lagos Govment Give QMB Mart 72 Hours Ultimatum Over Illegal Structures”

Di Lagos State Building Control Agency (LASBCA) don give QMB Mart 72 hours ultimatum make dem pull down all di illegal structures wey dem build for coastal road and under power line. Dis one na part of di government wahala against people wey dey build without approval. According to di Special Adviser to di Governor on E-GIS and Urban Development, Dr. Olajide Babatunde Abiodun, di land wey QMB Mart dey occupy na originally for car park, but dem turn am […]

todayNovember 10, 2025 27

Lagos

27th NUGA Games: Gov Mutfwang Assure Tight Security, UNILAG Ready To Shine

Di University of Lagos (UNILAG) contingent don land for Jos, Plateau State, with high hope and strong determination to make serious impact for di 27th Nigerian University Games (NUGA) wey start on Thursday, November 6 and go end on Sunday, November 16, 2025. As di proud host of di 26th edition for 2022, UNILAG carry 90-member team wey get athletes, coaches and officials, all ready to showcase excellence, discipline and sportsmanship. Dem go compete for ten sporting events, Athletics, Badminton, […]

todayNovember 10, 2025 20

Sports

Falconets Floor Benin Republic, Secure Second Win For WAFU B Cup

Nigeria Falconets don defeat Benin Republic 3-0 for dia second game for WAFU B U20 Girls’ Cup on Sunday. Moses Aduku side start scoring through Kareem Ramotalahi after 15 minutes. Kareem double Nigeria lead for di 58th minute as e dribble pass defender before e put ball for net. Precious Oscar score Nigeria third one deep for stoppage time. Di Falconets don beat Ghana 3-1 for dia first game on Saturday. Dem dey top di table with six points as […]

todayNovember 10, 2025 24

National

Teenager Don Go Kill Im Cousin For Ritual For Edo

Police for Edo State don start investigation after 12-year-old boy wey dem identify as Emiliano Egwunbare don get kidnapped and killed by him 18-year-old cousin Tega Emajuwa. According to reports, Emajuwa and im two friends kidnap Emiliano for Obagie Community, Egor local government area of Edo state on September 16, 2025. Di boy don dey stay with Emiliano parents for few months before di wicked act. Source talk say Emajuwa collect ransom from Emiliano parents but no release am. Police […]

todayNovember 10, 2025 13

Lagos

Boat Passengers Drag Lagos Over €410m Omi Eko Project

Boat passengers under di United Waterways Passengers Association don raise wahala over di €410m Omi Eko Project, talk say di passenger capacity fit cause gbege for operation. Dem explain say any boat wey carry more than 30 passengers fit delay as operators go dey wait make di boat full before dem fit waka. Dis one come weeks after di Lagos State Government, with foreign partners, launch di €410m project. Governor Babajide Sanwo-Olu talk say di Omi Eko Project go turn […]

todayNovember 10, 2025 11

Entertainment

Uche Montana Fire Back Over Ned Say She Dey Fuel Regina Daniels’ Drug Use

Uche Montana don fire back after Ned Nwoko name her as one of di people wey dey allegedly sponsor Regina Daniels’ drug wahala. Ned Nwoko talk say im try keep im wife, Regina, away from her siblings and also from Uche Montana and another person wey dem name Sonia, but dem dey always find way reach her. Reacting, Uche deny di allegation. She write for Instagram say, “I wasn't going to say anything, but I feel it's important to clear […]

todayNovember 10, 2025 126

Entertainment

Regina No Be 17 When Ned Marry Her, E Dey 19 – Mercy Johnson Okojie

Ossai Ovie Success, wey dey serve as aide to Delta State governor, don call out actress Mercy Johnson Okojie over claim wey say Regina Daniels dey 17 years when she marry lawmaker Ned Nwoko. Mercy post for her Instagram page say Regina na only 17, small pikin, when she tie knot with Ned. Reacting to di post, Ovie post for Facebook say contrary to di claim, Regina dey 19 years when Ned marry her. Im write say, “Mercy Johnson should […]

todayNovember 10, 2025 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app